'I no regret di decision of not using hospital wen my wife get belle'

Wetin we call dis Video, I no regret di decision of not using hospital
'I no regret di decision of not using hospital wen my wife get belle'
    • Author, Fiona Equere
    • Role, Producer
    • Reporting from, Lagos

Akinbobola Folajimi say im no regret im decision not to use hospital to deliver im third child.

Folajimi wife, Oluwakemi die two months ago from childbirth complications.

Di couple no register for any hospital, dem bin dey use one local midwife wey dey dia area throughout Oluwakemi pregnancy.

Her husband say di reason why dem no register for hospital na becos hospital far from wia dem dey live, and dem don use midwife bifor without issues.

Wen Oluwakemi labour start na di midwife bin dey handle her until complications start.

Sadly Oluwakemi and her baby die. Her death cause tok-tok online sake of how e happun.

Di incident happun for Lagos Nigeria.

Afta her tori go viral, authorities announce say dem dey investigate di mata.

Nigeria na one of di kontris wey dey face major maternal health crisis.

Di main causes include complications during pregnancy and childbirth, such as serious bleeding, sepsis, and unsafe abortion.

Filmed and edited by Idara Monday