Who be Stanley Amandi and why military pipo hold am

Foto of Stanley Amandi

Wia dis foto come from, Stanley Amandi/Facebook

Read am in 5 mins

Di Actors Guild of Nigeria (AGN) don confam di arrest of dia member, Stanley Amandi wey pipo sabi as "Stan K. for im alledged involvement in di failed coup to overthrow President Bola Tinubu govment.

Oga Amandi na di former chairman for Enugu state chapter of AGN, e dey among di civilians wey dem arrest in connection to di planned coup.

Emeka Rollas Ejezie, di former President of Actors Guild of Nigeria tok say AGN don dey tok wit di Department of State Service (DSS) to allow im lawyer and wife see am but dem don write back to dem say im no dey dia custody e dey wit Defence Intelligence Agency (DIA).

Di DIA neva tok anytin about Oga Amandi arrest.

"On di issue of Stan. K. Dem pick am for Enugu. We don dey interface wit DSS to allow am see im lawyer and wife see untill last week wen DSS write us officially say e no dey wit dem but wit Defence Intelligence Agency DIA," e tok.

Oga Rollas tok say dem don reach out to DIA make dem allow am to see im family, lawyer and medical doctor becos e dey hypertensive.

"We don also reach out to DIA make dem at least allow am make e see im wife, lawyer, and medical doctor. And e dey hypertensive."

Di former AGN president don call im colleagues make dem rise up togeda and fight for di freedom of di actor.

E neva clear but why dem arrest di actor but reports allegedly claim say dem bin hire am to act as propagandist for di coup planners.

Amandi last post on social na for 19 September 2025 on im Instagram page bifor im arrest.

For October 2025, news bin spread say dem arrest some officers wey dey plan coup against di govment of president Bola Tinubu and dem don arrest some officers.

Although di Nigeria military bin release statement say dem arrest and dismiss 16 officers in mata wey concern 'indiscipline and breach of service regulations' but dem no link am to di attempted coup.

Local media don reports di names of di pipo wey dem bin arrest some of dem na military officers and civillians, Amandi dey among di civilian wey dem arrest but e neva clear how many pipo dem don arrest in connection to di failed coup.

On Monday, di Armed Forces of Nigeria (AFN) say dem don finish dia investigation on di 16 officers wey dem arrest for October, 2025 ova di plot to overthrown di govment.

Inside one statement wey di Director of defence information, Major General Samalia Uba sign, e tok say dem don carry out investigations and submit dia findings to "superior authority in line wit extant regulations."

Though e no mention dia names, di defence tok-tok pesin say dem don identify some of di officers wey get plans to overthrown di govment and dis kain actions no dey align with di ethics, values, and professional standards wey dey required from members of di Armed Forces of Nigeria.

"Di findings don identify some of di officers wey get allegations say dem dey plot to overthrow di govment, wey dey inconsistent wit di ethics, values and professional standards required of members of AFN," di statement tok.

E tok say dem go carry di mata go military judicial panel wia dem go make sure to discipline dem "in accordance wit di Armed Forces Act and oda applicable service regulations."

"Di AFN reiterate say measures wey dem take na purely disciplinary and part of ongoing institutional mechanisms to preserve order, discipline and operational effectiveness within di ranks. Di Armed Forces go continue to uphold di highest standards of professionalism, loyalty and respect for constitutional authority," di statement tok.

Who be Stanley Amandi

Foto of Stanley Amandi

Wia dis foto come from, Stanley Amandi/Facebook

Dem born Stanley Amandi for Enugu State. Na filmmaker and producer wey don feature for many Nollywood feem afta e start im acting career as teenager.

E don feature in movies wit oda Top A listers such as Ngozi Ezeonu, late Zulu Adigwe, Patience Ozokwor and Nkem Owoh, among odas.

Amandi don serve as chairman for Enugu State chapter of Actors Guild of Nigeria (AGN).

Afta dem suspend Enugu AGN chairman, Brown Ene, for December 2022 becos of issues related to misappropriation of funds, di guild National Executive Council appoint Amandi as di only administrator for di state chapter.

Dem give am task to handle di affairs temporarily while dem wait for di investigative panel report.

As filmmaker, Amandi direct movie titles such as 'The Album', 'Nkwocha', 'Tiger King', and 'Tiger King 2.'

E also dey feature for films like 'Lionheart', 'Bachelors', 'Monica the Fighter', and 'Another Bondage', among odas.

E go Union Secondary School, Awkunanaw, for Enugu State, den later obtain degree from University of Port Harcourt (UNIPORT) for Rivers State.

Ontop im LinkedIn profile e tok say im gain admission and graduated between 1982 to 1986. Im profile show say e get qualifications Humanities MBA, MGT.

Amandi also attend Enugu State University of Science and Technology (ESUT).