Video show moment Macron wife push am for face - di president say na joke no be fight

Wetin we call dis Video,
Video show moment Macron wife push am for face - di president say na joke no be fight

One video wey capture di moment wey be like say di wife of France President Emmanuel Macron hit am for face as dem land Hanoi, Vietnam on Sunday evening don begin go viral.

For di clip, Brigitte Macron no too show, na ony her hand pipo fit see, as she push Oga Macron.

Initially, e appear like say di French President shock but e quickly compose and wave to camera.

Elysee sources wey French media quote tok say wetin dem see on camera na "moment wey di president and im wife dey joke around one last time bifor dem start di trip" and Macron tok say "just joking about as we do".