How Democrat Zohran Mamdani wey don seal New York mayoral victory take rise for politics

Read am in 3 mins

Zohran Mamdani don make history as e win di New York City mayoral race as both di first Muslim to win di race and di youngest, at di age of 34, in ova 100 years to get di mandate to lead US biggest city.

For im victory speech, e sama US President mouth say, "Donald Trump, since I know say you go dey watch now. I get four words for you: turn di volume up".

E add say "to get to any of us, go need pass through all of us".

Dis na as di Trump wey bin threaten to cut New York City federal founding if Mamadani win di election bin write from im Truth Social say "And so it begins".

Oga Mamdani supporters hail dis win historic as di results project say Mamdani bin win about half di votes ova one million votes wey make am di first candidate to do dat kain tin since 1969.

All in all, ova two million New Yorkers bin comot to cast dia votes. Dis go be double di amount of pipo wey comot to vote in di last election wey happun four years ago.

As dem don count 91% of votes, di BBC US Partner CBS News don project say Mamdani gbab 50.4% of di vote, to independent Andrew Cuomo 41.6% and Republican Curtis Silwa 7%.

But BBC North American tori pesin, Anthony Zurcher tok say bicos of di ginger of im campaign, Mamdani get more media attention pass wetin municipal election for even America bigest city dey get.

"E mean say as mayor, im successes and failures, go dey very closely followed"

From New York halal cart rapper to New York first Muslim Mayor

Dem born Zohran Kwame Mamdani for Kampala, Uganda bifor im family carry am go New York wen e be seven years old.

For New York, e go di Brnx High School of Science and later get degree for Africana Studies from Bowdoin College wia e follow start di campus chapter of Student for Justice for Palestine.

Im mama na big time name for India, as she be Indian-American feemaker, Mira Nair. Even sef for di first days of im campaign, India bin describe Mamdani as Mira Nair pikin but now levels don change and dem dey call Miira Naira, Mamdani mama as e win di NYC Mayoral race.

Di 34 year old, state assemblyman na self-identified democratic socialist. E dey promise affordable housing, free public buses, rent freezes and universal childcare for pikin dem wey dey under di age of five years old.

E also marry im wife Rama Duwaji wey be 28 year old artist and animator earlier dis year, even as e reveal say im and her meet for di dating app, Hinge for interview in June.

E bin tell di BBC New York City say na "city wia one in four pipo for am dey live in poverty, city wia 500,000 pikin dey sleep wit hunger. And las-las na city wey dey in danger of loosing wetin make am so special."

Mamdani bin dey very known like dat bifor im win di Democratic primary wit social media focused campaign.

Some of di high points of im capaign wey hit wit voters na di debate wey e hala independent candidate Andrew Cuomo say "wetin I lack for experience, I make up for am wit intergrity, and wetin you lack for integrity, you no fit make up for am wit experience".