You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ekitike, Isak, Mbuemo, Gyokeres - Who don go and who remain as race to sign striker dey hot
- Author, Andy Cryer
- Role, BBC Sport senior journalist
- Read am in 5 mins
Na just one month remain for Premier League to start, and di race to sign new strikers dey hot now.
Chelsea start quick, dem sign both Liam Delap from Ipswich and Joao Pedro from Brighton, but di likes of Newcastle, Liverpool, Manchester United and Arsenal still dey wait to land dia man.
Several clubs dey linked to different players and some dey make move for di same target, as e be now, e dey easy to lose track of who dey move wia and wen.
BBC Sport torchlight di search for frontman.
Strikers wey almost don comot for market
Viktor Gyokeres (Sporting)
Di Sporting striker dey linked wit a number of clubs dis summer but di 27-year-old former Coventry player go soon comot from market.
Arsenal dey expected to seal a £63.5m deal for Sweden forward afta im 97 goals in 102 appearances for Portugal.
Di Gunners don dey market for a while but, now wey Gyokeres dey set to join dem, dem go soon comot for striker market.
Victor Osimhen (Napoli)
Arsenal, Manchester United and Chelsea dey among di club wey bin dey heavily linked wit di Nigeria striker, but e be like say im go soon sort out im future .
Im parent club Napoli dey tok wit Turkish side Galatasaray, wia im bin spend last season on loan, and tori be say di forward wan return to Turkey.
Failure to reach financial agreement fit quickly alert oda suitors, in di next few days im situation go dey clear.
For 2022-23 di 26-year-old bin help Napoli win dia first Italian title since 1990. Im bin miss out as dem repeat di feat dis season but im bin dey on fine form on loan to Galatasaray.
Wanted men
Alexander Isak (Newcastle United)
Newcastle's message na say dem no dey sell Isak but you get di feeling say dis no be di last we go hear about im future.
Liverpool dey interested in di 25-year-old Sweden forward but dem know say dem go need to break di British transfer record to even stand a chance to get am from di Magpies.
BBC Sport understand say a deal for Isak fit cost up to £130m and, now wey Liverpool dey close to a move for Hugo Ekitike, any deal dey look more unlikely.
Hugo Ekitike (Eintracht Frankfurt)
Liverpool dey advanced talks to sign Ekitike and dem dey hope to complete a deal by dis weekend.
Newcastle bin also show dia interest for di 23-year-old Frenchman - and im club don turn down one £70m bid.
Chelsea na anoda club wey bin dey seriously interested in Ekitike but, as dem recently sign Delap and Joao Pedro, e dey unlikely say dem go move for anoda frontman, unless players comot.
Ekitike bin enjoy di best goalscoring season of im career, e score 15 goals and add eight assists for Frankfurt to help dem finish third for di Bundesliga and qualify for a Champions League place.
Bryan Mbeumo (Brentford)
Manchester United move for di Brentford forward don quiet small in recent weeks.
But di pipo for Old Trafford dey hope say dem go fit complete Mbeumo move for more dan £60m bifor Ruben Amorim and im squad set off for dia pre-season travels by dis weekend.
Tottenham bin also dey interested for di 25-year-old Cameroon international but dem neva make any bid, meanwhile, several Champions League clubs for di continent dey watch im situation closely.
Yoane Wissa (Brentford)
Tottenham dey also explore a move for anoda Brentford forward.
BBC Sport understand say di Bees dey aware of dia London rivals' interest for di 28-year-old, for deal wey fit reunite di forward wit im former manager Thomas Frank, wey now dey in charge of Spurs.
Wissa, wey bin score 20 goals last season, dey attract major interest from Premier League clubs in recent months, Nottingham Forest fail to sign di DR Congo international for January.
Liverpool na anoda club wey dey monitor Wissa situation, but dem get oda preferred targets to explore first, while Newcastle also bin get interest and dem fit move on to am, if Ekitike join Liverpool.
Ones to watch
Benjamin Sesko (RB Leipzig)
Di Slovenian 22-year-old bin dey look like say im bin dey go Arsenal dis summer, but now wey Gyokeres na di Gunners priority, dat move don comot for table.
Im bin also dey linked wit di likes of Chelsea, Manchester United and Liverpool.
If dem sign Mbeumo, Manchester United go need to sell to fund a potential move for a striker.
Sesko sign a five-year contract dis time last season, tori be say Leipzig go want up to £85m for am. No rule out a move from one of Europe top clubs later for di window.
Ollie Watkins (Aston Villa)
Arsenal bin make a late bid for England striker Ollie Watkins for di final few days of di winter transfer window, and Aston Villa refuse di reported £40m offer.
Na striker wey a number of clubs dey keep an eye on, wit both Liverpool and Manchester United dey admirer di player.
Villa no dey ginger to sell di 29-year-old, but di question now na if a late substantial bid fit twist dia arm?
Jean-Philippe Mateta (Crystal Palace)
Anoda striker wey dey linked wit a move away dis summer, but Crystal Palace dey determined to keep am.
Plenty clubs don show interest for di Frenchman but di Eagles dey hope say im go sign a new long-term deal, im current contract go expire for 2027.
Di 28-year-old na standout performer for Oliver Glasner side last season, e score 17 goals in all competitions as Palace win di FA Cup - dia first major trophy.
Nicolas Jackson (Chelsea)
Jackson na Chelsea first-choice striker last season but di arrival of Joao Pedro and Delap don raise a few questions.
Di 24-year-old Senegal international score 10 Premier League goals for 2024-25 and go likely get significant interest from elsewhere if im dey available.
Dominic Calvert-Lewin (Everton)
Na free agent afta im Everton deal bin expire dis summer.
Newcastle and Manchester United dey linked wit di 28-year-old England forward.