You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin be di court order to police on di enforcement of di tinted glass permit?
One Federal High Court for Warri, Delta State don decline request by one Nigerian to stop enforcement on tinted permit by police.
Justice Hyeladzira Nganjiwa say make evri body maintain status quo on di matter wey John Aikpokpo-Martins file for court.
Aikpokpo-Martins bin apply for some orders from court to stop di police make dem no enforce di order on tinted glass permit on car owners for Nigeria.
"An order of interim injunction restraining the inspector-general of police and Nigeria police force and dia agents from implementing and enforcement of di tinted glass permit pending di determination of di suit," one of di reliefs tok.
But afta hearing from Kunle Edun, wey be lawyer to di applicant, Justice Nganjiwa decline di application but say make di applicants dem go serve police.
E adjourn di matter to 16 October for hearing.
Oga Aikpokpo-Martins carry di mata go court to challenge weda di new tinted permit enforcement dey legal.
Dis dey come even as tori dey come say dem don start to dey check pipo for dia tinted glass permit for states like Niger state from Friday.
Di Delta Police force reveal say dem don seize 25 cars on top di new order.
Wetin Police tok about di tinted glass permit law
According to di Police tok-tok pesin, Benjamin Hundeyin di mata of permit to get tinted glasses for motor, no be dem bring am.
E tell BBC News Pidgin say, "No be we make di law. Di law don dey say anybodi wey go tint im glass for im motor musto get permit.
"Di law dey, so we gatz enforce dat law to make sure say anybodi wey cover im glass, we we no fit see inside im motor, at least we go get im details."
Di Nigerian Police bin give motorists till October 2 to go get permission for dia tinted glass for dia motor.
Oga Hundeyin add say, "Bicos if we no do am like dat, many pipo go dey use all dis tinted glass motor take commit crime. Dem fit use am kidnap pesin we no go know, who be who."
Tinted permit na sometin motorist gatz dey do evri year and to get di permit go cost 14 thousand naira.
So wetin bring di mata of tinted glass permit?
According to Section 3 of the Motor Vehicles (Prohibition of Tinted Glass) Act, na di duty of di buyer or importer of di motor wit di tinted, shaded, coloured, darkened or treated glass to change am withing 14 days afta dem bring di car come Nigeria or dem buy di motor.
Section one of di same law tok say, except wit permission from di IGP, pesin no suppose get glass for dia motor wey dey tinted, shaded, coloured, darkened or treated in di way wey go make pipo or di objects wey dey inside motor to no dey visible.
Dis decree don dey ground since 1991.
Na for April, Police bin first announce say dem go start to dey give tinted glass permits nationwide wit dia Police Specialised Services Automation Project afta dem bin match break on top di mata for 2022.
Dem bin give pipo till August to get dia papers togeda pifor dem come increase di time to October 2nd,