Wetin we know about di 'explosion' wey rock APC rally for Rivers

Wia dis foto come from, Allwell Ene
Report say one woman dey critically injured after one ''explosion'' rock di All Progressives Congress APC governorship campaign for Ojukwu field, Rumuwoji commujuty for di Mile One area of Port Harcourt City for Rivers State, Southern Nigeria.
Di incident happun around 1pm on Thursday.
APC tok tok pesin for Rivers State, Darlington Nwauju tell BBC Pidgin say di incident happen around 1pm in di afternoon and five oda pesins also get injury from di explosion.
Nwauju add say di 'explosion' happen before di Rivers APC governorship candidate, Tonye Cole, reach di venue becos im bin still dey do house-to house campaign for di area wey go lead am into di main venue. Im never reach di venue before di explosion happen.
But, police say wetin happun no be explosion but gbasgbos between some people for di venue.
Eye witnesses tell BBC Pidgin say na di loud sound wey dem hear make dem run comot di rally ground.
'No explosion happun' - police
Police authorities say di gbege wey happen for Rumuwoji community Townhall, venue of di APC governorship rally na sake of internal crisis wey dey di Rumuwoji community between two factions, not becos of politics.
For statement wey di Police tok tok pesin SP Grace Iringe-Koko sign, she explain say di APC bin ''pay N200,000 to rent di playground/community to di Community Development Chairman (CDC) of Rumuwoji but di CDC Chairman share di money to only di Chiefs and members of im faction.''
End of Di one wey oda users dey read well well
''Di oda faction wey no benefit from di sharing insist say dem (APC) no go use di Hall except dem receive dia own share of di money wey make gbege burst out.
SP Iringe-Koko say di gbege wey happen na between di two internal factions of
Rumuwoji community, not between APC and any oda political party and add say only two pesins naim get injury.
She add say di Deputy Commissioner Operations, Area Commander Port Harcourt, OC SIB and DPO Mile One Police station Diobu bin dey ground to restore peace and security for di venue and so di APC governorship rally continue and end peacefully.
Di statement come emphasise say no explosion happen before or during di APC rally and di Rivers State Commissioner of Police don direct di DC State CID and O/C Bomb Disposal Unit to investigate di tori say explosion happen for dat venue.












