Harry and Meghan share foto of Lilibet for her first birthday

Wia dis foto come from, MISAN HARRIMAN/DUKE AND DUCHESS OF SUSSEX
Di Duke and Duchess of Sussex don share picture of dia daughter Lilibet afta dem celebrate her first birthday.
Dem celebrate di birthday with picnic for di Frogmore Cottage for Windsor on Saturday.
Prince Harry and Meghan say dem dey touched by di wishes wey dia second pikin get.
Dia tok-tok pesin say, di Queen namesake get pass $100,000 donation wey pipo make in her name for di World Central Kitchen wey dey provide food give pipo wey kasala affect.

Wia dis foto come from, PA Media
Di Sussexes make dia first public appearance for Britain togeda since 2020, wen dem go di Thanksgiving service for di Queen as part of di Platinum Jubilee.
Last week go make am, di first time wey di Queen don carry eye look her 11th great grand pikin face to face, as dem born am for California wia di Sussexes dey live now.

Wia dis foto come from, Getty Images
Prince Harry and Meghan name Lilibet, afta di Queen as na di family nickname for am.
Her middle name na Diana afta di late Princess of Wales.
End of Di one wey oda users dey read well well
She be di eighth in line to di throne.
















