Police don arrest Afrobeat singer Seun Kuti over assault on officer

Seun Kuti in handcuff

Wia dis foto come from, Lagos police command

Police don place Nigerian Afrobeat singer, Seun Kuti under arrest over assault of one officer on Sarturday.

Kuti, 40, son of legendary activist and musician turn imsef im to di Lagos state police command on Monday morning following di Inspector General of police order for im arrest Saturday night, police toktok pesin tok for one Twitter post.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Di singer show face for police office wit im ''lawyer and family representative'', di statement tok.

One viral video over di weekend show Oga Kuti dey slap one police officer wey dey uniform along di road.

E no too clear wetin cause di wahala but Oga Kuti for one Instagram post claim say di officer bin wan ''kill me and my family''.

Na big offence to assault police officer for Nigeria and any pesin wey dem find guilty fit get three years jail sentence.

But dis trend dey happun well-well as many civilians don too get liver to assault officers in recent times.

Dis dey common as di kontri continue to deal wit cases of police brutality wey cause di 2020 EndSars protest wen plenti youths for many days carry waka enter streets all over di nation in protest against di actions of di men in uniform.

'I go give my full cooperation' - Kuti

Di controversial singer bin tok say im dey ready to collabo wit di police as dem investigate di causes wey lead to di event of di day.

For anoda Instagram post on Saturday night shortly after di order for im arrest, Oga Kuti say ''I welcome di investigate and go give my full cooperation,''

Im action draw widespread condemnation from Nigerians wit many calling for im immediate arrest over wetin dem describe as ''unacceptable and lawless''.

Who be Seun Kuti

Seun Kuti na di youngest pikin wey ogbobge musician Fela Anikulapo Kuti born for 1983.

E bin start to dey open shows for im papa at di age of eight and before im turn 12, e don formally enta im papa band, Egypt 80.

When im papa die for 1997, na im take ova as di head of di band wey im don dey run ever since.

Seun Kuti & Egypt 80 so far don gbab one Grammy Nomination for Best World Music Album from di album Black Times for 2018

Over di years, Seun Kuti don enta plenti goment net sotay dem bin almost call for di closure of African Shrine

For November 2020, tori land say goment bin threaten to close di New Afrikan Shrine sake of say im bin wan launch di Movement of di People joinbodi.

Di meeting suppose hold for di shrine tok di mata of End Sars lessons and tasks, e sha still hold.

Oda tins wey Seun Kuti don loud about for im social media na di mata of BRT class action over di BRT killer accused of killing Bimbo and di oda BRT bus wey jam train for Ikeja

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Instagram post