Biggest football club stadiums around di world

Manchester United planned new stadium

Wia dis foto come from, Manchester United

Read am in 4 mins

Manchester United don announce plans to build di biggest stadium for UK – dem say di "iconic" new £2bn 100,000-seater ground go dey close to Old Trafford.

Di new Manchester United stadium go become one of di largest stadiums for di world in terms of capacity once dem complete am.

Once dem finish di construction, dem go demolish di club current home ground.

Co-owner Sir Jim Ratcliffe say im wan build di "world greatest football stadium", wey di club hope to finish in five years.

United announcement dey come afta one serious consultation process around weda to develop di existing stadium or build a new one.

Na since 1910 wey Manchester United make Old Trafford dia home.

Di club say dem go kotinu to play for Old Trafford until di new stadium ready.

Architects for Foster and Partners, wey go design di project, say di new stadium go feature one umbrella design and a new public plaza wey dey "two times di size of Trafalgar Square".

Di design go feature three masts wey dem describe as "di trident", wey di architects say go be 200 metres high and pipo go fit see from 25 miles away.

"Today mark di start of an incredibly exciting journey to deliver wetin go be di world greatest stadium," na wetin Ratcliffe tok.

"Our current stadium don serve us well-well for di past 115 years but e don fall behind di arenas for world sport.

"I feel say we fit finish up wit di most iconic football stadium for di world."

Im say dem neva set date wen di building work for di stadium go begin, im add say: "E go depend on how quickly goment start wit di regeneration programme. I feel say dem wan start sharp - sharp."

Dem go use pre-fabrication to build di stadium, wey dem go ship 160 components along di neighbouring Manchester Ship Canal.

Wit dis update from Man Utd, dis na good time to know di five biggest football club stadiums for around di world right now.

Camp Nou, Barcelona

Camp Nou, Barcelona, na Barcelona home stadium since 1957

Wia dis foto come from, Getty Images

Camp Nou, na Barcelona home stadium since 1957, e get capacity of 99,354 wey go rise to 105,000 once dem complete dia ongoing renovation.

Already, Camp Nou na di largest stadium for Europe wit a capacity of 99,354.

FNB Stadium, Johannesburg

FNB na one of di venues for di 2010 World Cup wey South Africa host

Wia dis foto come from, Getty Images

Many pipo also know am as di Soccer City Stadium or di Calabash, dem open di 94,736-seater venue for Johannesburg for 1989.

Na one of di venues for di 2010 World Cup wey South Africa host and na also di home of Kaizer Chiefs.

Estadio Azteca, Mexico City

Di Estadio Azteca, wey be di home ground of Club America.

Wia dis foto come from, Getty Images

E dey sit for altitude of 7,200 feet above sea level, na for 1966, dem open di Estadio Azteca, wey be di home ground of Club America.

Di stadium capacity na 87,523. Na one of di venues wey go host next year World Cup.

Estadio Mas Monumental, Buenos Aires

Estadio Mas Monumental na di home stadium of River Plate

Wia dis foto come from, Getty Images

Na for 1938, dem open Estadio Mas Monumental wey be di home stadium of River Plate and di venue dey for Argentine capital Buenos Aires.

Estadio Mas Monumental get di capacity to sit 84,567 fans.

Signal Iduna Park, Dortmund

Na di home stadium of German club Borussia Dortmund

Wia dis foto come from, Getty Images

Borussia Dortmund home ground fit seat 81,365 fans, dem open am for 1974.

Also na di biggest stadium for Germany.

For US, several college stadiums dey wey fit hold more dan 100,000 pipo while di Narendra Modi Stadium for Ahmedabad, India, fit hold up to 132,000.

North Korea get stadium wit capacity of 150,000 wey many pipo often dey cite as di largest sporting arena for di world. However, di Rungrado1st of May Stadium na something dey dey hardly and reports of a smaller capacity figure also dey widely reported.

United don play for di largest stadium for US during dia pre-season tour for 2014 wia 109,318 pipo see dem beat Real Madrid for Michigan.

Di odas

  • Narendra Modi Stadium (Ahmedabad, India) - 132,000 capacity, 114,600 seats
  • Rungrado 1st of May Stadium (Pyongyang, North Korea) – dem claim say di capacity na 113,281
  • Michigan Stadium (Ann Arbor, Michigan) - 107,601 capacity
  • Beaver Stadium (State College, Pennsylvania) - 107,282
  • Ohio Stadium (Columbus, Ohio) - 102,780
  • Kyle Field (College Station, Texas) - 102,733
  • Tiger Stadium (Baton Rouge, Louisiana) - 102,321
  • Neyland Stadium (Knoxville, Tennessee) - 101,915
  • Darrell K Royal Memorial (Austin, Texas) - 100,119
  • Bryant-Denny Stadium (Tuscaloosa, Alabama) - 100,077