Prediction of all Champions League knockout round - Who go win di tournament?

Sixteen teams. Four rounds. One winner.
Who go lift di Champions League trophy on 31 May for Munich?
Di knockout stage go kotinu on Tuesday and Wednesday, di last 16 get some ogbonge fixtures dis week.
Thanks to di tournament new format, you fit plot all di teams route to glory.
BBC Sport readers bin vote for dia knockout round-by-round vote to predict who go dey crowned European champions.
And your winners na..... Liverpool.
Ninety percent of voters predict say di Reds go beat Barcelona for di final.
See how di round-by-round results bin go .
Last 16 results
Dis na how pipo bin vote.
Liverpool (86%) say dem go beat PSG
Aston Villa (83%) say dem go beat Club Brugge
Real Madrid (79%) say dem go beat Atletico Madrid
Arsenal (76%) say dem go beat PSV
Inter Milan (84%) say dem go beat Feyenoord
Bayern Munich (78%) say dem go beat Bayer Leverkusen
Borussia Dortmund (84%) say dem go beat Lille
Barcelona (96%) say dem go beat Benfica
Quarter-final results
Dis na how pipo bin vote.
Liverpool (90%) say dem go beat Aston Villa
Bayern Munich (66%) say dem go beat Inter Milan
Real Madrid (91%) say dem go beat Arsenal
Barcelona (88%) say dem go beat Borussia Dortmund
Semi-final results
Dis na how pipo bin vote.
Barcelona (68%) say dem go beat Bayern Munich
Liverpool (60%) say dem go beat Real Madrid
Final result
Dis na how pipo bin vote.
Pipo vote Liverpool (77%) say dem go beat Barcelona










