Russia hit main Ukrainian govment building for di first time

Wia dis foto come from, Reuters
At least two pipo don die and 13 wunjure afta overnight strikes by Russia on di Ukrainian capital of Kyiv.
One of di victims na a baby under one year old, wey dem pull out im deadi body from di rubble, Kyiv military administration head Tymur Tkachenko tok. Tori be say one young woman also die for di attack.
Tkachenko dey tell residents to remain for wia dem dey hide, and warn say Russia dey "deliberately hit civilian facilities".
Meanwhile, Kyiv Mayor Vitaliy Klitschko report say fire catch one goment building for di central Pecherskyi district – saying e be like say na from one di Russian drones wey Ukraine down.
Russia neva tok anytin about di strikes, but dia defence ministry say dia air defence forces shoot down or intercept 69 Ukrainian drones in several Russian regions.
Di overnight attacks on Ukraine come as Vladimir Putin dey warn di West say make dem no help di embattled kontri.
Ukraine Prime Minister Yulia Svyrydenko officially confam say na di Cabinet building for Kyiv damage afta di Russian attack early on Sunday morning - di first time dem don hit di building.
Di air force report say Russia launch a record number of drones and missiles in di latest attack - more dan 800 in total.
According to di air force, nine missiles and 56 drones hit 37 locations, and di downed pieces fall for eight locations.
Di PM say di roof and upper floors of di cabinet building also damaged.
"Di enemy dey terrorize our pipo across di kontri evri day," she write on social media.
Early dis morning we see big thick smoke dey go up- from just behind di Maidan, Independence Square.
Ukraine foreign minister, Andrii Sybiha, call for a strong response from Ukraine allies as Russia "escalates dia terror" against di embattled kontri.
"For di first time, more dan 800 drones and missiles overnight. Civilians killed and injured, civilian infrastructure damaged for Kyiv, Odesa, Kremenchuk, Kryvyi Rih, Zaporizhzhia, among oda cities," e write on social media.
Sybiha also confam say dem hit one of di govment buildings for Kyiv hit for di first time. "Dis alone na serious escalation," e tok.
"Di greatest cynicism na say these brutal attacks come just as President Trump make evri effort to achieve peace," e adds, saying Putin instead "reject diplomacy and escalate terror."
Sybiha call for severe sanctions on Russian oil and gas revenues, as well as further air defence support for Ukraine.
EU Council President António Costa accuse Russian President Vladimir Putin say e no just start war, wen Moscow launch dia full-scale invasion of Kyiv in 2022, but also "choose to kontinu am".
"We must stay di course: strengthen Ukraine defence and step up pressure on Russia through additional sanctions, in close coordination wit our allies and partners," Costa adds.
Norway call on di pressure on Russia to "stop dis aggression" to increase. Di kontri foreign minister, Espen Barth Eide, don condemn di overnight strikes, saying "once again, civilians suffer".
"Di attacks highlight di urgent need for a ceasefire," Finland foreign minister, Elina Valtonen, tok.
Spain add to di widespread condemnation, wit foreign minister José Manuel Albares offering im solidarity to di families of dos wey die and wunjure, as well as wit di Ukrainian govment and di pipo.










