How man stab Satanic Verses author Salman Rushdie for neck on stage

Salman Rushdie stabbed on the neck: Author of Satanic verses stab in New York

Wia dis foto come from, Getty Images

Di man wey dem suspect stab Salman Rushdie, author of Satanic Verse, for one event on Friday for US don dey charged wit attempted murder.

24 year old Hadi Matar, don appear for court and court don send am to jail without bail, di prosecutor tok.

Matar run on top stage and attack Mr Rushdie and one interviewer for di event for western New York state.

Di award-winning writer dey for critical condition as at Saturday, a day afta di attack.

Salman Rushdie dey on ventilator and no fit tok again afta dem stab on stage for America, according to im agent, Andrew Wylie.

Wylie say di author fit lose im eye sake of di attack wey happun for one event for New York recently.

Rushdie, age 75, don face death threats for years sake of im novel The Satanic Verses, wey some Muslims see as blasphemous.

Di Booker Prize winner, bin dey tok for one event for Chautauqua Institution on stage for New York state wen e happun.

New York State Police say one male suspect bin run up onto di stage and attack oga Rushdie and one interviewer.

"Rushdie suffer serious stab wound for neck," di police statement tok.

Di author bin dey transported by helicopter to one local hospital.

Di interviewer, Henry Reese, also suffer minor head injury.

Oga Reese be di co-founder of one non-profit wey dey provide sanctuary to writers exile under threat of persecution.

Rushdie suffer multiple wounds, doctor tok

One doctor wey dey di Chautauqua Institution event tell tori pipo New York Times say she help treat Rushdie afta di stabbing.

Rita Landman bin tell di Times say Rushdie suffer from some stab wounds, including one to di right side of im neck.

She add say pool of blood don form under im body on stage.

Rushdie no receive CPR dat time and show say e dey alive.

"Pipo dey say, 'E get pulse, e get pulse e get pulse,'" she tok.

Salman Rushdie dey for surgery, Reuters news agency dey quote im agent dey tok.

Andrew Wylie wey be Salman Rushdie literary agent, just confirm say di author do operation.

Anoda account of di attack come from John Nolen from US network CBS, wey bin get family members in di audience of di event.

Di assailant - wey appear to be a man wit a knife - dey reported to don strike Rushdie many times in di neck and torso area.

Rushdie reportedly stand up and fall backwards as him try to get away. 

A number of pipo come to im help and odas restrain di attacker, Nolen says.

E be like say blood pour for di screen behind Rushdie chair.

New York State Police detain suspect for scene

New York State Police say dem gbab di suspect for custody for di scene.

For one statement earlier, dem also confam say Rushdie suffer one obvious stab wound to di neck and dem fly am wit helicopter to one local hospital.

Dem also tok say im condition no dey known.

Wetin we know so far:

  • Di suspect in di attack don dey identified as Hadi Matar, 24, of Fairview, New Jersey
  • Rushdie still det undergo surgery for one local trauma centre as at 22:00GMT on Friday.
  • Police say dem never get indication for a motive behind di attack but dem dey work with di FBI to determine di cause.
  • Di suspect, Hadi Matar, bin get one access pass for di event and attend am alone.
Wetin we call dis Video, From di scene wia dem attack Salman Rushie on stage

 Attacker wear black mask - local tori pesin

One Mark Sommer of Buffalo Tori pipo bin dey hear from more eyewitnesses.

E tell BBC News Channel say di attacker obviously show from di audience wearing one black mask, jump on stage and begin attack Rushdie.

Shortly afta, ten to 15 pipo wey dey there to see di tok rush to help Rushdie and overpower di attacker.

Rushdie for ground for five minutes or so before dem helep am tanda up and walk off di stage.

Dem later evacuate am by helicopter.

Sommer say di Rushdie sometimes dey travel wit plenti security.

"E dey hard to believe say e no get ogbonge security [wit am]," e tok.

"E show say make we say na within seconds from di start of di programme wey di attacker rush di stage."

 Salman Rushdie profile

Salman Rushdie stabbed on the neck: Author of Satanic verses stab in New York

Wia dis foto come from, Getty Images

Indian-born novelist, Salma Rushdie catapult to fame wit di book Midnight’s Children for 1981, di book bin sell over one million copies for di UK alone.

But im fourth book, for 1988 - Di Satanic Verses - force am to hide for nine years.

Di writter, post-modern novel cause gbege among some Muslims, wey bin reason say im content dey blasphemous, ban am for some kontries.

One year afta di book dey release, Iran Supreme Leader Ayatollah Khomeini call for Oga Rushdie execution. E bin offer $3m (£2.5m) reward for fatwa – one legal decree wey one Islamic religious leader sama.

Di bounty over Oga Rushdie head dey active, and although Iran goment don distance demself from Khomeini decree, quasi-official Iranian religious foundation add for further $500,000 to di reward for 2012.

Di British-American citizen - wey dem born to non-practising Muslims and be atheist imself - e become one vocal advocate for freedom of expression, e dey defend im work on many times.