‘If we be men dem no go do us dis kain tins’
‘If we be men dem no go do us dis kain tins’
No be evri time pesin dey see musical band wey na only women dey inside.
Dis na di tori of one all-female band wey share dia experience for di job wey many pipo believe say na for men only.
Dem tok about how pipo dey underate dem for events and how dat kain treatment dey make dem feel bad anytime dem wan sing.
Despite di discrimination, Genial Sound all-female band believe say pipo go totally accept dem wen dem enta international level.
Gender discrimination na sometin wey dey common for Africa, wit Nigeria among di 10 percent kontri wit di highest level according to one Social Institutions and Gender Index report.
Video by: Monday Idara






