Italian fashion designer Giorgio Armani don die

Wia dis foto come from, Julien De Rosa/AFP via Getty Images
Legendary fashion designer Giorgio Armani don die for di age of 91 years, im company announce.
Di Italian billionaire na brand owner.
Armani, begin fashion company, and later go into music, sport and even luxury hotels.
Im company announce di death for dia Instagram page for on September 2025, wia dem describe am as dedicated pesin.
"Na wit infinite sorrow di Armani Group dey use announce di passing of dia creator, founder and tireless driving force, Giorgio Armani."
"Mr Armani, as we dey always call am wit respect and admiration by employees and collaborators, pass away peacefully, surrounded by im loved ones."
Armani Group describe dia oga as tireless pesin wey work until im last days to dedicate imsef to di "company, di collections, and di various new projects wey dey in progress."
"Ova di years, Giorgio Armani create vision wey extend from fashion to evri aspect of life. Always attentive to di needs of di community, e dey committed for many fronts, especially towards im beloved Milan."
Di company say Armani grow wit emotion and patience.
"Di family and employees go carry on di Group wit respect and kontinue dis values."
Di Armani brand dey for different parts of di world wia di designs dey totori plenti customers.
Wen be Giorgio Armani funeral
Di funeral chapel for Girgio Armani go dey set up on Saturday, 6 September 2025.
Na for dia dem go open am up for visitors until Sunday, 7 September from morning to evening for Milan Via Bergognone 59.
Meanwhile, sake of oga Armani express wish, di Group company announce say di funeral go hold privately.
Who be Giorgio Armani
Na respected businessman, wit im company wey dey bring more dan £2bn a year.
Armani dey for good spirit wen e appear for di brand shows last year.
E find Armani brand for 1975 and di brand celebrate dia 50th anniversary dis year same as im 91st birthday.
Armani, wey also dey known as 'Re Giorgio' - King Giorgio don build empire for di luxury fashion industry.
Dem born am for di northern Italian town of Piacenza for 1934. E study medicine bifor e enta career for and later launch im own fashion label wit im late partner, Sergio Galeotti.
Im fashion house get several different fashion lines don grow into couture, ready-to-wear fashion, accessories, beauty products and make-up, jewellery, interior design and luxury hotels for cities like Milan, Paris, New York, Tokyo, Seoul and Shanghai.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post









