South Africa legendary actress Nandi Nyembe die at 75

Nandi Nyembe

Wia dis foto come from, South Africa Government/X

Read am in 4 mins

South Africa famous actress Nandi Nyembe don die. She die at di age of 75.

Di Nyembe Family for one joint statement wit di kontri National Department of Sport, Art and Culture announce di passing of di legendary actress.

Madam Nyembe dey best known for her role as Sister Lizzie on di SABC 1 drama series Soul City, as well as Nandi Sibiya on di soccer drama Zone 14.

Throughout her remarkable 53-year career, Nyembe bring to life some of di most iconic characters on South African television.

Di South African govment describe di late Madam Nyembe as one of di kontri most treasured icons of di arts.

"Mam Nandi no be just actress; she be di very soul of South African storytelling. She be teacher, a guide, and a mother to dis nation, she carry our struggles, our laughter, and our victories through every performance wit truth, dignity, and heart. Through her life and work, she give our pipo pride and our stories, a purpose." Di govnemt tok for di statement.

Di Nyembe family add say, "Our hearts dey broken as we share di loss of our beloved mother and grandmother, Nandi Nyembe. To di world, she be gifted actress; to us, she be our everything. Her love, laughter, and strength go stay wit us always. We dey so grateful for di outpouring of love, prayers and support during dis time," Jabulani Nyembe, her grandson tok.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 1

Dem born Nyembe for Kliptown, Johannesburg for January 1950. She bin also stay for various places, like Botswana and East London and South Africa wen she dey small.

She begin act at a young age and her career wey span decades break barriers for television, feem and theatre. Di award winning actress don act for plenty feems.

She dey popular for series wey tackle social issues. Her powerful performances bin extend to oda hit shows, wey include di iconic Yizo Yizo, wia she play di roles Lily, wey capture di raw realities of township life.

Nyembe also shine for Zone 14 as Nandi Sibiya, Isibaya, Isithembiso, Ashes to Ashes, Jacob Cross, Soul Buddyz, Hillside, Erfsondes, 4Play: Sex Tips for Girls, and The No.1 Ladies' Detective Agency.

On di big screen, she don appear for feems like A Reasonable Man, Saturday Night and Yesterday, among odas.

Even in her later years, Nyembe bin continue to work, she appear for Showmax Adulting and House of Zwide.

Nyembe early career bin dey marked by challenges under apartheid, wia dem mostly cast her as maid. She don tok for various interviews how producers dey paint white actors wit black paint for leading roles wey need black characters. Dis issue dey make her para and she commit to activism through art.

According to di South African govment, her journey break barriers. She inspire young actors in villages and townships to dream beyond dia circumstances. She show dem say no be wia you come from dey define greatness, but by how deeply you deyvwilling to give of yourself. "Mam' Nandi give us everything. She be di voice wey say: "You sef fit rise."

Madam Nyembe death don send shock waves across Mzansi. Industry colleagues, friends and fans don begin share tributes to di late star on social media.

Di South Africa Films and Television Awards for dia tribute describe her as a true legend of SA film & TV wey her roles for Yizo Yizo, Zone 14 & Soul City define generations.

Oda social media say Mam' Nandi Nyembe powerful performance in Yizo Yizo, reflect di way she portray character wey stand firmly for justice and her community.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post, 2