You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria seal spot for knockout stage of Afcon 2025 afta victory against Tunisia
Di Super Eagles of Nigeria don book spot for di knockout stage of di African Cup of Nations (Afcon) afta dem sama Tunisia 3-2.
Wit 59 ball possession for Nigeria, dem struggle to keep dia three goals from Tunisia make dem no spoil dia show.
Di match wey take place for Complexe Sportif de Fès for Morocco bin witness serious pressure.
Na Victor Osihmen first open di scoreline as e give correct goal to put Nigeria for di lead. E head di ball inside net from di good assist wey Ademola Lookman give am.
Di first half end wit di Super Eagles lead while Tunisia bin dey hopeful to get dia own goal.
Afta di half break, tins begin change for di Super Eagles as dem gain more confidence for di pitch.
By di 50th minutes, evriwia good for Nigeria afta di incredible header by captain Wilfred Ndidi. E give one great goal from di corner angle wia e head di ball pass Tunisia goalkeeper. Na Ademola Lookman give di crossing for di assist.
Tunisia try well to give dia fans hope but notin show up for dem.
Di shocker come for 67 minutes wen Ademola Lookman use im left foot to shoot from di centre of di box to di bottom left corner.
Di good assist from Victor Osimhen afta di fast break wey happun for Tunisia box, help Lookman give Nigeria three comfortable goals.
E no too long bifor evriwia change for Tunisia. Sebastian Tounekti first miss one attempt for Tunisia afta im right foot shoot from outside di box but e go high and wide to di right afta a set piece situation.
Tunisia put one goal back into di net as Montassar Talbi score from a good position, as e put di ball behind Nwabali. Na Hannibal Mejbri do di assist wit a cross.
E no too long again wen drama sup for di game. Penalty show for Tunisia, afta referee check di VAR to see if na penalty or not.
By 85 minutes, Ali Abdi convert di penalty wit a left footed shot and give Tunisia two goals.
Di game change quickly as Tunisia come dey find dia equaliser but di Super Eagles lock di game down till full time, so dem go fit protect dia three goals.
Di game end in favour of Nigeria as di trio of Osimhen, Ndidi and Lookman help Super Eagles secure victory against Tunisia for Afcon 2025.
SECOND HALF
FULL TIME
Nigeria 3 - 2 Tunisia
Referee don blow whistle oooo
90+7mins: Talbi wit di ball again, e go fit pass Nwabali dis time? E give pass. Oh no, Nigeria defender block am.
Ferjani Sassi wit pressure on Nwabali, great strike from dat angle but e no go in.
90+4mins: Good run by di Nigerian striker, wat a strikeeeeee. Counter for Nigeria, Talbi move wit di ball.
What a miss, di ball waka pass Nwabali go beside di net.
90+2mins: Dangerous position for Nigeria as Tunisia press forward into di box, oh noooooo, e no go in.
SUBSTITUTION' Ademola Lookman out, Chidozie Awaziem in for Nigeria
90mins: Tunisia dey find equaliser so dem go spoil Nigeria 6 points
7 MINUTES ADDED TIME
88mins: Plenti shout from di Tunisia fans. Time still dey and anytin fit happun any moment from now.
Foul by Hazem Mastouri (Tunisia).
Nigeria 3 - 2 Tunisia
Ali Abdi (Tunisia) convert di penalty wit a left footed shot.
GOOOOOOAAAAAAAAAAALLLLLL
85mins: PENALTY for Tunisia
Referee dey check di VAR to see if na penalty or not.
Drama dey dis game oooo
84mins: More pressure from di Tunisian side, dem dey mount so much pressure on Nigeria so dem go fit score more goals
82mins: Attempt blocked. Ferjani Sassi (Tunisia) header from di left side of di six yard box dey blocked. Good assist by Hannibal Mejbri wit a cross.
80mins: Handball by Hazem Mastouri (Tunisia).
SUBSTITUTION' Chidera Ejuke replace Akor Adams for Nigeria. Moses Simon replace Frank Onyeka.
78mins: Foul by Hazem Mastouri (Tunisia).
Delay ova, match kontinue.
76mins: Delay dey for di match becos of injury on Stanley Nwabali (Nigeria).
SUBSTITUTION' Ismaël Gharbi replace Elias Achouri for Tunisia
Nigeria 3 - 1
74mins: Tunisia put one goal back into di net. Montassar Talbi score for Tunisia from a good position, as e put di ball behind Nwabali.
Assist by Hannibal Mejbri wit a cross following a set piece situation.
GOOOOOOOOAAAAAAAALLLLLLLL
71mins: Bruno Onyemaechi (Nigeria) win a free kick for di defensive half. Dat na foul by Elias Achouri (Tunisia).
MISSED'- Attempt missed by Sebastian Tounekti (Tunisia) afta im right foot shoot from outside di box but e go high and wide to di right afta a set piece situation.
69mins: Nigeria dey incharge of dis match, but di Tunisia still dey manage to find dia level. Foul by Calvin Bassey (Nigeria).
Hazem Mastouri (Tunisia) win a free kick for di attacking half.
Ademola Lookman us e im left foot to shoot from di centre of di box to di bottom left corner.
Good assist from Victor Osimhen afta dat fast break wey happun for Tunisia box.
67mins: Ademola Lookman complete di scoreline to three goals
Nigeria 3 - 0 Tunisia
GOOOAAAAAAAALLLL
63mins: Wilfred Ndidi (Nigeria) win a free kick on di right wing.
SUBSTITUTION' - Sebastian Tounekti replace Mohamed Ben Romdhane becos of injury.
61mins: NICE ATTEMPT!!! But dem block di attempt. Na Akor Adams (Nigeria) shoot from di left footed from di centre of di box but dem block am, afta Victor Osimhen assist am wit a headed pass.
Anoda corner for Nigeria, Tunisia goalkeeper don push di ball comot for di players head
57mins: Nigerian goalkeeper don go fall one player down oooooKasala dey oooooooo, be like di two teams wan do fight ooooo
Delay dey for di match becos of injury on Hazem Mastouri of Tunisia).
YELLOW CARD' Semi Ajayi chop yellow card for a bad foul.
55mins: Referee no overlook di foul by Semi Ajayi (Nigeria).
54mins: Foul by Ademola Lookman (Nigeria). Elias Achouri (Tunisia) win a free kick for di defensive half.
52mins: Foul by Calvin Bassey (Nigeria) as Hannibal Mejbri (Tunisia) win a free kick on di left wing.
Nigeria 2 - 0 Tunisia
Incredible header by Wilfred Ndidi, great one from di corner angle wia e head di ball pass Tunisia goalkeeper.
Na Ademola Lookman give di crossing to do di assist.
50mins: GOOOOAAAALLLL
OFFSIDE, dem catch Tunisia player Elias Achouri for offside.
48mins: Hannibal Mejbri of Tunisia win a free kick for di defensive half.
Semi Ajayi (Nigeria) win a free kick on di right wing afta foul by Hannibal Mejbri (Tunisia).
Foul by Mohamed Ben Romdhane of Tunisia. Bright Osayi-Samuel win a free kick on di right wing.
46mins: Second half don begin. More pressure from di Nigerian side as dem hope to score more gaols
Players don return to di field oooo
Nigeria 1 - 0 Tunisia
FIRST HALF
Nigeria 1 - 0 Tunisia
HALF-TIME
Referee don blow whistle oooo
45+2mins: Tunisia don vex oooo, but Nigerian players no gree for dem
YELLOW CARD
Victor Osimhen (Nigeria) chop yellow card.
2 MINS ADDED TIME
Nigeria 1 - 0 Tunisia
Victor Osihmen give correct goal to put Nigeria for di lead. Dat na veri good header by di Nigerian striker.
Dat Assist na from Ademola Lookman wit a cross.
44mins: GOOOOOOOOOOOAAAAAAAAAAAALLLLLL!!!!
Calvin Bassey (Nigeria) win a free kick for di defensive half.
42mins: Foul by Mohamed Ben Romdhane (Tunisia). Bruno Onyemaechi (Nigeria) win a free kick on di left wing.
Anoda foul by Mohamed Ben Romdhane (Tunisia). Bruno Onyemaechi (Nigeria) win a free kick for di defensive half. Foul by Mohamed Ben Romdhane (Tunisia).
39mins: Foul by Akor Adams of Nigeria.
37mins: Dis match hot oooo, di two team no wan gree for each oda. Corner for Tunisia afta Wilfred Ndidi concede am.
Be like Tunisia dey get more corners.
35mins: Attempt missed. Wilfred Ndidi (Nigeria) right footed shot from outside di box but e dey too high, afta assist by Calvin Bassey.
32mins: Bright Osayi-Samuel (Nigeria) win a free kick for di defensive half, afta foul by Ali Abdi (Tunisia).
Attempt missed. Ali Abdi (Tunisia) use left foot to shoot from outside di box but e go high and wide to di right following a corner.
31mins: CORNER for Tunisia. Conceded by Semi Ajayi.
We are back in play!!
Victor Osihmen down, di match go delay a bit
29mins: ANODA ATTEMPT MISSED!!! Victor Osimhen of Nigeria give header from very close range but e miss am fro di right side. Good assist by Calvin Bassey wit a cross.
Attempt MISSED. Semi Ajayi of Nigeria give fine header from di centre of di box but e miss am to di left left.
Na Ademola Lookman give am di assist wit a cross from di corner.
27mins: CORNER!!! Corner, Nigeria. Conceded by Hannibal Mejbri.
Victor Osimhen win a free kick for di right wing.
25mins: Anoda foul by Montassar Talbi (Tunisia).
23mins: dat na foul ooooooo by Bruno Onyemaechi of Nigeria.
Hazem Mastouri of Tunisia) win anoda free kick for di defensive half.
22mins: Great ball!!! Ademola Lookman don win a free kick for di attacking half.
22mins: Wat a foul by Ferjani Sassi of Tunisia
Nigeria 0 - 0 Tunisia
Foul by Victor Osimhen (Nigeria).
20mins: Dylan Bronn (Tunisia) win a free kick for di defensive half.
OFFSIDE'. Dem catch Victor Osimhen for offside.
17mins: WAT A SAVE!!! Attempt saved. Akor Adams (Nigeria) shoot right wit im foot shot from outside di box but Tunisia guy save for di bottom left corner. Na Aymen Dahmen of Tunisia save am.
Na Semi Ajayi do di assist wit a headed pass.
16mins: Attempt missed. Frank Onyeka (Nigeria) right footed shot from di right side of di box.
14mins: Foul by Ademola Lookman (Nigeria).
14mins: Ali Abdi (Tunisia) win free kick for di defensive half.
11mins: Attempt missed. Victor Osimhen (Nigeria) header from di centre of di box dey too high. Assisted by Ademola Lookman wit cross afta a corner.
10 mins: Corner, Nigeria. Conceded by Dylan Bronn.
10 mins: Attempt dey blocked. Bright Osayi-Samuel (Nigeria) left footed shot from outside di box dey blocked. Assisted by Alex Iwobi.
9mins: Attempt missed. Victor Osimhen (Nigeria) header from veri close range dey just a bit too high. Assisted by Akor Adams wit a cross.
8mins: Foul by Bright Osayi-Samuel (Nigeria).
8mins: Hannibal Mejbri (Tunisia) win free kick for di defensive half.
6mins: Foul by Calvin Bassey (Nigeria).
6mins: Hazem Mastouri (Tunisia) wins free kick on di right wing.
6mins: Attempt missed. Victor Osimhen (Nigeria) right footed shot from outside di box dey too high. Assisted by Bright Osayi-Samuel.
5mins: Akor Adams (Nigeria) win a free kick for di defensive half.
5mins: Foul by Montassar Talbi (Tunisia).
5mins: Attempt missed. Hannibal Mejbri (Tunisia) right footed shoot from di left side of di box misses to di right. Assisted by Elias Achouri with a headed pass.
4mins: Foul by Calvin Bassey (Nigeria).
4mins: Hazem Mastouri (Tunisia) wins a free kick in the defensive half.
3mins: Bright Osayi-Samuel (Nigeria) win free kick for di defensive half.
3mins: Foul by Ali Abdi (Tunisia).
1min: First Half begins.
Kick-off
Lineups
Nigeria lineup:
Nwabali, Osayi, Ndidi, Ajayi, Lookman, Onyeka, Osimhen, Bruno, Iwobi, Bassey, Akor.
Tunisia lineup:
Hannibal, Mastouri, Achouri, Skhiri, Ben Romdane, Sassi, Abdi, Talbi, Bronn, Valery, Dahmen.