Wetin we know about di kidnap of NBC News anchor Savannah Guthrie mother
- Author, Brandon Drenon
- Read am in 3 mins
Investigators for Arizona never still identify anybodi as person of interest for di suspected kidnap of NBC News anchor Savannah Guthrie her mama.
Since 84-year-old Nancy Guthrie disappear for midnight from her house for Tucson, authorities tok say dem dey investigate one alleged ransom note and believe say dem carry am against her will.
Pima County Sheriff Chris Nanos don beg members of di public make dem help investigators and say dem dey work day and night on di case. US President Donald Trump also order all federal law enforcement agencies make dem join hand to "bring her mama back home safely."
Today show presenter Savannah Guthrie, togeda wit her two brothers and sisters, make emotional appeal for dia mama release, dem tok say her health no good and she no get access to her drugs.
"Evribodi dey look for you, mommy," she tok. "Evri wia. We no go rest. Your children no go rest until we dey togeda again."
Dis na wetin we sabi so far about di case.
Wen Nancy Guthrie bin go missing?
Guthrie last show for her house for Catalina Foothills, one rich area about six miles (10km) north-east of Tucson, on Saturday evening, wen family members drop am around 21:30 local time.
Alarm start on Sunday morning wen pipo from her church notice say she no dey and alert her family.
Afta di family call 911, authorities begin search wey later involve volunteers and federal officers from Border Patrol, and di search kontinu reach di next morning.
Homicide detectives also enter Nancy her house, wey Sheriff Nanos say no be common tin. Afta dem enter, e tok say law enforcement see sometin wey give dem "serious concern", but e no explain wetin dem find.
On Monday, Nanos call di house a crime scene. Wen dem ask am whether authorities still dey look for Guthrie alive, e reply say: "We hope so."
Officials don warn say her health fit dey very bad if she no get her medicine.
Dem describe her as person wey no strong physically, but Nanos say she no get any problem wit her memory or thinking.
For dia video message, Savannah Guthrie and her brothers and sisters tok say:
"Her health, her heart dey very fragile. She dey live wit constant pain.
"She no get any medicine wit her. She need am to survive. She need am so she no go suffer."

Wia dis foto come from, Getty Images
Authorities dey follow leads – blood dey for di house and dem find ransom note
Even though no early sign show say dem target Nancy Guthrie bicos of her name, di sheriff tok say "we no fit rule am out."
On Tuesday, Nanos tell reporters say: "We believe say Nancy dem carry her comot from her house against her will. Na so di mata dey for now."
Wen dem ask am about reports say police dey test blood wey dem find for di house, e answer: "I no dey tok say blood dey inside dat house or outside di house."
He also tok say all di evidence wey dem gada from di house don go for analysis. But so far, lab results and oda evidence never lead authorities to any possible suspect.
Di sheriff no fit tok weda na more dan one person get hand for di alleged abduction.
For one earlier post for Pima County Sheriff Facebook page, di department say dem dey "aware of reports wey dey circulate about possible ransom note(s)," but dem no give details.
Nanos still tok say di sheriff office don collect copy of di ransom note and dey work wit FBI to confirm weda e real.
President Trump don call di case "one very unusual situation."
For her emotional plea, Savannah Guthrie say she and her family know about di ransom note too. She tok directly to whoever carry her mama.
"We ready to tok," she tok, as she add say: "We need to know wit out any doubt say she dey alive and say una get her… Abeg, reach out to us."
Authorities don beg di public make dem call di sheriff office if dem get any information, dem promise say dem go check every lead, and warn pipo make dem no spread wrong information.
For one social media post on Wednesday, di sheriff office tok say "to dey share unverified accusations or false information no responsible and e no dey help di investigation."
Savannah don comot from 2026 Winter Olympics coverage
Savannah Guthrie, wey dey host di Today show, never show for TV dis week.
She bin suppose co-host di Winter Olympics opening ceremony for NBC on Friday, but she no go take part for di coverage again so she go fit focus on and dey wit her family, NBC tok.
"Our hearts dey wit her and di entire Guthrie family as di search for dia mama dey kontinu," one tok-tok person for di network tok.








