ASUU extend strike for more weeks

ASUU strike 2022 update: Academic Staff Union of Universities extend strike in August

Di industrial strike action by members of di Academic Staff Union of Universities, [ASUU] go continue.

ASUU National Executive Council no consider di option of suspending di action at dia meeting wey end for di early hours of Monday for Abuja.

Dis na according to a statement from di Nigerian lecturers union.

Dis latest strike by Academic Staff Union of Universities start on February 14.

Recall say ASUU national president, Prof. Emmanuel Osodeke, bin on May 9 first extend di Nigerian public universities lecturers strike by 12 more weeks.

Labour unions across Nigeria join nationwide protest last Tuesday to protest di five-month long ASUU Strike.

Nigeria Labour Congress dey frown for di closure of public universities in di kontri sake of say goment and di lecturers disagreement on dia welfare.

Strikes by Nigeria public university lecturers dey common.

One strike wey ASUU bin do for 2020 bin last nine months.

ASUU Strike - Wetin NEC discuss

ASUU tok say di national leadership of di union only brief di meeting about dia interactions and submissions wey dem make to di Prof. Nimi Briggs Committee wey di Federal goment set up to renegotiate di 2009 Agreement with di union.

Di leadership also tell di meeting about di intervention of di Nigeria Labour Congress, NLC, for di mata and di subsequent nationwide solidarity rallies wey di Congress and dia affiliates do last week.

“Since no sign of any serious commitment dey on di part of di goment, no need for di NEC to consider suspending di strike.

"Can anybody say dis na wetin di goment dey offfer? Na dem be di pipo wey set up di Briggs Committee and e make recommendations and di goment troway di report.

“Di goment no dey sincere. make we assume say we dey ask for too much, wey no be even di situation, no be di goment suppose come out with dia offers and we go deliberate weda to accept or not.

"We don dey tok am since say dem wan to kill di university system just as dem do to di public primary and secondary schools."

“How many Nigerians dey proud now to send dia children to public primary and secondary schools wey we all attend for those days? Di national leadership of di union go soon come out with our decisions.”

Why ASUU strike

One of di major issue wey di block negotiation between goment delegates and ASUU na di payment platform.

ASUU dey insist say goment must use to take pay dem salary.

Di president of ASUU Victor Emmanuel Osodeke say di National Information and Technology Development Agency (NITDA) wey suppose conduct integrity test on di University Transparency Accountability Solution (UTAS) don abandon am even afta dem upgrade di payment platform.

But Minister of Labour and Productvity, Chris Ngige say ASUU dey try prolong di strike by making negotiation impossible.

E explain give say why dem dey insist on UTAS even wen NITDA say e fail integrity test and pipo fit commit fraud on top di platform wey lead to huge money.

"I yarn wit ASUU and NITDA to kontinu the test and see weda dem fit address di lapses and arrive for 100% because na wetin NITDA insists on.

“Dem say dem no go accept 99.9% of vulnerability and integrity test and dat dem no fit take dat kain risk sake of say dem fit hack di payment system".

“ASUU for y now don call off strike becos na wetin dey law took" Ngige explain

Ngige further yarn give say ASUU members shun to attend di meeting wey Prof. Nimi Briggs Committee on Renegotiation of 2009 Agreement put togeda for several time and dat di committee don finish dia work and don sumit dia findings to di ministry of Education.

ASUU strike 2022 update: Academic Staff Union of Universities extend strike in August
ASUU strike 2022 update: Academic Staff Union of Universities extend strike in August