Chidinma Ojukwu testimony so far inside Usifo Ataga murder case

Wia dis foto come from, Usifo and Chidinma Facebook
Trial of Chidinma Ojukwu di alleged killer of Super TV boss Usifo Ataga no fit hold on Wednesday sake of say defence council no show for court.
Wen di court call di case, Chidinma appear for dock wit her sister Chioma Egbuchu but di second defendant Adedapo Quadri no show for court.
Upon inquiry, di prison warder tell court say dem hand am 23 inmates wey dey come court in di morning but Quadri no dey among dem as im no know weda Quadri suppose appear for court today.
Di judge Yetunde Adesanya direct am to write di suspect name and make sure say e show for court for next sitting.
Di court clerk read out letter wey Chidimma lawyer Onwuka Egwu write to di court to ask for adjournment as im get family emergency outside di court jurisdiction.
Lawyer to di second and third defendants no also put in appearance too for dia clients and no send in any letter to explain why.
Di judge adjourn di case to Monday 16 June 2025 for continuation of trial.
Di former 300-level Mass Communication student of di University of Lagos Chidinma Ojukwu dey stand trial for di alleged murder of Ataga for 2021.
She also dey charged wit stealing and forgery alongside her sister, Chioma Egbuchu and one Adedapo Quadri.
Chidimma dey give her testimony and defence to prove say no be she commit di crime.
Na her defence head Onwuka Egwu dey lead am for di testimony. Wen she complete her testimony, di prosecution team go begin cross examination.
Cross examination na wen di prosecution team go ask am questions based on her testimony and oda evidence and facts wey dem get on di case to establish her guilt or innocence ontop di matter.
Chidinma testimony so far
So far for di case, di prosecution team don conclude dia presentation and sample all dia witnesses, while Chidinma don begin her defense.
Last time di case come up in court for April, court admit two different statements wey Chidinma write wen dem bin arrest am.
She bin don earlier tell court say no be she kill di deceased, say she come back to dia hotel room and meet di man in di pool of im own blood.
During her recent testimony for court, Chidinma tell court say afta she comot from di apartment to go buy food and juice, she bin comeback to di apartment, knock di door but she no get any response.
She push di door open, na wen she see a disturbing scene: blood stains for floor and Ataga dey lie down motionless in a pool of blood.
"I drop evritin wey I bin dey hold, I rush go meet am," she testify. "Im eye dey half-open and im pulse bin no dey."
Chidinma describe her relationship wit Ataga, she say na for November 2020 e start, afta dem bin introduce am to her by one mutual friend, Fiyin wey be di girlfriend of Ataga friend, James.
She say Ataga dey supportive and generous, she claim say im bin don pay her school fees and give financial support for her cosmetics business.
She tell court say Ataga bin contact her on 13 June, 2021, wen im inform her say im birthday dey come and im invite her to spend time wit am bifor im scheduled trip to Abuja for a family celebration.
Sake of renovations for wia im dey stay for Victoria Garden City (VGC), she say Ataga bin suggest make dem book hotel or short-let apartment for Lekki, wia im bin get business meetings.
She get one apartment for 19 Adewale Street, off Ologolo Road, Lekki, wey Ataga approve.
For evening dat same day, dem bin meet for di apartment, dem go out togeda go eat for Ango Villa restaurant wia dem bin buy wine, dem later go back to spend di night togeda, drinking, eating, and smoking.
She also tell di court say di following day wey be 14 June, Ataga bin ask her to help am buy loud (one type of Igbo) and rohypnol.
Im send her N15,000 to buy am, im later send anoda N25,000 for food.
On 15 June she tok say Ataga request for di loud again, im tell her to pay for am sake of say im bin no fit do bank transfer dat time.
Im bin also give her money for food and juice.
Wen she comeback to di apartment wen she finish her shopping, Chidinma narrate how she bin struggle to reach Ataga becos of di food order.
Wen she eventually arrive, she see say di door dey slightly open, and as she enta inside, she see im deadibody.
"I bin dey in shock, I wipe di blood off myself, change my clothes, and pack my belongings," she tok
Among di items wey she agree say she bin take from di apartment na brown envelope wey contain Ataga bank statements, im ID cards, documents wey belong to one Mary Johnson, and some pieces of jewelry.









