Jica name Kisarazu as hometown for Nigerians

Read am in 3 mins

Japan International Corporation Agency (Jica) don designate Kisarazu city as di hometown for Nigerians.

Nigeria Ministry of Information and National Orientation wey give di informate on dia X handle on Friday 22 August say dis na efforts to deepen cultural diplomacy, promote economic growth and enhance workforce productivity.

According to di ministry, na for di sidelines of di 9th Tokyo International Conference for African Development, dem announce dis initiative.

Dem bin say di Japanese govment go create special visa category for highly skilled, innovative, and talented young Nigerians wey wan go Kisarazu to live and work.

Days later, di Japanese govment come out come tok say plans no dey to take measures to promote di acceptance of immigrants or issue special visas for residents of African kontris.

Japan International Cooperation Agency tok dis one for statement wey dem release for dia website on Monday.

Dis clarification later make di Nigerian govment issue correction to di informate wey dem bin circulate.

Wetin Nigerian govment bin tok

Japan International Cooperation Agency, for one ceremony name di cities of Nagai for Yamagata Prefecture di hometown of Tanzania, Sanjo for Niigata Prefecture di hometown of Ghana, and Imabari for Ehime Prefecture di hometown of Mozambique.

Through di arrangement, Japan look to strengthen exchanges wit di four African kontris by officially connecting municipalities wit existing relations wit dose nations, according to di Nigeria Minister of Information.

"Nigeria Charge d'Affaires, Mrs. Florence Akinyemi Adeseke, also di Acting Ambassador to Japan, and Yoshikuni Watanabe, di Mayor of Kisarazu, bin receive di certificate from di Japanese govment naming Kisarazu di hometown of Nigerians.

"Di four cities go foster foundation for two-way exchanges for manpower development wey go add value to di economic growth of Japan, Nigeria, and di oda three African nations," di ministry tok.

About Kisarazu city?

Kisarazu na home to 136,000 pipo, and na only 70 kilometres away from di capital city of Tokyo.

E dey popular for fishing and farming and residents dey enjoy easy life for di city. For 2020, Nigeria Olympic team camp and train for di city.

Di city dey popular for seafood, and among dem na salmon and clams. You fit get oda Japanese cuisine like ramen, udon, takoyaki and taiyaki.

Di pipo of Kisarazu dey like to party like Nigerians and dem love education as dem dey also teach in English for dia schools.

Dis story now contain additional reporting to reflect wetin Japan govment tok and di correction wey Nigeria govment later issue on Tuesday 26/08/2025.