Court grant bail to Regina Daniels brother, but wetin don happun so far?

Samuel Ijegwu alias Sammy West wear red cap and white cloth dey hold her sister Regina Daniels wey wear red cloth

Wia dis foto come from, Sammy West/Instagram

Read am in 6 mins

Actress Regina Daniels broda, Samuel Ojeogwu wey call imself Sammy West don get im bail afta e bin dey arrested for Abuja.

Dis na according to informate wey actress, Doris Ogala bring come outside.

Videos of Sammy release don also spread for social media - wey show dia mama Rita Daniels dey thank Nigerians wey dey support dem.

According to Ogala, na Omoyele Sowore bin assist in di release of Sammy even though di video no show am dey comot custody.

Dis dey come afta oga Sowore don alreadi chook mouth inside di mata say, "APC Senator, Prince Ned Nwoko suppose dey held accountable for crimes against minor and abuse of power."

On Saturday, Senator Nwoko accuse di musician, Sammy say e destroy im property and add say na im sef introduce Regina to di drugs wey she dey take to lead am to di rehab mata wey she run comot from.

E post videos for im social media say, "dis videos dem show Sammy, Regina brother dey come my house several times and harass my pikin dem and domestic staff, especially wen I no dey. Im vists most times dey agressive and disruptive".

Oga Nwoko accuse di broda of im siblings say dem dey force dia way into di house wen Regina Daniels dey do rehab to give am di drugs wey dem dey try rehabilitate am from.

E add say, "e dey important to torchlight say Lawrence, Sammy, im babe NK, Destiny, Sonia and odas dey do di same drugs wey Regina dey do. Infact na Lawrence and Sammy introduce di drugs give and ans supply am di drugs."

While e neva clear wen dem arrest am even as Regina Daniels bin first post say she dey find am on Wednesday, 5 November, di FCT police force comot on Friday, 7 November tok di reason for im arrest.

Regina Daniels during interview with BBC News Pidgin

Di command say dem receive one petition against di actress brother for alledged conspiracy, trespass, assault, criminal intimidation, theft and cyber-bullying.

FCT police tok-tok pesin, SP Josephine Adeh, tok say dem bin don invite Sammy for questioning but e no gree show.

Dis na wetin carry dem go Lagos "on di authority of di duly issue arrest warrant from di competent court, and den carry to Abuja for more investigation," to arrest am.

Di police tok-tok pesin tok say dem don charge Sammy West to court on 6 November on charges "bordering on criminal conspiracy, criminal trespass, assault, criminal intimidation, and theft."

She tok say di court remand am pending di fulfilment of im bail conditions.

Instagram Post about Sammy West behaviour from Ned Nwoko

Wia dis foto come from, Instagram/@princenednwoko

Di Nollywood actress post one video on Instagram on Friday morning wia she dey cry ova di detention of her brother, Sammy West by di Nigeria Police Force (NPF).

Regina demand ansas to why police neva gree to release her broda from dia custody.

"I try, I feel say I dey go crazy and I dey lose my mind, and E no make any sense. I dey cry presently in front of evri body. Please, wetin I dey beg for? I no know," she tok.

"Una tink say e dey easy to dey wake up and seeing one tin about my broda online? Today, I go hear some good news say dem go release am, and tomorrow, I go hear anoda tin. Like, wedtin be di problem? I don try, but I go, go back."

For anoda post on Saturday, she tok say na true say she dey take drugs but say Ned Nwoko bin like am like dat.

For notes app style post on Instagram, di actress write say, "you say you wan make I go rehab, but na you be di same Ned wey always want make I high, bicos for your words, I dey 'sexier' wen I dey high".

She also reveal some oda pipo for oga Ned life wey allegedly dey do drugs too, she say, "why you no also tell dem say all your wives and ex wives dey on drugs? And you fit dey kind enough to tell dem why e be so?"

For di post she also add accuse of alleged sexual assault on top di mata as well as accuse of underage marriage.

Domestic violence, drug abuse and all di tins wey we know from di Nwoko home

Di latest accuse for Instagram snap shot wey Regina Daniels fire her Senator Husband Ned Nwoko

Wia dis foto come from, instagram/@regina.daniels

For 18 October, Regina Daniels post one video wey go viral wia she accuse her husband say im send im "thugs" make dem attack her.

Regina Daniels dey cry inside di video while di pipo wey dey around her dey try to console her, she begin dey shout say she no fit tolerate di violence by her husband again.

"For Ned Nwoko house, I be notin, but for my house, I be queen. Not again, I no fit stand di violence, e too much," she tok.

By dat Sunday, 19 October, Oga Nwoko comot wit evidence against di accuse as e show video wey contain images of cracked windows, table wey di glass don break and damaged car.

E allege say im wife, Regina dey violent and she don hit three staff and destroy properties inside for no reason.

"Regina na di violent one here, slapping and hitting three staff in di past 48 hours and destroying property, including cars and windows, for no just cause.

"Di truth be say, I don set clear condition for her to accept rehab for Asokoro or outside Nigeria especially Jordan wia she no go get access to drugs."

For di statement, di 64-year-old senator, tok say im no dey violent towards any of im wife but Regina bin move comot from house becos she wan get unrestricted access.

"Regina no always like dis. Her current battle wit drugs and alcohol abuse na di root of our problem," e tok.

"She must continue her rehabilitation program, or I fear for her life and safety.

"Now she don move to place wia she get unrestricted access to drugs. I get oda wives, and none go ever accuse me of violence."

Few days ago, Regina accuse police of arresting her broda ontop di mata.

But tins take anoda turn on Wednesday wen she publicly address clearly some of di issues.

"Finally some pipo go get video now wey dem go fit take mock me... My entire focus right now na to know wia my broda dey. Wia Sammy dey Ned!!!"

Regina also accuse di "highest authorities for di police force, or if not di highest wey say dia hands dey tied" she write.

"I no regret anytin. Na only me carry my leg enta but dis na di route wey I dey meant to take, no be my final destination!!"

Senator Ned bin celebrate dia six years togeda dis year for 27 March as di union don born two boys.