Court sentence killer of Uniport student Justina 'Tiffany' Otuene to death by hanging

Wia dis foto come from, Rivers State Police Command and Tiffany Otuene/Facebook
Dis tori get graphic description wey fit worry you
One Rivers State High Court for Port Harcourt don convict and sentence a former student of di University of Port Harcourt (Uniport) to death by hanging for di murder of im girlfriend.
Justice Chinwe Nsirim-Nwosu as she deliver judgement on di mata hold say di prosecution prove beyond reasonable doubt say Damian Okoligwe murder Justina Otuene, wey also be student of Biochemistry of di same University, Uniport, dat time.
Na for October 2023 di incident happun afta estate security for one estate for Mgbuoba area discova di body of di young girl.
During di trial, di court hear say Damian Okoligwe wey bin dey study Petrochemical Engineering, commit di crime for im apartment for Mgbuoba community, for Obio-Akpor Local govment Area.
Di prosecution share details of how Okoligwe murder di female student, come divide her body into parts, wey im pack inside wheelbarrow, bifor dem catch am as e try to go troway di bodi for one refuse dumpsite.
Wen di mata happun dat time for 2023, di management of Uniport say dem no go rest until late Justina Otuene get justice.
Di Dean of Student Affairs Uniport dat time, Chima Wokocha and di Vice Chancellor dat time, Prof Owunari Georgewill bin visit di Police station wia police bin hold di prime suspect for di alleged murder.
Di University say dem dey embarrassed by wetin happun and dem go support evri effort to bring justice for di mata.
Na dat suspect wey police bin gbab dat time, wey be di deceased boyfriend, court bin convict and sentence now.
Wen e dey deliver di judgment for di trial, Justice Chinwe Nsirim-Nwosu describe di action of Okoligwe as "intentional, calculated, coordinated and evil."
Di prosecution lawyer, Charles Mbaba say e dey satisfied wit di judgment, come add say e go serve as a lesson to discourage oda young pipo wey dey desperate to get rich.
Brother of Late Justina, Osatawaji Otuene, say im family dey happy wit di judgement as e don give im sister justice. E commend di court for ensuring say justice dey served for di mata.
How we take reach here between late Justina 'Tiffany' Otuene and killer Damian Okoligwe
Di horrifying death of one undergraduate student for UNIPORT Justina Otuene Nkang wey pipo sabi as 'Tiffany’ bin vex plenti pipo.
Tiffany na 300level student of di University of Port Harcourt for Rivers state, South south Nigeria, wen she kpai.
Tori be say na di estate security for one neighbourhood for NTA Road Mgbuoba, Port Harcourt discover di body of one young girl.
Dem catch 25-year-old man Damian Okoligwe, wey dem say na her boyfriend wen e dey try move di deadi body comot – dem alert police wey arrest am.
Di suspect dat time na also student of di University of Port Harcourt.
Videos wey bin circulate on social media show how dem hold boyfriend for handcuffs and lead police officers go im house.
For di house wey be like studio apartment – di man carry di investigators enta one room wia wheelbarrow dey inside.
Wetin dey on top di wheelbarrow full sack wey dem wrap well-well wit blood stains.
For di video, pesin fit also see plenty stream of blood for ground.
Pipo still dey wan sabi di true identity of di man wey commit di crime.
Many social media users wey don see di tori dey claim say di suspect slaughter Tiffany – say e cut different parts of her body comot.
Na from dia Rivers state police command don begin work to reveal wetin happun.
Meanwhile, UNIPORT VC dat time insist say “justice must be done for di mata becos no student here get di right to kill or get physical with anybody. E dey wrong and di punishment for fighting or getting physical with anybody na outright expulsion.”
Though di suspect agree say di victim na im girlfriend and dem find her deadibodi for im house, e deny say na im kill her as e say wen e come back house e find her dead.
But e no fit explain why some parts of her bodi dey miss and why e no call police wen e discover say she don die.
According to di boyfriend, e bin meet Justina lifeless body inside im apartment but e no report to any authority.
E say na only im dey stay di apartment.
Di suspect den claim say di reason why e no report to authorities say im girlfriend die na becos im bin dey sick.
Meanwhile e bin stay inside di apartment wit di dead bodi despite di bad odour wey dey comot from dia, e add.
Police authorities for Rivers State arrest di prime suspect, a 24 year old Chemical Engineering student of Uniport wey be di boyfriend of di victim.
Di case dey transferred to di State Criminal Investigations Department to chook eye for di mata before dem charge am to court.
Commissioner of Police Rivers State, Polycarp Nwonyi say dem don deposit di deadi body of di victim wey di suspect cut to pieces for mortuary for autopsy as dem suspect say di dismemberment na for ritual purposes.
Ova two years afta, court don sentence di alleged suspect to death by hanging.

Wia dis foto come from, Awajis George










