Fact Check: True tori of wetin happun for Ibadan explosion

Wia dis foto come from, James Igbasan
Oyo state goment don direct pipo wey dey live for Adeyi avenue, Bodija Ibadan to comot di area afta one big explosion shele for di area on Tuesday night.
Di state goment also direct make hospitals dey admit and treat victims of di incident once dem bring dem come dia facility.
One big explosion wey happun wey pipo dey tok say na from mining explosives leave deadly effect for pipo and property of di area.
Videos wey dey go round show pipo still dey worry and buildings collapse sake of di big vibration.
BBC News witness di rescue of one elderly man from under di rubble on Wednesday morning as many pipo bin gather dey look.
Many of dem dey cry and hope to know wia dia loved ones wey still dey miss fit dey.
One of dem na painter wey bin tell BBC News say e neva find im contractor.
“I bin paint one of di collapsed buildings just yesterday but go church and tell am say I go kontinu today but I no know wia e dey.
End of Di one wey oda users dey read well well
“I don dey call am but di number no konnect and I see say im motor don destroy.
Aarinola wey witness di event tell BBC Pidgin say she bin dey tok for phone wen she first hear di loud bang wey cause make her phone die immediately.
“My children bin run out of di room to ask me wetin happun, we run outside but we no see anytin, na den we begin run about for ova three hours sake of say nobody fit stay inside house sake of bad chemical smell and broken windows and doors”.
“Wen we reach di place wey di main explosion shelle we bin see a lot of bad tins, broken houses, broken cars,deaths, corpses inside cars, but we thank God say we still dey alive”, Aarionla tok.
Aarinola add say she and her pikins neva go back house since lastnight as dem find hotel fort anoda area to sleep.


Residents for di area wia di incident bin shelle tok say dem neva fit account for all di pipo wey dem sabi, dem tell security pipo say dem dey sure say dia pipo still dey trapped inside some of di houses.
One man wey no mention im name say e narrowly escape death as im bin comot im oga house for di area 10 minutes bifo di explosion.
Di man wey go dey middle age dey cry as e kontinu to beg authorities make dem helep am rescue im oga wey e say go still dey trapped for house wit im family.
Anoda woman wey follow BBC tok say plenti pipo don die while oda bodies still dey trapped for rubbles.
Security pipo don cordon off di areas as dem kontinu rescue and evacuation work for di Adeyi Avenue, Bodija Estate Ibadan.








Di National emergency management agency (Nema) say all relevant agencies of goment don dey alert for rescue operations.
Di South west zonal office for update dem post on Facebook say di "police, DSS, civil defence, Red Cross, Fire service including di local security outfit, Amotekun go follow for di operations wey go start Wednesday morning."
Late inside di night di Oyo State governor Seyi Makinde tok say na di activities of criminals cause di explosion.
Oga Makinde reveal say two pipo don die from di informate wey im get and 77 pipo don wunjure.
Di govnor tok dis one wen e lead goment officials go di scene of di incident wey don destabilize di state.
Govnor Makinde add say di explosion bin cause death and injury to residents of di state and im don deploy relevant agencies to begin rescue operations.
"In total, 77 injured victims don dey so far and dem don collect treatment. Two deaths bin dey and make dia soul rest in peace," di govnor tok
Govnor Makinde add say di goment to pay medical bills of pipo wey dey affected and dem go provide temporary accommodation for doz wey dia houses don destroy.
X users spread fake informate about Ibadan explosion

Wia dis foto come from, TRENDING EXPLAINED/X
Some fake claims about wetin happun for Ibadan spread on social media as news of di explosion break.
One post on X (former Twitter) wey get ova 74k times view bin claim say Ace Mall, one big shopping mall wey dey about 500 metres away from di site of di explosion, dey “sent tumbling”.
However, dis informate dey debunked as videos and fotos of di mall wey show say e still tanda dey shared by oda social media users.
One X user wit di handle @MayorLadseriki_ post one video wey show debris from wetin look like part of one roof e say dem take from di third floor of Ace Mall. E bin also claim say e bin dey dia wen di incident shele.
David Fatunmbi, anoda X user bin share one photo of Ace Mall wit cracked glass wey fit be from di blast wave of di explosion.

Wia dis foto come from, Your Fav Hair Plug/ X

Wia dis foto come from, IG:lordozii/ X
Oda users also post videos of di Domino’s Pizza wit glass windows wey don shatter allegedly sake of di explosion.
Dominos Pizza dey about 600 metres from di crater wey di explosion cause.
E bin get oda false claims wey relate to di incident wey dey circulate on social media.
Claims dey say di explosion na di aftermath of one terror attack, but di govnor of Oyo State, Seyi Makinde, bin tok say early findings show say na dynamites wey “illegal miners” keep bin cause am.
Also, eyewitness videos on X bin show as residents dey tok say e bin first get one fire outbreak for one of di houses bifo di blast.
Anoda false claim by one X user bin claim say na gas explosion for one Gas depot for Bodija cause di blast. Dis claim dey viewed over 350k times and get 886 likes and 691 shares.
According to di govnor of Oyo State, 2 pipo dey killed by di explosion and 77 odas wey get different degrees of injuries dey kollect treatment for hospitals for di state.
Di site of di blast na about 900 metres from di govnor office.














