You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
England move top of group C despite 1-1 draw wit Denmark for dia second game
England move top of group C despite 1-1 draw wit Denmark for dia second game of di 2024 EUROS.
Goals from Harry Kane and M. Hjulmand secure one point for both team, but di talking point be di stunning goal wey di Denmark player score for di game.
Di three lions begin di game wit energy wia dem get dia goal thru dia captain Harry Kane for di 18th minute bifor Denmark respond wit M. Hjulmand im goal from outside di box.
Di Danes grow into di game wia dem create plenti chances to win am, but in di end, di two teams settle for draw.
England now dey top di table wit 4 points from two games wia Denmark dey second wit 2 points from two games.
Slovenia wia also play 1-1 draw wit Serbia, now dey fourth wit 2 points - Serbia dey bottom wit only one point.
Di last round of group games go show which team fit qualify to di knockout stage.
93" FULLTIME!
End of Di one wey oda users dey read well well
92" Trippier don win foul, but referee blow for end of di game.
91" Poulsen from Denmark don fall for ground dey shout, but ref blow whistle for freekick.
90" Dem don add 3 minutes of additional time.
86" Waste! England get freekick for di halfway line but di subsequent freekick go wide.
85" E dey look like Denmark fit to create sometin bifor fulltime. All di attacks for di last ten minutes dey come from Denmark.
83" Not long afta England start di ball, anoda mistake happun wia Hojberg strike di shot from outside di box. But di ball go wide.
82" Rice and Guehi don combine to dash Denmark di ball inside dia danger zone, but di Denmark player delay on top of di ball wey Guehi come back to block for corner. Christensen head di ball from di corner wide.
81" England take di throw from di far side but Rice lose di ball for di middle.
80" Bowen and Bellingham try to create sometin but di ball go out for throw. Eriksen don dey comot di park.
78" Twelve minutes to see if dis game go get anoda goal.
76" Hojberg don shoot again from long range - di ball take deflection for one player bifor di England keeper come save am.
75" England tink say dem get chance to break on goal but referee blow whistle for foul on Vestegaard.
74" Di game now begin to dey slow down wit plenti fouls hia and dia.
73" Di Aston Villa striker Ollie Watkins don dey cause Denmark plenti wahala. Im get anoda chance but im win corner instead.
72" Pickford don save anoda long range shot from Hojberg.
70" From di corner, Denmark get counter but England recover.
69" England dey try to create sometin. Substitute Watkins dash behind di Danish keeper wey block am for corner.
67" Pressure don dey mount for England. Coach Gareth Southgate don dey change. Jarrod Bowen dey replace Foden, Eze dey replace Saka wia Watkins come replace Harry Kane.
65" Declan Rice don concede corner as Denmark effect anoda substitution. Hojlund from Manchester United don comot.
63" Chaaance! Manchester United player Christian Erikson take one shot from outside di box but e go way over
61" Ghallager wey come inside dis game minutes ago don get yellow card
60" Poor freekick by Erikson as im ball don hit di opponent.
58" Saka don try to shoot from distance but im no trouble di Denmark keeper
57" Denmark get anoda chance but im dey weak.
56" Denmark also don dey make change.
55" CHAANCE! Foden hit di post from distance afta Saka play di ball through.
54" England win a throw for di Denmark area but di resulting throw be bomb.
51" Chelsea captain Conor Ghallager don dey come on. Im dey replace Trent Alexander-Arnold.
49" England drive forward from di midfield but di last pass dey worry dem. Declan Rice shoot, but di keeper catch am.
47" England sustain seconds of possession but dem no fit to create any danger for dia opponents.
46" Slow start for dis second half from England - Denmark don dey continue from wia dem leave tins for di first half.
Hojlund head di ball on target but Pickford catch di ball.
45" Both teams maintain dia players wit no changes.
Players don return to di park as referee blow whistle to begin di second half. Which team go get di go-ahead goal for dis half? Time go tell.
Halftime.
England 1 - 1 Denmark
45" Foden shoot ova di bar - dat na wia di referee blow whistle.
44" As halftime don dey approach, England dey try to create something but so far e no trouble Denmark.
43" Anoda long range shot by Hojberg. Dis time Pickford save am but di chance still dey for Denmark, but dia final ball dey intercepted.
41" Trippier, Bellingham, Foden pass di ball among diasef. Bellingham backheel di ball to Trippier but di final shot wey Foden strike na poor one.
40" Phil Foden carry di ball dey run towards di Denmark box, im decide to take di shot from outside di box, but e neva trouble di Danish keeper.
40" England don begin dey struggle for midfield.
39" Denmark don create more chances wia dem get more shots on target pass England.
38" From di corner by Erikson, Anderson connect wit im head but di ball go ova di ball.
37" Denmark don begin to pile pressure on top di three lions, wia M. Hjulmand get anoda chance to shoot - dis time e get corner.
33" GOAAAAL! Denmark equalize. What a strike from M. Hjulmand from way outside di box. Di shot beat Pickford low into di net.
32" Referee blow whistle for foul afta Denmark take di corner - di chance don vanish.
31" Di pressure all dey for di England area. Denmark win corner for dia efforts.
29" Andreas Christensen don block Saka from driving into di Denmark area from one counter attack. Di Arsenal forward tink say na foul, but referee disagree.
28" Chaaaance! Denmark put pressure for di England defence wia di ball fall to Erikson. Hojlund try to backheel di ball into di net but Pickford dey alert.
27" From di freekick, England try to force a shot on goal, but Guehi im shot dey weak wia im bounce wide.
25" Pressure in front of di England box as Denmark try to create dia chance but England get counter wit Saka. Vestegaard don foul am and im get di first yellow card of di game.
23" Andersen fron Denmark head one weak effort afta Erikson cross di ball from di far end.
20" Denmark dey try to respond to dat goal but England dey defend.
17" GOOOAAAAAL! Hary Kane finally score from close range. Di Bayern Munich striker benefit from some poor defending by Denmark to score im first goal of di tournament.
Kyle Walker provide di assist.
13" Afta some good build-up, di ball don fall to di premier league player of di season, Phil Foden, but im left foot shot rise ova di bar.
12" England dey patiently pass di ball around di Denmark box - waiting for di opening.
11" Offside! Rasmus Hojlund try to beat Guehi to reach one long ball ova di top but di linesman raise im flag.
10" Phil Foden, Rice and Bellingham try to string passes togeda bifor dem switch di play.
9" Walker don change im boots as Denmark dey try control possession for midfield.
8" Kyle Walker don injure and im siddon for di turf. Di Manchester city defender dey receive treatment
7" Maehle break through for di far end but im no fit keep di ball under control - e foul Trippier in di process.
6" One long ball ova di top from midfield pass everibody wia Denmark keeper comot come catch am.
6" Kyle Walker dey get joy for di left side of di Denmark area, but im final ball dey weak.
4" Denmark dey advance into di England area but Erikson pass di ball wia im teammates smash di shot into di England bodies.
3" No clear cut chances so far for dis game but both teams don dey try to create sometin.
2" Walker run enta di box but im cross no find any of im teammates. Denmark don clear dia lines, but di ball dey back to di three lions.
2" England take ova possession.
Denmark don begin to string some passes together but dem no threaten dia opponents yet
1" Match don start
Both teams don comot for park wia dem sing dia national anthems.
Line up
England XI: Pickford (GK); Walker, Rice, Stones, Guehi, Trippier, Saka, Alexander-Arnold, Foden, Bellingham, Kane
Denmark XI: Schmeichel (GK); Anderson, Christensen, Vestergaard, Maehle, Hjulmand, Hojberg, Kristiansen, Erikson, Hojlund, Wind
Date, kick-off time and venue
Denmark vs England kick off by 5pm WAT on Thursday June 20, 2024.
Di match take place for Waldstadion for Frankfurt.
Match stats
- England bin neva win dia opening two matches for European Championship tournament bifor.
- Di Three Lions bin only get 12 touches for Serbia box last Sunday, dia lowest total of touches for di opposition box for a European Championship game since 2012.
- Only Sir Alf Ramsey (67% - 8/12) get a better win-rate among England managers for major tournaments pass Gareth Southgate (60% - 12/20).
- England bin don keep one clean sheet for each of dia past five group stage matches for di Euros, na di longest of such run for di competition history.
- Denmark bin don win just one of dia past six group stage games for Euros (D1 L4), dem bin beat Russia 4-1 for Euro 2020 to qualify for di round of 16.
- Denmark bin complete 583 passes and enjoy 89% pass accuracy for dia 1-1 draw against Slovenia on Sunday, both na high record for di Danes wey Opta don record (since 1980) for European Championship.