You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Jury find Diddy guilty of some and not all di charges against am
Di jury don reach verdicts for di sex-trafficking trial of American music mogul Sean "Diddy" Combs.
Di jury find di Sean "Diddy" Combs not guilty of racketeering, and not guilty of sex trafficking ex-partner Casandra Ventura plus anoda woman referred to as "Jane".
Dem find Oga Combs guilty on two counts - of transportation to engage in prostitution wey relate to Cassie Ventura and to "Jane".
Di charge jury find am guilty of - transportation to engage in prostitution - carry 10-year maximum prison sentence.
Dis verdict no doubt na victory for Sean Combs and im team.
Transportation to engage in prostitution charges carry di least jail time compared to wetin e for serve if to say dem find am guilty of sex trafficking and racketeering.
Central to dis case na di prosecutors' argument say Diddy bin force im former partners into so-called "freak offs" – one prolonged, drug-fuelled sexual encounters wit male escorts.
Court bin hear ogbonge testimony from Ms Cassie Ventura, im former partner, about how humiliating dis encounters bin dey for her.
E dey quite striking say dem no find am guilty of racketeering and sex trafficking. Racketeering na charge wey for long dey associated wit mob or mafia bosses. Dem base am on top di argument say im actions constitute a criminal enterprise wey involve many of im staff.
Dat no be di case, according to dis jury and verdict.
Di charges and di verdict
To sum up wetin just hapun for court, Na a mix of guilty and not guilty verdicts:
- Racketeering conspiracy: not guilty
- Sex trafficking of Cassie Ventura: not guilty
- Transportation for prostitution of Ventura and others: guilty
- Sex trafficking of woman known as "Jane": not guilty
- Transportation for prostitution of "Jane" and others: guilty
Wetin exactly Combs dey guilty of?
Di jury return guilty verdict on two counts, both of transportation to engage in prostitution relating to Cassie Ventura and one anonymous victim wey dey known as "Jane".
In simple terms, e mean say di jury find Combs guilty of transporting di two women to places wia dem go participate in sex acts and prostitution.
Both women, wey bin date Combs, separately testify about "freak-offs" or "hotel nights", wey dem describe as sexual encounters wia di couple go hire male escorts to have sex with di female partner while Combs go dey watch, at times e go dey record or direct dem.
How long Combs go spend in prison?
Di guilty charges carry maximum sentence of 10 years.
While di jury find Combs guilty on two counts, e never yet know exactly how long e fit spend for prison as a result. Dat one go come later during a separate sentencing hearing.
We no know yet whether Combs go remain in prison until dat time - prosecutors don argue say make e remain for prison, while im defence don ask for am to dey released on bail today.
E dey entirely up to di judge to decide di length of time e go serve, but di two charges wey dme find Combs guilty of each carry a maximum sentence of up to 10 years in prison.
Prosecutor Maurene Comey don say she go push for di full 20 years. "E dey clear say di defendant pose a danger," she tok.
Dis na di most minor offences wey e dey charged wit.
Combs clap for courtroom after di verdict
Meanwhile, before dem arrive at dia decision, di jury bin deliberate for 13 hours ova three days to reach unanimous decision on top di charges against Oga Combs.
As dem bin dey read out di verdict, Oga Combs face bin dey hard to read, e just face front. Bifor then, e bin pray wit im children and hug di lawyers.
Di mood for di courtroom bin dey extremely emotional after jurors tell court say dem free Combs of di most serious charges of racketeering and sex trafficking.
Before Combs comot di courtroom, e bin knee down, put im face inside im chair and appear like say e dey pray. E bin dey shake.
Wen e get up, e look towards im family, and begin dey clap loudly as im family and supporters join am, even for di overflow room too.
E come hug im lawyer, and waka comot di courtroom for one of di last times for dis case.
Wetin be racketeering?
Racketeering conspiracy, or to direct illegal enterprise under di Racketeer Influenced and Corrupt Organizations Act (Rico), na di formal name for di charge.
Dem create di law to tackle mob bosses, but dem don since use am for oda trials, wey include sex trafficking – like di case against disgraced R&B singer R Kelly.
Dem also dey sometimes use am against a group of defendants. US President Donald Trump and im allies bin chop accuse say dem conspire to overturn di 2020 election results for Georgia - charges wey Trump deny.
To convict Mr Combs on top dis charge, prosecutors bin need to prove say e use im loyal network of associates to operate a criminal enterprise to commit crimes wey include sex trafficking, kidnapping, drugging and obstruction of justice.
For dis case, dat network go include im employees, wey prosecutors argue say play part in setting up di "freak-offs" for di centre of di case.
Key witnesses bin testify of prolonged sexual encounters plus dem dey forced to have sex wit male escorts for di presence of di rapper.
During one raid on im Los Angeles mansion, police discover supplies wey dem say dem wan use for di freak-offs, including drugs plus more dan 1,000 bottles of baby oil.
Why jury free Diddy of racketeering?
Di legal team of Oga Comb go likely see im acquittal on di most serious charge of racketeering as a big win.
Im lawyers bin undermine di allegation wen dem ask witnesses weda Oga Combs employees ever witness di freak-offs.
Cassie Ventura, di star witness for di prosecution, tok say she no tink say dem dey present.
Defence lawyers bin argue say dem no fit consider di case as racketeering if members of Oga Combs staff no dey involved.
Robert Mintz, one criminal defence lawyer and former federal prosecutor, bin don tell BBC say di racketeering charge go be di most challenging one for prosecutors to prove to a jury.
To gain conviction, lawyers bin need to prove say Combs establish co-ordinated plan between am and at least one oda pesin to commit at least two crimes ova a span of several years, Oga Mintz tok.
Wen dem go sentence Diddy?
Dem go sentence Oga Combs at a later hearing - Judge tArun Subramanian neva set di date yet.
While di rapper dey face a maximum sentence of 10 years, e go dey up to di judge to decide di length of time e go ultimately serve.