You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Jury reach partial verdict for Sean 'Diddy' Combs sex-trafficking trial
Di jury don reach partial verdict during di second day of deliberations for Sean "Diddy" Combs's criminal trial.
Dem reach verdict on four of di five counts Combs dey face, but dem dey unable to reach verdict on racketeering conspiracy charge.
If dem convict am on di racketeering charge, Combs fit spend di rest of im life for prison.
Di five count counts wey di ogbonge music tycoon dey face na:
- Racketeering conspiracy
- Sex trafficking of Cassie Ventura
- Transportation for prostitution of Ventura and odas
- Sex trafficking of Jane
- Transportation for prostitution of Jane and odas
Combs don deny all charges. Di jury say dem don reach verdict on all except di first charge.
Di 12-member jury bin hear from 34 witnesses ova nearly two months, wey include ex-girlfriends, former employees of Combs, male escorts and federal agents.
How long Diddy fit spend for jail if dem find am guilty?
Di jury no fit agree on di first charge, wey come wit di steepest possible sentence. If dem convict am on di racketeering charge, Combs fit spend di rest of im life for prison.
E dey face anoda statutory minimum sentence of 15 years if dem find am guilty of sex trafficking.
Transportation for purposes of prostitution dey carry maximum sentence of 10 years.
Meanwhile, di jury don finish for di day afta dem reach verdicts in four out of di five counts against Combs.
Dis one mean say dem go continue tomorrow to consider di first count, wia disagreement bin dey among di 12 jurors.
Court go resume on Wednesday 2 July by 0900 ET (1400 BST).
How dem select di jurors?
Di court bin examine plenty potential jurors.
Di process bin include potential jurors wey look through one long list of places and pipo wey dem fit mention during trial, wit names like Kanye West and Kid Cudi.
Di "Pipo and Places" list long well-well wey make Judge Subramanian tok say im "feel like say im dey read one appendix for Lord of the Rings".
Potential jurors also gatz fill out questionnaires wey ask weda dem get "views about hip hop artists" or "feelings concerning violence, sexual assault".
Di judge remind di court several times of di importance of choosing fair and impartial jury.
Nearly all di potential jurors don read news reports of di allegations for di case and many of dem don see footage of wia Oga Combs kick im former girlfriend Cassie Ventura for one hotel hallway.
Authorities hold Oga Combs for di Metropolitan Detention Center for Brooklyn, New York, since im arrest on 16 September 2024.
Critics describe di prison as overcrowded and understaffed, and say e get culture of violence.