You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why singing dey good for di health?
- Author, David Cox
- Read am in 7 mins
Time don reach to hear carols wey go dey play all arund as choir pipo dey waka up and down to spread Christmas cheer but even as dem dey sing out loud, dem no know say dem dey take style help dia own life.
From di brain to di heart, dem don find out say singing get plenti benefits for pipo wey dey do am, most especially if dem dey do am in groups.
E fit draw pipo to dey closer, prepare our bodi to fight diseases and e even dey supress pain.
Alex Street wey be researcher for di Cambridge Institute for Music Therapy Research tok say "singing na cognitive, physical, emotional and social act".
Di Cambridge Institute for Music Therapy Research dey study how music dey help pikin and adults to recover from brain injuries.
Psychologists don shock about how pipo wey dey sing togeda fit connect, even if di vocalists no really wan do am.
Research don show say even complete strangers go fit connect deeply afta dem sing togeda for one hour.
Wetin no fit dey surprising be say e get physical benefits for di lungs and respiratory system from singing.
Some researchers dey use singing to help pipo wit lung diseases, for instance.
Good vibrations
But singing also get oda physical effects. Dem find out say e dey improve pipo heart rate and blood pressure. Singing for groups or for choir don dey found to ginger our immune function for ways wey you no fit get if you just dey listen to di music.
Plenti explanations dey for dis one. Biologically, di thinking be say singing dey activate di vagus nerve wey directly dey connected to di vocal cords and muscles for di back of di throat.
Di long breathing and controlled out wey dem dey use sing dey release endorphins wey dey linked wit pleasure, wellbeing and di suppression of pain.
Singing also dey activate broad network of neurons for both sides of di brain wey dey light up di region of di brain wey dey deal wit language, movement and emotion.
Dis, togeda wit di focus on breathing wey singing need, make am beta stress reliever.
Street tok say, "di 'feel-good' responses dey clear for di brighter sounding voices, facial expressions and postures".
Oda deep reasons fit dey for dis benefits.
Some anthropologists believe say our hominid ancestors bin dey sing even bifor dem fit tok, dem bin dey vocalise tins to sound like how nature dey sound and also to express how dem dey feel.
E fit don play rile to how social dynamics dey develip, expession of emtions and rituals and Street say no be mistake say singing tirn to part of human being life weda di pesin sabi music or not. Street note say our brains and body don dey tuned to respond well to song.
E tok say, "Dem dey sing Lullabies for pikin and den songs dey for funerals. We learn tines table wit chanting and dem teach us ABC wit di rhythmic and melodic structure".
Come togeda
All singing no dey benefit pipo di same way.
Singing for choir, for instance, dey found say e dey promote greater level of psychological wellbeing dan for pipo wey dey sing alone.
Dis na di reason why educational researchers don use singing as tool to promote cooperation, language development and emotional regulation for pikin dem.
Pipo wey don benefit from singing di most na pipo wey get respiratory wahala.
Dis mata na wetin don turn to major research focus for Keir Philip wey be clinical lecturer for di respiratory medicine for Imperial College for London. Philip don warn say no be singing wey go cure pipo wey get dis diseases but e be beta addition wit western medicine to help di mata.
Philip tok say, "for some pipo, wey dey live wit breathlessness, e fit make dem change how dem dey take breathe to dey irregular and inefficient.
Some kain singing fit help dis wit di muscles wey dey used, di rhythm and di deep breathing wey dey help to improve symptoms".
One of im most ghen ghen studies na di breathing programme wey im develop wit professional singers for di English National Opera and use am for trial to treat long Covid patients.
In six weeks, di results show say e improve dia quality of life and reduce some of dia breathing wahala.
Wetin fit be di most ogbonge benefit of singing be say e be like e dey help di brain repair imself from damage.
Medical specialists dey turn singing as way to improve quality of life for pipo wey get differnet kain health issues.
Around di world, researchers don stidy di effects of joining community choirs wey dem form for cancer and stroke survivors, for pipo wey get Parkinson's disease and dementia, and di pipo wey dey take care of dem.
For example, singing dey dey improve di abilty of Parkinson's patients to tok well, sometin wey dem dey lose as di disease dey spread.
Singing also represent way of boosting general health as e dey shown as underrated exercise like even to waka.
Adam Lewis wey be associate professor for respiratory physiotherapy of di University of Southampton tok say, "singing na physcal activity and fit get parallel benefots to wetin exercise dey do".
One study even suggest say singing togeda wit di vocal exercises wey trained singers dey use to hone pitch and rhythm be like exercise for di heat and lungs like how e be to waka and moderate pace.
But researchers dey ginger to highlight di benefits of group singing for pipo wey get ong tern chronic sickness.
Street explain say singing dey allow dem to focus on wetin dey fit do, and not on wetin dem no fit do.
Street say, "e dey make evribodi equal for di room, e be wia caregivers fit no be careivers and di healthcare practitioners fit dey sing di same song for di same way, e no really get anytin wey dey do dat."
Evri breath wey you take
Singing no dey witout risk for pipo wey get heath conditions.
Group singing bin dey linked wit superspreading Covid-19 for di early stages of di pandemic as singing fit comot large amounts of airborne virus.
Di way singing be like e dey help wit brain repair like wit former US Congresswoman Gabrielle Giffords wey bin survive wen dem shoot am for head for 2011.
Ova many years, Giffords bin relearn to waka, tok, read and write, as therapists bin dey use her childhood to help regain di way she dey tok.
Researchers don use dat kain scope to help stroke survivours to fit tok again.
Dis na sake of say wen pesin dey sing e fit do di hours and hours of repeating words wey dey needed to promote new connections between di two brain hemispheres, wey dey normally scata for acute stroke.
Thinking also dey say singing dey ginger brain neuroplasticity wey be wetin dey allow di brain to rewire imself and create new neurological networks.
Theories dey say singig fit help pipo wey dey suffer from cognitive decline bicos of di work wey singing dey force di brain to do.
E dey also require sustained attention and stimulating word finding and verbal memory.
Teppo Särkämö wey be professor of neuropsychology for di University of Helsinki say, "dia be gradually growing evidence for di cognitive benefits of singing for older adults. We still know tiny tin about wetin singing fit do to slow or prevent cognitive decline as dis go need large scale studies wit years of follow up."
For Street, all research about wetin singing fit do weda for social or neurochemical level show why e dey part of human life.
One of im concerns na say as pipo dey spend more time to click wit technology more dan pipo wit activities like singing, few pipo dey feel di benefits.
E tok say, "plenti tins dey we still dey discover especially for rehabilitation from brain injury.
Di studies just start to dey come wey show di effects singing fit get even for pipo wey get significant injury.
E make sense say we fit benefit well-well from am becos singing don play ogbonge role to connect communities."
E fit just add to why make we gada round Christmas tree to sing carols dis year.