You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Time dey run out for remaining five sisters wey bandits kidnap for Abuja
One crowdfunding campaign dey currently shele on X to raise moni for five sisters wey bandits bin kidnap wit dia papa for Abuja on 2 January. Di bandits later release di papa, Mansoor Al-Kadriyar, make im go hustle moni for ransom payment.
Na six sisters di bandits bin kidnap, but one of dem, Nabeeha Al-Kadriyar, don die. Di bandits kill her sake of say di family no raise enough moni for di ransom on time.
Now, di family get less dan 72 hours to hustle N100 million - N20 million for each of di five sisters wey still dey alive. Dis moni dey even higher dan di N60 million wey di bandits bin request. And di new deadline na Wednesday, 17 January.
Adamu Asiya, wey be family member of di abducted sisters, tell BBC say life don become hell for di family.
Asiya follow for di pipo wey dey coordinate di crowdfunding for social media, and na she di family authorise to tok to di media ontpp di mata.
She tok say di mama of di sisters don cry sotey tears no dey comot for her eyes again.
"She just dey dia now dey hope say somtin fit happun make her children regain freedom. She don take am as di will of Allah," Asiya tok.
Di five sisters wey still dey for di bandits hand na: Najeebah Al-Kadriyar - wey be graduate of Ahmadu Bello University, Zaria; Nadheerah Al-Kadriyar - wey dey 300 level for di same university; Adeebah Al-Kadriyar; Aneesah Al-Kadriyar, and Mardiyah Al-Kadriyar.
End of Di one wey oda users dey read well well
Tori wey come out on Monday also tok say bandits don kill some of di victims wey dem kidnap for Sagwari Estate, Dutse, Abuja on 7 January, to force dia families to raise moni for ransom.
BBC Pidgin neva confirm dis tori. Di tok tok person of di FCT Police, Josephine Adeh, say she no go fit tok about di mata "for security reasons".
As e be, pipo dey plan to hold protest for Abuja, Kaduna and oda parts of Northern Nigeria to call on goment to do more to end kidnapping.
Date and venue of di planned protest neva come out yet so dat security operatives no go fit stop am.
But one young man wey im name for X na Sarkin Mota don already begin im own solo protest on top di mata.
Declare kidnapping emergency - AI
On Monday, Amnesty International Nigeria been issue statetment telling Nigeria President Bola Ahmed Tinubu make he declare kidnapping an emergency for di country.
Isa Sanusi wey be di group Director for Nigeria tok say "pipo for Nigeria dey live on knife edge... as armed groups dey tighten dia stranglehold on di country".
"Di current epidemic of kidnappings don show di failure of di Nigerian authorities to protect lives.
Under International Human Rights Law and Nigeria constitution, di authorities get obligation to protect lives and properties of everibodi without discrimination. Di Nigeria authorities must to investigate di plenty kidnapping and killings and bring di pipo responsible to justice," Isa Sanusi tok.
As insecurity for Nigeria continue to dey rise, many Nigerians dey wonder why goment neva make good dia promise of using new technology take fight am.
For 2014, di National Identity Management Commission (NIMC) bin introduce di National Identity Number (NIN) wey, according to goment, suppose help in tackling insecurity.
Evri sim card suppose dey connected to NIN and security personnel fit use dis NIN to track activities of criminals. But so far, e no look like say dis strategy don yield any beta result.
Former Minister of Communications and Digital Economy, Isa Pantami, for one post on im X handle, tok say di "NIN-SIM policy dey work...but na lack of utilisation by di relevant institutions wey dey fight insecurity be di problem".
Pantami tok say im no know why security operatives no dey use di policy to pursue criminals.
"Wen I dey office, I know three instances where dem utilise di policy and e lead to di success of dia operations. On why dem no dey use di policy now, I dey worried pass anybodi," e tok.
Ransom - To pay or not to pay
Di Nigerian Senate bin amend di terrorism prevention law for April 2022, including one clause wey tok say payment of ransom to kidnappers go dey illegal, and anybodi wey pay ransom fit spend 15 years for prison.
Di lawmakers argue say e go "discourage as kidnapping and abduction for ransom take dey rise for Nigeria", but many Nigerians no gree.
"Payment of ransom no be di problem here, na kidnapping be di problem," Imran Rufai, wey bandits kidnap im brother for inside di Abuja-Kaduna train attack of March 2022, tell BBC dat time.
However, di clause wey criminalise ransom payment no later make am into di version of di terrorism prevention bill signed into law by President Muhammadu Buhari for May 2022.
According to one report by SBM Intelligence for August last year, kidnappers demand ova ₦5 billion in ransom payments from Nigerians between June 2022 and June 2023, but na only around ₦302 million pipo pay.