You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wetin we know about Nabeeha and her sisters wey bandits kidnap for Abuja
Police authorities confam say dem don deploy rescue team wey go bring back di six sisters of one Al-Kadriyar family.
Di Nigeria Police force on Sunday, 14 January tok say dem don deploy tactical intelligence team to rescue six sisters of Al-Kadriyar family wey bandits kidnap for dia residential house for Bwari area of Abuja, di kontri capital on Tuesday, 2 January.
Olumuyiwa Adejobi, tok-tok pesin of di Nigeria Police Force for inside one statement e post on X, assure Nigerians say security agencies dey on top of di mata.
“Di force headquarters dey diligently coordinate efforts to address dis and prevent any further occurrence, as all hands dey on deck to rescue di victims."
“However, di sensitivity of di situation necessitates discretion, and as a result, we go keep specific details confidential to avoid compromising ongoing operations,” police tok.
Dis development dey come afta hastag #Najeebahandsisters begin trend on social media. Some Nigerians bin enta social media to alert security authorities of di sisters situation and also beg for dia immediate rescue, afta tori of dia kidnap by bandits plus di death of one of dem go viral.
According to reports, bandits kill Nabeeha Al-Kadriyar, one of di six children of Alhaji Mansoor Al-Kadriyar, days afta dem attack and kidnap she and her sisters for dia house
Initially, bandits bin demand N60m ransom from di Al-Kadriyar family to release all six of dia pikin but increase am to N100m, one of di relative tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
On 3 January, one X handle @Adamu_Asiya_, wey identify herself as di sisters cousin bin post on X (former Twitter) say dem don kidnap Alhaji Mansoor and im six daughters for dia house on Tuesday night.
“Abeg make una pray for my sisters and uncle wen you see dis. Dem kidnap Najeebah, her sisters plus dia papa for dia house last night. We don lose one," she tok.
Last week, bandits release dia papa make im go find di ransom of N60m ($62,714), wey be N10m for one pikin before dem go fit release all six girls.
Who be Nabeeha and her sisters ?
Nabeeha na graduate of biological science, while Najeebah na graduate of Quantity Surveying from Ahmadu Bello University and Nadheeerah na 300 level student of Zology of di same institution .
Di oda three sisters na Adeebah, Aneesah, and Mardiyah Al-Kadriyar.
Nabeeha and her sister wey hail from Ilorin, Kwara State, north-central Nigeria bin travel wit dia family go Abuja for di holidays. Nabeeha na di second child of di family and di family dey look forward to dia convocation on 27 January.
On 2 January, bandits attack di family of Alhaji Mansoor Al-Kadriyar for dia family house for Bwari Area of Abuja and kidnap Alhaji Mansoor and im six daughters.
However, bandits kill dia uncle, Abdulfatah Al-Kadriyar alongside police officials wey lead di operation to rescue di family.
Al-Kadriyar beg for ransom as bandits increase ransom from N60m to N100m
Di family of Al-Kadariya announce di death of Nabeeha Al-Kadariya on social media media.
One of dia cousin, Osama Al-Kadariya on Sunday, 14 January for im Facebook page tok say di bandits don increase di ransom from N60m to N100m and dem don give dem 17 January as ultimatum make dem pay di money but dem still dey negotiate wit di bandits.
Osama call on Nigerians to support dem raise di ransom for di freedom of Al-Kadariya sisters
“As we dey wait any communication from di remaining kidnappers, we request make una pray for di safe release of our loved ones,” Al-Kadariya family tok.
“Di initial ransom of 60 million Naira dem don increase am to 100 million naira as of di 13th of January, 2024, one day afta di deadline. Meanwhile, negotiations still dey go on regarding di new ransom. Di new ultimatum na by Wednesday 17th of January, 2024.
“To support di effort in securing dia freedom, we dey beg for financial assistance.”
Politicians, NGOS, Netizens react to di kidnap of #Najeebahandsisters
Many Nigerians on social media don begin trend di hashtag #Najeebahandhersisters as dem condemn di death of Nabeeba plus di kidnapping situation for Nigeria. Dem also call on security agencies to help rescue di remaining sisters.
Human Rights Group, Amnesty International Nigeria, don express dia concerns ova di failure of di Nigeria authority to stop kidnapping for ransom.
Di organisation wey dey make reference to Al-Kadriyar sisters kidnap for dia social media page tok say gunmen kidnap dia papa and im six pikin on di night of 2 January and dem dey demand for N60m ransom, afta dem release dia pap make im go look for di money.
Similarly, Atiku Abubakar, former vice-president of Nigeria, sympathise wit di family ova di death of Nabeeha Al-Kadriyar wey bandits kill for dia custody.
Oga Abubakar explain say dis na reminder say kidnappers still dey operate for secret di kontri, as im add say di security structure need to guarantee safety of lives and property.
Abubakar Kyari, minister of Agriculture and Food Security send im condolence to di family of di deceased.
Di minister tok say dem dey wish for di return of di sisters and believe say security operatives go conduct investigation to ensure dia safe return.
Oda ogbonge Nigerians like former Senate Bukola Saraki, Bahir Ahmad, among odas also condemn di killing of Nabeeba and kidnapping generally.
Oga Saraki urge authorities to work tirelessly to ensure di safe and swift return of di remaining children.