Dembele goal give PSG slim 1-0 advantage ahead of Champions league semi-final second leg against Arsenal

scenes from the game

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dembele bin score inside di first few minutes for PSG
Read am in 12 mins

Despite Arsenal pressure for di second half of di champions league semifinal first leg, PSG don carry 0-1 advantage dey enta di second leg for Paris.

Ousmane Dembele im early goal mean say PSG now bin beat Arsenal for di first time for UEFA competitions.

Mikel Arteta na di first pesin to admit say im team gat chances to score but dem no fit to use dem.

For di end of di game, na so both teams get chances wit Goncalo Ramos and Martinelli but dem no fit to find di net.

Mikel Merino tink say im equalize afta halftime afta in header enta di net from Declan Rice im cross but afta VAR don check, dem cancel di call.

Arsenal gat all to play for if dem travel to France next week, na so PSG go use dia home advantage to progress to di final.

But las las di game for ground go decide. We go dey dia

Second half

FULL TIME

Refree don blow whistle to end di game. Arsenal go hope to beat PSG for dia home in Paris if dem gat to reach di final.

90+4 Arsenal freekick no trouble di PSG defense. Referee blow whistle for foul

CHAAAANCE! Arsenal bin get anoda clean chance but Nwanieri pass di ball to Martinelli bifor im smash di ball ova di bar

Arsenal dey try to pepper di PSG area

5+ minutes dem carry add for dis game.

90" Captain Odegaard don dey comot for Nwanieri.

87" Arsenal get freekick for dangerous area but Rice im shot don hit pipo inside di box.

84" CHAAAANCE! Goncalo Ramos tink say im score but im chip don hit di post.

Arsenal bin dey comot Timber wia Ben white dey enta park.

78" Arsenal don score goal for each of dia last 11 games, dem fit to find dat goal for hia?

CHAAANCE! Arsenal lose di ball for dia atrea bifor Joao Neves hit one hot ova di bar

76" CHAAAANCE! Saka dey offside as im shoot for tight angel; di keeper im first pole

75" Goncalo Ramos don enta di game to replace Desire Duoe.

74" Di time don dey go, Arsenal dey under pressure to score, but PSG also bin dey put pepper

73" Kvaratskeilia don try one ball from di center as im see say Raya comot im box, but dat ball comot di park, ova di bar.

72" Dunnarumma don comot wia im catch one ball ova di top from Arsenal.

PSG don dey comot Dembele; Barcola don enta di game.

69" PSG get freekick as Dembele don win di foul.

67" Arsenal go try to make some changes for dis game but who dey di bench wia go fit turn di game around?

65" Kvartaskeilia don come back to defend for di PSG area as Arsenal dey try to create chance to score.

64" Arsenal bin win throw aas Joao Neves bin hit di ball outside

63" Di game don open now, both teams dey play dia game wia Arsenal dey try ti score

61" Di midfield don hard well well, Neves don dey break di Arsenal attacks, bifor Dembele almost reach one thru ball.

60" William Saliba don clear one ball for di last minute as Hakimi don dey try to shoot for goal.

59" Doue bin dey try to create sometin for PSG as im dey hold di ball to allow im teammates enta di area.

57" Saka tink say im win freekick for di PSG box as im dey try to shoot but referee say no foul. Na promising attack for arsenal be dat one.

Na di keepers make dis game remain like dis so far wit dia saves.

55" CHAAAAANCE! Arsenal miss anoda chanace, Trossard tink say im score from one counter attack but Dunnarumma don carry fingertip save di ball.

54" di tension for dis game don dey rise for di second half

53" PSG now dey try to enta di Arsenal box wit di ball but Arsenal bion clear wia dem try to counter

So far Arsenal bin dey create all di chances for dis second half so far.

51" Kiwior bin shoot from distance into di PSG box but di ball deflect wia di chance spoil.

Anoda foul and freekick for Arsenal for di Arsenal area.

50" Arsenal tink say dem get early goal but VAR say neva.

Afa di VAR check dem cancel di Arsenal goal. OFFSIDE! So di sciore remain 0-1

Referee dey listen for im ears if dis goal gat to stand. Dem bin dey hint of offside

GOOOOOAAAAAAAL! Arsenal don score from di freekick. Mikel Merino don head di ball from Rice into di net. 1-1

46" Arsenal alreadi dey try to create sometin from di restart. Ref give Arsenal freekick for dangerous area afta Joao Neves foul Merino

45" Di players don comot di dressing room wia dem enta di park. We gat ogbonge 45 minutes for hia

First half

Already PSG bin lose to Arsenal 2-0 for di group phase of di champions league but dis na different wahala.

Arsenal gat all to play for di second half. Remember di tori say Arsenal neva lose to PSG for di european competition; na dis go be di first time? Make we see wetin go happun.

45" Referee don blow whistle for halftime.

44" CHAAAANCE! Martinelli don reach di ball inside di box; Martinelli gat to score from dia but Dunnarumma don save im shot.

Di game don hot well well.

43" Yellow card to Hakimi for foul on Julian Timber.

Mikel Arteta no happy about dat foul and yellow card.

42" Yellow Card to Bukayo Saka as im boot di ball away afta refree bin blow whistle form foul

CHAAAANCE! David Raya don hit anoda long ball for di back, di ball don fall to one player wia cut am back but di final ball don weak wia PSG keeper don catch am.

40" As di game don dey approach halftime, Arsenal don dey create chance afta chance.

39" CHAAANCE! sAKA don clip one ball inside di box for Martinelli, but di Brazil player no fit to stretch to get di ball.

Saka bin get one chance to dribble two players but im shot na weak shot for PSG keeper

38" No penalty. Referee wave play on,wia di game don kontinu.

36" Odegaard hit di freekick but Kvaratskeilia clear am, but as di ball enta di box again Joao neves bin contact Merino bifor im fall for ground. Arsenal players bin dey shout penalty.

35" Joao Neves don cause freekick for dangerous position, Arsenal fit to take advantage?

34"Desire Doue try to enta di box to dribble but im slip na so Arsenal collectdi ball bifor Ruiz foulSaka.

32" Di pressure don dey on top Arsenal; dem collect one ball from PSG but Fabian Ruiz don win di ball back bifor Martinelli bin foul am.

30" CHAAAAANCE! Arsenal keeper David Raya don save Desire Doue im shot bifor Fabian try to hit di rebound back into di net, na so im hit di post.

29" Tins don cool down small for di park, as Arsenal bin dey try to find di equalizer

28" Arsenal bin try to play di ball for di back, wey im nearly fall dia hand. But di defenders don clear

26" Trossard try to cross one ball for di box to im team pkayer but PSG keeper don catch am.

CHAAANCE! Kvaratskeilia gat one chance afta Hakimi carry di ball run enta di Arsenal area but Raya don catch im shot.

25" Arsenal keeper don fly one ball to Martinelli but di Brazilian don enta di offside trap.

24" Arsenal begin to dey enta di game proper wit some chances hia and dia.

23" Odegaard play di freekick into di box, na so Kiwior head am to di goalkeeper wit no power. Di chance don vanish be dat.

22" Arsenal dey try wit Saka; im cross into di box no reach any Arsenal player, but dem win freekick in front of di PSG box.

20" Arsenal try to create sometin as Rice don hold di ball wia im pass one long ball to Odegaard, but Merino and Martinelli don cross each oda for di box wey di chance spoil.

18" Julian Timber don foul Kvaratskeilia again, di PSG players don dey pepper di ref to show di yellow card.

17" Arsenal don dey try to play di long ball to Saka but im no fit collect dat kind ball, PSG gat di ball now

16" Julian Timber don foul Kvaratskeilia, di ref don dey tok to di player

15" Kvaratskeilia don fall inside di box as im dey try to dribble two defenders, di referee say no foul.

Arsenal manager Arteta eye don red for di touchline as im begin dey shout instructions to di players.

14" Fans for di stadium bin dey shout say make di referee show Marquinhos yellow card for one foul dia but di ref comot eye.

13" CHAAANCE! Marquinhos don head one cross to goal, but David Raya don catch am simple.

12" PSG don win corner as Timber block one ball from Kvaratskeilia

So far na PSG dey control di game, Timber don foul Kvaratskeilia.

11" Dembele bin dey worry Arsenal so far, anytime im get di ball, di Arsenal players no fit to mark am.

10" Yellow card to Trossard as di Belgium player bin pull Hakimi im short for di counter.

9" Merino bin head di ball from di corner but PSG don clear am, wey dem begin to counter

Arsenal don win corner. Di first corner for dis game. Dem fit to score from here? make we see

8" Arsenal don dey pass di ball for dia own yard, wey dey carry pressure put dia keeper top

Dis na long night of dootball for di emirates stadium.

6" PSG bin dey try to create anoda chance, afta Arsenal lose di ball for di midfield.

Arsenal don shock by dat goal, Rice bin dey tok im teammates say make dem relax

4" Dembele begin dat attack wey im finish am with im left foot afta Kvaratskeilia bin crtoss di ball from di left wing inside di Arsenal box.

3" GOOOOOOOOAAAAAALLL PSG don score early goal. Na Ousmane Dembele hammer dat ball from one cross

Merino don foul PSG player for midfield, referee blow whistle.

2" PSG keeper collect one ball for di back wey im don begin to play from di back.

Pressure don alreadi start; di players dey scata di passes.

PSG try to move forward alreadi but di referee blwo whistle for throw for Arsenal.

1" Referee don blow whistle for di match to start; PSG don pass di ball for middle

Saka and Dembele

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Both Arsenal and PSG neva win di champions league bifor, na so dem go try to make history

Di players don dey observe one-minute silence to respect di pope wey die last week.

Na who go carry advantage enta di second lef?

Make una join us for dis ogbonge game.

Arsenal don dey wear dia usual red and white jersey, na so di visitors PSG don dey wear dia navy blue jersey.

Both players already bin dey on top di pitch.

Welcome yard pipo to dis commentary for di champions leagie semi-final first leg between Arsenal and PSG.

Arsenal don announce dia lineup for dis ogbonge semifinal game wit Paris Saint Germain.

Di English club neva make any change except Thomas Partey wey dey suspended for di game.

Coach Arteta wia tok say dem go need all di fans for di emirates stadium for dis game select

Raya (GK), Timber, Saliba, Kiwior, Lewis-Skelly, Rice, Odegaard, Merino, Saka, Trossard, Martinelli

For PSG dem also bin start with dia strong lineup.

Donnarumma (GK); Hakimi, Marquinhos, Pacho, Nuno Mendes, Joao Neves, Vitinha, Fabian, Douè, Dembèlè, Kvaratskeilia

Na time go tell who go win dis game ahead of di second leg for Paris.

Di match go soon start...

Background

Dis na make-or-break for Arsenal as dem dey try to win di champions league trophy for di first time in history.

Especially afta dem don lose out on di premier league trophy for di third season in a row.

Liverpool bin win di league wit four games to di end of di season, na so many Arsenal fans say dem need to save dia season by winning di champions league.

Sabi pipo bin tok say dis be di best chance for di gunners to win di cup.

But dem get to first jump ova Paris Saint Germain (PSG) wey also bin win di French league.

Foto from arsenal v PSG

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Arsenal bin sama PSG 2-0 for di group phase of di UCL but dis semifinal games na different tin

Wetin you need to know about dis game

Arsenal bin reach di semifinal afta dem trash Real Madrid 5-1 on aggregate home and away for di quarterfinals.

Dis na di first time di gunners reach di semifinals since dem last reach di semifinals for 2009 wia Manchester United bin defeat dem.

Dem also bin lose di 2006 final to Barcelona but dis year, opta supercomputer bin predict say Arsenal get ogbonge chance to win.

According to opta, Arsenal get 31.3% chance to win, Barcelona get 27.4% chance wia PSG na third wit 22% and Inter Milan wit 19% chance.

Afta Arsenal bin wire Real Madrid 3-0 for di Emirates, dem stretch dia unbeaten record to 17 UEFA competitions for dia home.

Di gunners already bin beat PSG for di league phase of di champions league dis season 2-0.

For PSG, dem neva win for dia last five competitive games against Arsenal (D3 L2), but PSG go hope say dia wins against Liverpool and Aston Villa dis season go give dem level.

Dem defeat di English team 5-4 on aggregate to reach dis semifinals.

PSG also bin get more experience for dis stage of di competition as dem bin reach di semifinals four times for di last six seasons.

Di two teams na di only teams wia neva win di trophy - na so dem go try to create history.

But only one of di two teams go enta di final.

Luis Enrique

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin di two coaches and players tok

Arsenal coach Mikel Arteta tell UEFA say, "we don become one of di best teams dis season; we don overcome plenti tins wey e go be beautiful story; but we want more."

Im also confam say Mikel Merino and Ben white don return from injury wey go boost dia team.

Ghana midfielder Thomas Partey wey be key player for di gunners, go miss dis game due to suspension afta im collect yellow card for di second leg of di Madrid game.

Gabriel Martinelli wey bin score di winning goal for di Bernabeu tok say "dis club deserve to win and we get to dey involved."

"We believe say we fit to win di trophy. We bin dey play for di Europa league wen I join dis team but now, we dey for di semifinal," di Brazilian tok.

PSG coach Luis Enrique say im team get "more complete squad now" dan di time dem play wit Arsenal for di group phase of di competition

Im add say, "we be beta team now, we don show our power; PSG and Arsenal na similar teams as dem dey attack togeda and defend togeda."

PSG midfielder Vitinha dey hope say di game go sweet well well.

"We sabi Arsenal, na ogbonge team especially for set-pieces. E dey important say we go keep our head cool and focus for dis game."

Martinelli

Wia dis foto come from, Getty Images

Possible lineups

Arsenal:

Raya (GK); Timber, Saliba, Kiwior, Lewis-Skelly, Odegaard (C), Rice, Merino, Saka, Trossard, Martinelli

PSG:

Donnarumma (GK), Hakimi, Marquinhos, Pacho, Nuno Mendes, Joao Neves, Vitinha, Fabian Ruiz, Douè, Dembèlè, Kvaratskeilia

Di game go happun at 8 PM (WAT) and 7 PM (GMT) for di emirates stadium in London.

We go bring una di live text commentary of dis ogbonge game, make una join us.