Trump official visit to Saudi Arabia: Di deals, handshakes and key moments

US President Donald Trump (L) shake hand wit Saudi Crown Prince Mohammed bin Salman Al Saud (R) as e arrive Malik Khalid Airport. Trump wear suit while di Prince wear white cloth wit black overall

Wia dis foto come from, Bandar Al-Jaloud/Saudi Royal Court/Anadolu via Getty Images

Read am in 4 mins

US President Donald Trump say di US no get "a stronger partner" dan Saudi Arabia.

E tok dis wan during im first major foreign trip - a visit of Gulf countries wey mainly focus on strengthening investment for di region.

E say, “di US -Saudi relationship na bedrock of security and prosperity and by di way, e go remain dat way. We no dey go in and out like oda pipo," President Trump tok.

Day one of di trip see di two sides announce a $142bn (£107bn) arms deal, as well as oda ogbonge investments wey Saudi Arabia crown prince say fit eventually be worth $1tn.

"In addition to buying about $142billion of American-made military equipment by our great Saudi partners, di largest ever.

Dis week, we get multi -billion dollar commercial deals with Amazon, Argo, AMD, Uber, all of dem dey here."

During im trip, Trump also announce say di US go lift Syria sanctions.

All dis na US President Donald Trump first major international tour of im second term as president and e land for Saudia Arabia first.

Dis na part of im visit to Gulf states ova four days for bilateral tok.

Earlier, Saudi Arabian Crown Prince Mohammed bin Salman wey dem sabi by im initials MBS, bin welcome Trump for King Khalid airport, wit oda leaders wey follow am come.

Trump bin come down from Air Force One, with Saudi military members wey dey gidigba beside a purple carpet wey dem lay for ground for di US president.

Also, Elon Musk wey be President Trump adviser and CEO of Tesla and SpaceX, dey among plenti VIP guests wey attend di lunch wey di host kontri get for Riyadh royal court, according to di official participant list.

During di visit, di US president go attend coffee and tea service for di ceremonial blue room, lunch wit CEOs, bilateral meetings and one agreement signing, according to wetin BBC US partner, CBS News, reports.

Trump and Salman

Wia dis foto come from, Win McNamee/Getty Images

Wetin dem go tok

During dis meeting between di two kontris, e dey expected say agreement for Saudi Arabia to buy more dan $100bn of US arms and oda military equipment dey di deals wey Trump fit announce on dis trip.

Missiles, radar systems and transport aircraft also reportedly dey part of di package.

Di US na longstanding arms supplier to Saudi Arabia, but dat relationship get gbege for 2021 wen di Biden administration stop to dey sell Riyadh offensive weapons, sake of concerns about di kontri role for di war wey dey go on for Yemen.

Anoda key focus of di trip go be to secure significant new investment for di US economy.

Dis new investments for di US from Gulf states, go help Trump to show im pipo say di "America First" agenda dey bring results.

Later on, Trump go attend one Saudi-US investment forum for Riyadh wey go feature CEOs from BlackRock, Palantir, Citigroup, IBM, Qualcomm, Alphabet, and Franklin Templeton, wit effort to draw top Wall Street and Silicon Valley leaders to Saudi Arabia.

Trump go den attend one summit of Gulf leaders for di city on Wednesday, bifor e go travel to Qatar dat same day.

E go end im four-day trip for di United Arab Emirates on Friday.