Mikel Merino join Arsenal, Ugarte to Man U, footballers wey fit move bifor transfer window close?

Wia dis foto come from, Getty Images
Wit only few days to go bifor di transfer window go close for dis year. Oda players neva dey about if dia transfers go work out or not.
Di window go close by 11pm West African time on Friday, 30 August and any players wey wan move suppose waka before Friday go end.
We go torchlight some of dose players wey fit dey on di move.
Arsenal don complete di signing of Spain midfielder Mikel Merino from Real Sociedad for amount wey fit each £31.6m.
Di midfielder wey dey 28 years dey go north London on a four-year contract wit di option of anoda 12 months afta di Gunners agree to pay an initial £27.4m plus £4.2m as add-ons.
"Mikel na player wey go bring beta quality for us wit im experience and versatility," na wetin manager Mikel Arteta tok.
Merino bin dey part of di Spain squad wey win Euro 2024, and im play for all di seven matches for di tournament.
Im also score late goal for extra time against Germany for di quarter-final wey make dem win di match.
Merino na Arsenal third signing of di transfer window, afta Italy defender Riccardo Calafiori and Spain goalkeeper David Raya land for di club.
"Mikel go make our squad significantly stronger, wit im technical ability, togeda wit im strong and positive character and personality," Arteta add.
Manchester United dey close to signing midfielder Manuel Ugarte.
E go be dia fifth signing for dis transfer window afta Erik ten Hag club agree a fee of £42.3 million.
Di 23 years old Paris St- Germain deal include a potential £8.5 million as additional payments.
Im also don ready to do medical bifor im go complete di signing.
Victor Osimhen and Ivan Toney
Even though Al Ahli don send official bid of around of €65m to Napoli for Victor Osimhen according to Fabrizio Romano di Nigerian forward say e no wan go Saudi Pro league.
Chelsea eyes still dey for di African Footballer of di Year bodi, even though dem don chook leg again to get Ivan Toney from Brentford.
If Chelsea get beta fee and wages for Ivan Toney dem go seal di deal but Osimhen na di club main target.
Chelsea wan sign di Nigerian as Romelu Lukaku dey waka go anoda club for a fee wey dey around £30million.
Napoli wan let Osimhen go… but no agreement yet between Nigerian striker and Al Ahli and Chelsea.
Negotiations still dey go on on di player side, but di agreement wey dem dey consider still dey far on personal terms and conditions.
Osimhen go consider all di options in di final days… tori be say im still no dey open to loan move and im want make dem pay am im current salary full wey be €11m net.
Bifor di Saudi bid come, PSG bin don show interest for am.
Osimhen bin enjoy ogbonge success for Italy since im join Napoli from French club Lille for 2020.
Im bin score 57 goals for 96 Serie A matches and help di club win di league for 2022-23.
Chelsea don make offer to sign Brentford striker Ivan Toney. Some evidence show say di bid for dis stage wit Chelsea get long-term interest.
Di England international wey dey 28 years no wan renew im contract for Brentford.
Toney, remain di target for Al-Ahli for di Saudi Pro League bifor di transfer deadline go end on August 30.
Ademola Lookman
Arsenal and PSG dey interested in Nigerian striker, according to tori pipo Daily Express.
Di Gunners go dey hope to secure a late move for di Atalanta forward Ademola Lookman, wey dey valued at around £51m.
But tori be say, PSG already get a verbal agreement wit di 26-year-old, although tok-tok ova im transfer fee neva really get head.
Lookman wey bin score hattrick for di Europa league final neva play for im team since di league start.
Atalanta bin sign di striker for 2022 from German Bundesliga side RB Leipzig for undisclosed fee.
Raheem Sterling
Manchester United don do tok-tok to try get a deal to sign Raheem Sterling from Chelsea.
Di 29-year-old forward dey train away from di first-team squad afta being Blues manager Enzo Maresca tell am say im go struggle to get playing time for di club.
While guarantee of an agreement neva dey certain, e be like say United sporting director Dan Ashworth wanntry to see if im fit use di situation for Stamford Bridge to im club advantage.
United sources tok say any deal go dey on dia own terms, even though winger Jadon Sancho also dey available and dem know say Chelsea eye dey im bodi too.
Juventus also dey interested in Sancho but dey no wan agree wit United desire to include di obligation to buy in any loan deal, and also dem no want to pay all im wages.
Sterling, wey get 82 England caps, na childhood United fan wey dem sabi am as.
Im don spend 10 years for North West, first for Liverpool, den Manchester City, wia im win 10 major trophies bifor im join Chelsea for a £50m deal two years ago.
Lukaku, Chilwell and odas for Chelsea
Wit 42 players for Chelsea first-team squad, some big names leg dey shake.
Striker Romelu Lukaku bin rejoin Chelsea for £97.5m for 2021 but im don spend di past two seasons on loan for Inter Milan and den Roma.
Lukaku dey close to agreeing a move to Napoli wey go see am join up wit former Chelsea boss Antonio Conte.
England defender Ben Chilwell bin move from Leicester on a five-year deal for £45m for 2020 and im don play 106 games for di Blues.
"Wit Chilly, I tok say im be lovely guy, but im go struggle sake of im position. Im go struggle," Maresca tok.
Meanwhile, defender Trevoh Chalobah na anoda player wey no dey train wit di first team.
Ivan Toney
Brentford boss Thomas Frank say Ivan Toney future "no dey settled yet".
Dem drop di 28-year-old England striker for dia opening game against Crystal Palace afta dem bin turn down a £35m bid for am to join Saudi side Al-Ahli and also im bin no make di squad for dia defeat for Liverpool on Sunday.
"I hope say I no go answer many more questions like dis for future, but na so di mata be," Frank tok on Sunday. "I don already tok am bifor say if Ivan dey here, good, if im no dey, also good."
Im add on BBC Radio 5 Live say: "We go find out on Friday. We go know somtin on Friday. Evritin fit finish on Friday. All di different clubs fit come in for Ivan so make we see."
Toney don dey Brentford for di past four years and im score 20 goals in 33 Premier League games for di 2022-23 season.
Im bin miss half of last season sake of im eight months ban for breaking Football Association betting rules but return to score four goals in 17 appearances.
Toney contract go end next summer and im don dey linked wit moves to clubs like Arsenal and Chelsea bifor.
Aaron Ramsdale

Wia dis foto come from, Reuters
Goalkeeper Aaron Ramsdale bin join Arsenal from Sheffield United for £24m move for 2021 but im don lose im number one spot to Spain David Raya and veri soon im fit dey on im way out of Emirates Stadium.
Raya become first choice sake of im loan move from Brentford last season and now im don make permanent switch to di Gunners.
So far di strongest interest for Ramsdale don come from Wolves, wey don make offer to sign di 26-year-old England international for a season-long loan.
Marc Guehi
Crystal Palace don turn down four bids from Newcastle for England defender Marc Guehi, di latest one na about £65m.
Guehi, wey get two years left for im contract for Selhurst Park, dey ready to move dis summer if di option dey available.
Di centre-back bin captain Palace for two of dia opening games dis season.
Di Eagles dey reluctant to lose both of dia centre-backs afta dem sell Joachim Andersen to Fulham for a region of £30m.
Kieran Trippier
Newcastle United defender Kieran Trippier want leave di club dis month in search of first-team football.
Di 33-year-old England international na unused substitute for di Magpies 1-0 opening win against Southampton but bin comot from bench for second half of dia 1-1 draw for Bournemouth on Sunday.
Trippier, wey join di club from Atletico Madrid for 2022, dey behind former Saints full-back Tino Livramento for di order for di right-back position.
Newcastle bin block Trippier from leaving di club for January following interest from Bayern Munich and one club for Saudi Arabia.
Trippier dey linked wit a move to Everton to reunite wit Sean Dyche, wey bin manage am for three years for Burnley.
Speaking on Friday, Newcastle boss Eddie Howe say: "My wish na make im stay hia and kotinu to play for us."
Jarrad Branthwaite
Everton dey keen to keep hold of dia 22-year-old centre-back - but di transfer 'noise' around am dey veri loud.
Di Toffees don already reject two bids from Manchester United for Jarrad Branthwaite earlier dis summer, di Old Trafford club don since sign Matthijs de Ligt from Bayern Munich.
E get plenty oda teams wey dey as ready to move though, di latest link na from dia city rivals Liverpool.
Scott McTominay and Jadon Sancho
More high-profile players fit leave Manchester United dis week.
Jadon Sancho fit don return back to Manchester United, following last season falling out wit manager Erik ten Hag and subsequent loan move to Borussia Dortmund, but di question na for how long?
Di winger bin no dey involved for United opener against Fulham and im no make di squad for di defeat for Brighton on Saturday.
Wit a number of injured players still to return, im bin dey wonder how many opportunities im go get, Chelsea, Barcelona and Juventus all dey linked wit making a move.
Meanwhile, midfielder Scott McTominay fit move to Napoli, di Serie A side don agree a fee for di Scotland international.
Joao Cancelo
One man wey fit dey on di move from Premier League champions Manchester City na full-back Joao Cancelo.
Di Portugal international bin go out on loan to Bayern Munich for di second half of di 2022-23 season afta falling out of favour for City. Im den spend di whole of last season on loan for Barcelona.
Reports don link Cancelo wit move to one club for Saudi Arabia, although City boss Pep Guardiola confam last week say di club dey yet to receive any enquiries.
"Im dey train wit us, yes. Maybe im go stay, maybe im go go on loan. Im love to play football and train. We go see," Guardiola tok.









