Dricus du Plessis vs Israel Adesanya UFC fight start anoda Nigeria and South Africa rivalry

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigerians and South Africans don kontinu to banter sake of di Ultimate Fighting Championship (UFC) wey happun between Du Plessis of South Africa and Israel Adesanya of Nigeria early mor-mor on Sunday.
Wetin dey cause di current banter wey dey trend on social media na say Du Plessis beat Isreal Adesanya to retain im UFC title.
Nigeria and South Africa na ogbonge rivals for many areas especially for combat sports and football.
Di rivalry wey don also enta politics, business and di entertainment industry no be like wetin go end anytime soon.
Bodi dey sweet South Africans say Dricus du Plessis beat Israel Adesanya for di fourth round of di ogbonge contest to retain im middleweight title for di UFC 305 for Perth, Australia.
Dis dey come afta UFC tweet say Dricus Du Plessis na di champion as e defend im title.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
As South Africans dey drag Nigerians for social media, some Nigerians dey express mixed feeling.
While some Nigerians dey para say Israel lose di fight odas still dey celebrate di Nigerian star.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
How Israel Adesanya lose to Dricus Plessis

Wia dis foto come from, Getty Images
Di South African, wey dey 30, shake Nigeria-born New Zealander Adesanya wit a right hook bifor im drag am down to get a rear-naked choke.
Following di contest, Du Plessis pay tribute to Adesanya as di two of dem settle dia differences afta oneheated build-up wey makeplentimpipo tok about di fight.
"To share dis octagon wit a legend... dis man don done so much for dis sport and I' dey really sorry e con be like say across I bin disrespect am, na come from Africa - ino be my intention at all. Tonight Africa won regardless," Du Plessis tok.
"Na honour for me to share dis cage wit a legend like dat. I get di utmost respect for am, an ultimate warrior. Believe me, I no want make dat man kick me again."
Di contest bin see a bitter build-up afta Du Plessis say im be di "first real African champion", as im clarify say im dey live for di continent while former champions Adesanya, Kamaru Usman (both born in Nigeria) and Francis Ngannou, wey grew up for Cameroon bifor e relocate to France, bin move go anoda place..
Du Plessis, wey join UFC for 2020, win di title off Sean Strickland for January and bin dey make di first defence of im belt.
Meanwhile former UFC middleweight champion Adesanya, bin dey fight for di first time in 11 months afta im bin take break from di sport, sake of mental and physical tiredness wen im contest for five title bouts inside 16 months.
Di two fighter bin look relaxed as dem dey go di octagon as Adesanya dance into di RAC arena.
Meanwhile Du Plessis, waka come outside wit Springbok greats Eben Etzebeth and Siya Kolisi, afta South Africa beat Australia 30-12 for Perth di previous day.
For di first round di two fighters find success as Adesanya avoid Du Plessis' blitzes forward as im land a crunch right hook for im bodi, di South African respond wit leg kicks.
Du Plessis use im wrestling for di second round, as e bring Adesanya down three times.
Di two-time champion begin to defend submission attempts well as im regain im feet.
Di momentum den shift to Adesanya favour as repeated hooks to di bodi make Du Plessis start to breathe heavily, wit one eye-catching elbow wey be di highlight of plenti strikes.
But di South African get di final say as im make Adesanya stagger two times wit two hooks for di fourth round, bifor im finish di contest for ground.
I no dey go anywia - Adesanya

Wia dis foto come from, Getty Images
Afta di fight di two give respect to each oda, dem embrace and shake hands afta plenti tok-tok bifor Adesanya raise Du Plessis' hand to signify im victory.
"I bin dey fight one of, if not di greatest striker eva for dis division, I need dat takedown well-well. For dis level e dey hard to keep pipo down and dis man na di king of getting back up," Du Plessis tok.
"I tok say I go come hia to die for dis belt and I dey alive right now and na bonus for me. And I bin tok say I go kill pesin if I need to. Luckily we no need to do any of dos tins. See me hia, still champion, baby."
Meanwhile, Adesanya, wey failed for im attempt to become di first eva three-time UFC middleweight champion, say im go come back, even though im get back to back defeats for di first time for im MMA career.
"I dey disappointed in mysef but at di same time I dey proud. Dis na di best I don eva feel, di best I bin don eva look, I just fight di man wey beta pass me for di night and I give am respect for dat," Adesanya tok.
"I know say all of una want to see me down and want to see me lose but watch dis - I no dey go anywia."
For di fights wey happun earlier Scotland-born Australian Casey O'Neill beat Luana Santos from Brazil by unanimous decision to end di two-fight losing streak.
O'Neill dey 26 years and pipo dey celebrate as im dey copy Australian breakdancer Rachael Gunn style from di Paris Olympics.
Gunn - wey dem sabi as B-girl Raygun - go viral during di Games earlier dis month and she bin tok say di criticism wey she don receivefor her performance dey veri "devastating".
Meanwhile, videos don showface, external of Georgian bantamweight Merab Dvalishvili dey confront heckler for one event for Las Vegas on Friday.
Di video footage show as Dvalishvili, wey dey challenge American Sean O'Malley for di title for UFC 306 next month, jump di railing, im waka up some stairs towards di fan and grab im head, bifor security pipo carry am comot.
Oda times Nigeria and South Africa dey kwanta
Many times Nigeria and South Africa dey jam heads for tins like sports, entertainment, di list don include beauty pageant now.
Recently South Africans bin raise dia voice as Home Affairs for South Africa release preliminary findings on Chidimma Adetshina citizenship
Dem chook eye sotay Chidimma Adetshina withdraw from Miss South Africa 2024 pageant afta citizenship controversy
Now Chidimma Adetshina go participate for Miss Universe Nigeria afta controversy with Miss South Africa
Anoda recent dragging happun for Women's football when Nigeria beat South Africa to keep Paris 2024 Olympics dream alive
For men's football Nigeria and South Africa jam for bin happun for di 2023 Africa Cup of Nations wey shele for Cote d'Ivoire early 2024.
South Africa lose as Nigeria enta Afcon final afta epic semi-final match wit South Africa
Dem also jam for di 2026 Fifa World cup qualifier wey Draw wit South Africa dim Nigeria 2026 World Cup hope










