How Noni Madueke hattrick and Cole Palmer assist help Chelsea waya Wolves 6-2

Joao Felix score for Chelsea

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Dis na Joao Felix first goal for Chelsea since dem buy am
Read am in 8 mins

Noni Madueke score hattrick from similar position for Chelsea as dem waya Wolves 6-2.

Cole Palmer do three correct assists for Madueke to put di Blues for comfortable lead ova Wolverhampton Wanderers for dia second Premier League game.

Dis na good day for Chelsea as Wolves no get chance to level di score wey make di Blues move up go for di EPL table.

Cole Palmer and Noni Madueke give very brilliant performance for di game wit correct positioning.

Madueke hat-trick give Chelsea dia first Premier League victory of di season.

Chelsea bin take di lead afta 98 seconds wen Cole Palmer corner touch Matheus Cunha and reach Nicolas Jackson wey nod am for di back of di post.

Rayan Ait-Nouri run to set up Cunha and di Brazilian equalise for Wolves wit a finish from inside di box.

Palmer den restore Chelsea lead wit a shot from 30 yards wen e see say Wolves goalkeeper Jose Sa dey off im line.

Wolves get demsef back for di second time shortly bifor di end of di second half wen Jorgen Strand Larsen shoot from di edge of di six-yard box afta one free-kick come from across goal.

Howeva, England Under-21 forward Madueke three goals settle di game for di Blues.

For di 80th minutes, Joao Felix score im first goal for Chelsea afta a good assist from Neto wey find for di center of di box.

One correct outside shot from Mario jnr bin give Wolves hope but e dey disallowed afta referee find say one player dey offside for inside Chelsea box.

Gusto and Palmer chop yellow card for middle of di game.

Wolves don move down di bottom of di Premier League table.

How Wolves vs Chelsea take waka

Wolves 2 - 6 Chelsea

FINAL WHISTLE

90+8mins- Wolves fans don run comot for stadium

90+6mins- Both teams in search of goals wey fit still make dia fan happy.

Eight Minutes added time

90mins- Felix stiil looking for more goals for di Blues fron di front

86mins- Lemina wit a great run wit di ball, looking for im teammate, but e lose di ball

SUBSTITUTION

Neto give correct assist for Felix to find di net

Wolves 2 - 6 Chelsea

80mins- Joao Felix score first goal for Chelsea

GOOAALLL

80mins- Ball back in play.

79mins- OFFSIDE position by Lemina

Madueke, Palmer and Enzo celebrating goal

Wia dis foto come from, Getty Images

GOAL DISSALOWED

78mins- What a great shot by Mario jnr, great strike

77mins- Lemina wit di ball, finding an assist. Oh, Fofan stop am. Free kick for Wolves

SUBSTITUTION: Caicedo off,

Dis na anoda Palmer-Madueke link up wit di two winger finding space on di right. Wolves go always rememba dis goals as dem dey similar

72mins-

YELLOW CARD - Mosquera and Cucurella chop yellow card

69mins- Fofana in a quick rofor-rofor afta Mosquera give challenge

67mins- Chelsea don take control since di second half as Wolves dey try find diasef for di pitch

65mins- Very brilliant assist by Cole Palmer wey dey always find Madueke from di side and di two dey corporate well

63mins- Noni Madueke score for Chelsea again

GOOAALL

62mins- Good assist from Cole Palmer, find Noni Madueke

60mins- Chelsea dey strong from di middle and dem no dey give

Wolves 2 - 4 Chelsea

57mins- Madueke score again for Chelsea

GOOAALL

55mins- Great moves by Wolves, Lemina from di corner side, try a long shot but blocked by di defenders

51mins- Chelsea dey lead again. A quick free-kick wen Cole Palmer find Noni Madueke for di overlap and di shot deflect from goalkeeper Rayan Ait-Nouri and e enta

49mins- Madueke score for Chelsea

GOOAALL

47mins- Enzo and Cucurella wan dey cook some skills for di line side but Wolves players no gree. And dat na foul for Chelsea

Pedro Neto is in. Im get a warm ovation from di Wolves fans afta e enta for Chelsea.

46mins- Di match is back and di two teams dey find goals

SECOND HALF begins

Strand Larsen score for Wolves

Wia dis foto come from, Getty Images

FIRST HALF Ends

Dis na hot game

45+6mins - Jorgen Strand Larsen equalise for Wolves. Na good ball from Rayan Ait-Nouri and Toti Gomes nod am it back across goal and a good little finish from Strand Larsen.

Wolves 2 vs 2 Chelsea

Wolves don equalise oooo

GOOAALL

Corner for Chelsea. Trying to find more goals bifor di first half end

6+mins Added Time

Wolves 1 vs 2 Chelsea

44mins- Cole Palmer score for di Blues

GOAALLL

Palmer dey complain and e chop yellow card and di referee don warn am

YELLOW CARD for Cole Palmer

42mins- What a great chance for Wolves. Dis Cunha just miss a ball wey for be di second goal for Wolves

40mins- Cunha play di free kick for Wolves but e go ova di bar

39mins- YELLOW CARD for Gusto

38mins - Rayan Ait-Nouri gatz dey careful now wey be say e dey on yellow card and e no go wan comot for Wolves yet

31mins- Nicolas Jackson don dey get so much strenght to move wit di ball but Wolves defenders no gree

28mins- Chelsea moving wit fast speed to find goal again, Palmer get di ball, move wit a run but no for so long as di ball comot for im leg

Small gbege wan happun as Jackson dey vex but di referee don settle am. Di goal no be offside

Wolves 1 - 1 Chelsea

What a goal by Cunha for Wolves afta an impressive run and positioning

GOOOAALLL

23mins- What a tackle from Lemina against Chelsea player. Wolves dey find one goal for dia home to catch Chelsea by surprise

21mins- Mosquera putting di ball on di run for Wolves to find a gola wey go help dem equalise against Chelsea

19mins- Mudryk trying to find Madueke from di oda end of di pitch.

Corner for Chelsea

Dis match dey hot as both team dey find strong goal

17mins- Great shot by Madueke, but goalkeeper bock am. E no go through

15mins- What a goal by Cunha for di Wolves but e dey offside. referee cancel di goal

OFFSIDE

14mins - Strand Larsen trying to create chances from di back wit great moves. Toti take a long chance for Wolves but too long

13mins- Serious battle for Chelsea defence. Oh Colwill clear di ball go corner

10mins- Palmer get di ball, try some skills but e no go through. E no lose di ball. Counter for Wolves

What A Miss! Correct corner from Wolves but e no enta post.

7mins- Corner for Wolves Dem fit convert am to goal like Chelsea?

5mins - Wolves players dey strong for dis early half and dem gatz stay togeda

3mins- Wolves dey try settle dia defence line as Chelsea dey push dem back

Wolves 0 - 1 Chelsea

Nicolas Jackson give Chelsea di early lead.

GOOAALLL

Mudryk and Madueke dey try create chances for front of Wolves post

1mins- Di two teams dey ready to play correct football but na who win go decide.

Game don start oooooooooo

0mins - Di two teams don line-up.

FIRST HALF

Chelsea go face Wolverhampton Wanderers for dia second Premier League game today Sunday 25 August, 2024.

Di Blues go visit Molineux Stadium wia Wolves go host dem for dia home.

Wolves vs Chelsea: Who dey squad

Wolves XI: Sa, Doherty, Mosquera, Toti, Ait-Nouri, Lemina, Joao Gomes, Cunha, Hwang, Bellegarde, Strand Larsen

Subs: Bentley, Bueno, Traore, Podence, Dawson, Gomes, Doyle, Sarabia, Guedes

Chelsea XI: Sanchez, Gusto, Colwill, Fofana, Cucurella, Caicedo, Fernandez, Madueke, Palmer, Mudryk, Jackson

Subs: Jorgensen, Adarabioyo, Badiashile, Neto, Felix, Nkunku, Dewsbury-Hall, Guiu, Veiga

Jackson score for Chelsea

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Jackson score

Team news

Wolverhampton Wanderers boss Gary O'Neil no get any new fitness issues as dem await Chelsea visit.

Nelson Semedo go miss out sake of suspension, while Leon Chiwome, Sasa Kalajdzic and Enso Gonzalez remain long-term players wey go dey absent.

Chelsea new signing Joao Felix go dey available to play, even head coach Enzo Maresca neva decide whether di Portugal player go start from di first half.

Reece James dey serve di third game of four-match suspension wey dem sama am afta dem send am off for di end of last season.

Match facts

Chelsea

Wia dis foto come from, Getty Images

Head-to-head

Wolverhampton Wanderers don win di past three Premier League meetings, as many as dem play for ida previous 17 attempts (Draw 4, Lose 10).

Chelsea neva get any away win for four league games against Wolves since dia 5-2 victory for September 2019 under Frank Lampard (Draw 1, Lose 3).

Di Blues last win ova Wolves bin come for Stamford Bridge for October 2022 wit goals from Kai Havertz, Christian Pulisic and Armando Broja.

Wolverhampton Wanderers

Wolves don lose four successive Premier League games for di first time since dia run of six from May to August 2021.

Dem don win only one of dia last 12 competitive matches for all competitions since dia 2-1 top-flight home victory against Luton for April (Draw 2, Lose9).

Wolves no get any English player for dia line-up against Arsenal and dis na di first time wey e go happun for Premier League fixture.

Rayan Ait-Nouri wey be 23 years and 80 days fit become di youngest player to make 100 Premier League appearances for Wolves. Di record wey Pedro Neto of Chelsea dey currently hold.

Chelsea

If dem no defeat dia opponent, Chelsea fit lose dia opening two games of one league season for di first time since 1973-1974.

Enzo Maresca fit become di first Chelsea manager to lose first two top-flight fixtures for di club since Gianluca Vialli lose di first three for 1998.

Di Blues don fail to keep one clean sheet for any of dia last 18 away games for all competitions since dia 2-0 Premier League win for Fulham last October.

Goal for Pedro Neto go make am just di fourth player to net one Premier League goal for and against Wolves, afta Stephen Hunt, Diogo Jota and Morgan Gibbs-White.

Wit Chelsea over 40 players for dia squad, e never clear who and who go play as di club manager, Enzo Maresca don tok say make some of im team members go find club to join as dem no be part of im plan for di blues.