Ten new stars you suppose watch out for as Premier League new season dey start

Wia dis foto come from, Getty Images
Di new Premier League season don almost reach and as we know say many familiar faces go return to our TV screens, some new players dey wey go also dey hope to make dia mark for di competition for di first time.
Some clubs, like Chelsea don dey busier dan odas for di transfer window as dem dey build up for di 2024-25 season.
BBC Sport don pick out 10 players who fit catch pipo eyes for di top flight of English football.
Riccardo Calafiori, Arsenal (defender)

Wia dis foto come from, Getty Images
Arsenal go try again to beat Manchester City and win di Premier League title dis season, and dem don strengthen dia defensive options wit di signing of Italy defender Riccardo Calafiori.
Di 22-year-old bin complete im £42m move from Bologna for di end of July.
Di versatile left-footer bin join di Serie A side for £3.3m last summer but e quickly become one of dia key players.
E also begin draw interests from big clubs for Europe afta e show imsef wella for di Euro 2024 campaign for Italy, even though di team no too do well for di competition.
Joshua Zirkzee, Manchester United (forward)

Wia dis foto come from, Getty Images
Anoda new arrival to di Premier League from Bologna na Netherlands striker Joshua Zirkzee wey join Manchester United for deal wey worth £36.54m.
Di former Bayern Munich player bin score 12 goals for 37 matches for Italy last season and e don already collect jersey number 11 for di Red Devils for dis coming season.
Savinho, Manchester City (forward)

Wia dis foto come from, Getty Images
Manchester City bin pay £30m to sign di Brazil winger, Savinho from Troyes for France, dis July.
Di 20-year-old do veri well wen e go on loan to Girona for Spain last season, and dem finish for third position for La Liga.
E play im first match for Brazil against England for March dis year, and e don play anoda six times for im kontri.
City director of football Txiki Begiristain tok say: "E get big role to play for Manchester City dis season and beyond. We get total confidence for im ability."
Niclas Fullkrug, West Ham (striker)

Wia dis foto come from, Getty Images
Di new coach for West Ham, Julen Lopetegui, don sign several players as e dey try to reshape di side for dis coming season, but di best so far fit be Niclas Fullkrug.
Di 31-year-old Germany striker bin join di Hammers from Borussia Dortmund for £27m.
E score 15 goals for 46 matches for 2023-24 and finish as im team reach di Champions League final wia dem lose to Real Madrid.
Fulkrug also score two times for Germany even though e no start even one match for di tournament wia di host kontri bin comot for di quarter-final stage.
Daichi Kamada, Crystal Palace (midfielder)

Wia dis foto come from, Getty Images
Crystal Palace new coach Oliver Glasner sign Japan midfielder Daichi Kamada from Lazio for Italy on a free transfer.
Di 27-year-old bin don play under Glasner for Eintracht Frankfurt, wia both of dem win di Europa League togeda for 2022.
Kamada don play 33 times for im Kontri. E also don score 40 goals and get 33 assists for di 179 times wey im play for Frankfurt bifor e go Lazio.
Lucas Bergvall, Tottenham (midfielder)

Wia dis foto come from, Getty Images
Tottenham don invest for youthful players wit di signing of two 18-year-olds Lucas Bergvall and Archie Gray, but na Lucas wey don show say e fit enta starting 11 for di new season sake of im outings for pre-season.
Di midfielder bin join Spurs from Sweden club Djurgarden for a fee wey almost reach £8.5m.
E show im creativity and ball control wen e enta as half-time substitute against Bayern Munich for one pre-season friendly match wey Tottenham bin lose 2-1.
Jake O'Brien, Everton (defender)

Wia dis foto come from, Getty Images
Jake O'Brien dey return to di Premier League afta di former Crystal Palace defender join Everton from Ligue 1 side Lyon dis summer.
Di Republic of Ireland international bin no make any league appearance for Palace but e dey come back to England wit plenty top-flight experience afta e play 27 matches for France last season.
E go hope to follow in di footsteps of im new teammate Jarrad Branthwaite wey enjoy good first Premier League campaign last season afta im too bin play small abroad.
Nikola Milenkovic, Nottingham Forest (defender)

Wia dis foto come from, Getty Images
Nottingham Forest bin fight veri hard to avoid relegation last season, so e no dey surprising to see say dem don dey make dia defence stronger wit di signing of Serbia international Nikola Milenkovic.
Di 26-year-old join dem from Italian side Fiorentina, wia e don play 264 matches, and score 17 goals.
Milenkovic get 56 caps for Serbia and e play for all of dia Group C games for Euro 2024, including di 1-0 defeat by England.
Liam Delap, Ipswich (striker)

Wia dis foto come from, Getty Images
Ipswich dey start dia first season back for di Premier League afta back-to-back promotions, and dem go dey hope on dia new signings to deliver so dem no go enta relegation again.
Dem don buy di striker Liam Delap from Manchester City for deal wey worth up to £20m.
Di 21-year-old bin don make two Premier League appearances wen e dey Man City bifor dem loan am go di Championship. Now e go dey determined to make im mark for di top flight dis term.
Dean Huijsen, Bournemouth (defender)

Wia dis foto come from, Getty Images
Bournemouth don put moni for dis exciting young defender, Dean Huijsen, from Italian giants Juventus.
Di 19-year-old bin join for an initial moni of £12.8m, and im na di fourth signing for Bournemouth dis season afta e arrive on 30 July.
Huijsen bin make 13 appearances on loan for Roma for di second half of last season.










