Manchester City make history to win 23/24 Premier League title

Wia dis foto come from, Getty Images
For di fourth consecutive time in a row Manchester City don win di Premier League title.
Man City fans troop out to di field to celebrate dia win. Dis na anoda big win for di coach.
Di incredible win by Manchester City to beat West Ham 3-1 for Etihad Stadium make dem become di first team to win di English Premier League title four seasons in a row.
Phil Foden put Pep Guardiola team ahead for just two minutes into di game. Man City bin really need di early win to dey sure say dem hold off Arsenal.
Foden add anoda goal bifor di break and although Mohammed Kudus pull one sweet goal for net for West Ham.
Midfielder Rodri score to put di City ahead of West Ham wit two goals. Im fire shot from di edge of di area afta 59 minutes.
Man City bin enta small gbege wit West Ham wen a second goal bin enta net. Unfortunately for West Ham, VAR bin rule out dia second goal sake of say na handball.

Wia dis foto come from, Getty Images
Pipo no too doubt dia victory.
End of Di one wey oda users dey read well well
City get 19 wins and four draws since dia last defeat for di league at Aston Villa on 6 December.
City don win six out of di past seven Premier League titles. Last season, dem join Huddersfield, Arsenal, Liverpool and Manchester United, twice, to win di top flight three years in a row.
Now Guardiola team don set big history wey neva happun for di entire time wey di English league dey formed for 1888- 136 years ago.
On 25 May, dem go wan win a domestic Double in successive seasons wen dem go face Manchester United for di FA Cup final at Wembley.

Wia dis foto come from, Getty Images
Chelsea
Chelsea hang on to victory. Dem go play for European football - but dem gatz wait to see which kain competition dem go play for- afta di FA Cup final.
Newcastle
Newcastle go go European football but na only if Manchester City win di FA Cup final.
Man City 3 vs 1 West Ham

Wia dis foto come from, Getty Images
Man City 3 vs 1 West Ham
FULL-TIME
Incredible game at di second half and both teams really try but Man City get upper hand pass West Ham.
5Mins Added Time
90mins- Man City dey edge to victory.
86mins- David Moyes make im final change as West Ham manager as Danny Ings replace Lucas Paqueta.
SUBSTITUTION
85mins- Anoda miss from Erling Haaland. Im nods wide from Kevin de Bruyne corner. Im go still win di Golden Boot shaa.
83mins- West Ham replace Michail Antonio wit teenager George Earthy. Na Earthy bin score last weekend against Luton.
SUBSTITUTION
79mins- West Ham United neva get a shot or a single touch inside Man City box for di second half.
Edson Alvarez neva too tey for di game as im go foul Bernardo Silva. Alvarez chop yellow card.
YELLOW CARD
75mins- Di entire Etihad stadium dey filled wit joy as di two teams dey battle am out but winnr know diasef.
73mins- Di game kontinu as di two teams dey try score more goals.
72mins- VAR check for one foul wey no too clear- but dem no give any penalty.
70mins-Nathan Ake replace Manuel Akanji for City. West Ham bring on Edson Alvarez for Emerson Palmieri.
SUBSTITUTION
65mins- Dis game dey hot pass wetin Man City expect but West Ham still dey find goal
Man City 3 vs 1 West Ham
60mins- Haaland go still win di Golden Boot but be like say im don leave im shooting boots for house. Kurt Zouma block Haaland shot and e no fit head in di resulting corner.
Rodri score for Man City to make am 3-1
GOAL!
55mins- Man city dey apply serious pressure for West Ham.
50mins- Similar to im first goal, Phil Foden get di ball, enta di yard and shoot - but dis one dey too wide of di far post.
He'll get more chances for his hat-trick.
48mins- Erling Haaland and Phil Foden no get shots in but Kevin de Bruyne does, wit im 20-yard first-timer going just wide of di bottom corner.
SECOND HALF Begins
Man City 2 vs 1 West Ham
HALF-TIME
Such an incredible play for both sides today. But di two teams gatz do wetin dem fit do.
4mins Added Time
44mins- Di hope of West Ham to equalise don dey grow as dem dey fire from left right and center.
42mins- Kudus score for West Ham. Dia hope dey come back alive
GOAL!
40min- di game dey hot oooooo.
30mins- City defender Manuel Akanji no too try as im allow dat ooo from just outside di box but Alphonse Areola make im sixth save of digame.
Seven save now as di keeper make a wonderful diving stop to deny Kevin de Bruyne anoda goal effort.
27mins- Erling Haaland dey one yard out for front of wey be empty net but im no sabi score.
Konstantinos Mavropanos put Haaland off from Bernardo Silva ball wey go across di box and and Haaland shoot am wide.
Foden wey eye Hat-tricktry anoda shot but di keeper save am.
25mins- Kevin de Bruyne pick out Erling Haaland, as Haaland try to cut inside Konstantinos Mavropanos to shoot but di West Ham defender just take am off di toe.
20mins- Foden dey squeeze all dis West Ham players
Doku drop correct pass for Phil Foden and e score gently.
Man City 2 vs 0 West Ham
18mins- GOOOOOAAALLLLLLL
16mins- Oh damn ! Man City for dey fear by now Emerson Palmieri charge forward for West Ham. But im just run and e no carry di ball wit am.
10mins- Man City dey try control di midfield well well and dem no wan gree make West Ham get chance at dia post.
4mins- Manchester City dey very comfortable. Kevin de Bruyne dey try drop some display for di opponent.
2mins- Di game just start and Foden don put goal for West Ham net afta smashing from 18 yards.
2mins- GOOAAAAAALLL. Incredible strike by Phil Foden
0mins- Di game don start. E go determine how di teams go end for di League table

Wia dis foto come from, Getty Images
Arsenal 2 vs 1 Everton
Arsenal 2 vs 1 Everton
FULL-TIME
92mins- Game kontinuuu.
90mins- Kai Havertz put in di goal for Arsenal
E no dey enough for di title but surely Kai Havertz don win di game for Arsenal.Di Gunners win di ball for midfield, Martin Odegaard knock am past Jordan Pickford and Havertz slam from close range.
GOAL
87mins- omas Soucek bundle in from close range. But na wit im hand.
VAR surely rule am out. No be goal
GOAL CANCELLED
80mins- Arsenal still dey push but Gabriel Jesus shot dey deflected wide.
77mins- Dis game no wan take a new turn ooo.
75mins Everton send on Portuguese teenager Youssef Chermiti for Dominic Calvert-Lewin wey go play front.
SUBSTITUTION
72mins- Di changes by Arsenal neva convert into anytin as dem kontinuu to dey drive di ball round di field.
70mins- Arsenal bring on Jurrien Timber, wey play for di first and last Premier League games of di season but no play di 36 in between.
Dis na im return from a nearly season-long knee injury. Emile Smith Rowe dey on too. Thomas Partey and Ben White are off.
SUBSTITUTION
68mins- Arsenal defender Jurrien Timber enta Dwight McNeil and get a deserved yellow card. A bit rusty.
YELLOW CARD
65mins- Dis game suppose decide alot of tins for di Gunners but be like say anytin wey happun for here no get any effect.
60mins- Arsenal lose centre-back Gabriel to injury. Left-back Oleksandr Zinchenko don come on and Takehiro Tomiyasu go into di middle.
SUBSTITUTION
58mins- Yellow cards for James Tarkowski, a few minutes ago, and now Abdoulaye Doucoure don collect sake of di foul on Gabriel for Everton.
YELLOW CARD
56mins- Kai Havertz head wide from Gabriel Martinelli cross. Dat for be goal for Arsenal.
Havertz outjump James Tarkowski in di air but could not get im effort on target.
50mins- Arsenal dey try put pressure so dem go fit stay ahead of Everton.
SECOND HALF Begins
Arsenal 1 vs 1 Everton
HALF-TIME
Di struggle really dey real for both sides. But for Arsenal, a win go bring back dia hope for di title race if Man City lose.
48mins- Thomas Partey shoot ova for Arsenal.
43mins- Increidble goal by Takehiro Tomiyasu. Arsenal no dey behind for long as Takehiro Tomiyasu drill home first-time from about 16 yards out from a cutback.
GOAL!
42mins- Arsenal go dey hope for a miracle to happun
40mins- Idrissa Gueye score for Everton
GOOOAAAALLL
40mins- Game kontinuuuu
Arsenal 0 vs 0 Everton
YELLOW CARD
39mins- Arsenal midfielder Thomas Partey chop yellow card for di foul against Dwight McNeil. Everton dey see di more now.
36mins- Gabriel Martinelli of Arsenal dey down holding his knee and dem try check am. James Tarkowski win di ball wit a good sliding tackle for di box but im don injure.
20mins- Di Gunners dey try all dia efforts to find goal but e neva come.
18mins- Gabriel dey down afta take free kick for face from Calvert-Lewin. E don stand up, play kontinuu
15mins- Martin Odegaard give correct crossing wey find Leandro Trossard for di back post. Im try to play across goal but Seamus Coleman deflect am go di di wrong way and Jordan Pickford stop am so e no go be own goal.
10mins- Declan Rice try long shot from 16 yards but di shot dey weak Jordan Pickford save am.
7mins- Arsenal go gatz try to do dia job and hope West Ham do dem a favour.
4mins- Di Emirates no too get shout afta dem hear say Phil Foden don score for di rival Man City.
2mins- Chance for Arsenal as Declan Rice swing in a cross as Gabriel and Takehiro Tomiyasu no give di ball better heading.
0mins- Di game don kick start
Ongoing Games

Wia dis foto come from, Getty Images
Full-Time- Chelsea 2-1 Bournemouth
(Caicedo 17mins, Sterling 48mins) - (Badiashile 49mins own goal)
Full-Time- Brighton 0-2 Man Utd
Full-Time- Liverpool 2-0 Wolves
Alexis Mac Allister nod di ball into di far corner to score for Liverpool.
Full-Time- Brentford 2-4 Newcastle.
GOAL- Harvey Barnes score for 21 mins.
Full-Time- Crystal Palace 5-0 Aston Villa
Full-Time- Sheffield United 0-3 Tottenham













