Kontris wey record deaths in 2022 monkeypox outbreak

Wia dis foto come from, Getty Images
Brazil and Spain don report dia first monkeypox deaths.
One 41-year-old man for Brazil become di first pesinto die from di virus outside Africa.
Spain also announce dia own first death soon afta, dis na di first for Europe.
Na just Last week, World Health Organization (WHO) bin declare di monkeypox outbreak a global health emergency.
But infections dey usually mild and di risk to di general population dey low.
Monkeypox cases for Brazil
So far Brazil don report 1,066 confirmed cases and 513 suspected cases of di virus.
Data from Brazil health ministry show say more than 98% of dia confirmed cases na men wey dem do kerewa wit men.
Monkeypox cases for Spain
Shortly after Brazil announce dia death, Spain health ministry confirm Europe first death from di virus.
End of Di one wey oda users dey read well well
For inside report, dem say out of 3,750 monkeypox patients wit available information, dem don hospitalize 120 or 3.2% and one don die.
Dem no give further information about di victim.
Monkeypox death in India
India don confirm first death from monkeypox insidde di southern state of Kerala.
22-year-old man, wey be recently travel to di state from United Arab Emirates, died on Saturday.
Kerala Health Minister Veena Georgesay di man bin first test positive for di virus abroad.
Samples wey dem im death also detect di virus, she tok on Monday.
Dis na di fourth monkeypox death reported globally, outside of Africa.
Ghana confirm first death from Monkeypox
Monkeypox kill one pesin in de Upper East Region of di kontri.
Dis be di first monkeypox death case since di outbreak of di virus in June dis year.
According to Health officials, di patient report to di Upper East Regional Hospital with history of fever and skin rash.
Na on July 26, 2022 di patient die, but GHS only get confirmation from Noguchi Memorial Institute for Medical Research on July 28 afta samples dem send test positive for monkeypox.
Monkeypox global cases
According to di Centres for Disease Control and Prevention, na at least 21,148 cases dem don report worldwide.
Di monkeypox virus na member of di same family of viruses as smallpox, although e dey much less severe and experts say chances of infection dey low.
E dey occurs mostly in remote parts of central and west African kontries, near tropical rainforests.
Health officials dey recommend pipo wey dey at highest risk of exposure to di virus make dem offer dem vaccine – di pipo wey dey tok about na some gay and bisexual men, as well as some healthcare workers.
US goment don declare di monkeypox outbreak a public health emergency following spike in cases.
Di decision go speed up di distribution of vaccines, treatments and federal resources to control di spread of di virus.
Cases don pass 6,600 inside di US, according to health officials.
E dey come less dan two weeks after di World Health Organization (WHO) issue dia highest emergency alert following a worldwide increase in cases.
Last week, WHO director general Dr Tedros Adhanom Ghebreyesus say declaring di outbreak a global health emergency go help speed up di development of vaccines and di implementation of measures to limit di spread of di virus.
Dr Tedros say di risk of monkeypox dey moderate globally, but high for Europe.

Wia dis foto come from, Reuters
How to Protect yourself against Monkeypox
Even though health experts agree say di risks to di public dey low, see several tins you fit do to reduce your risk of catching di virus.
Dis recommendations na from U.S. Centers for Disease Control and Prevention, U.K. National Health Service and WHO wey include:
- Avoid contact wit pipo wey recently get di virus or those wey fit dey infected.
- Wear face mask if you dey in close contact wit someone wey get symptoms.
- Use condom and shine ur eye for symptoms if you recently change your sexual partner.
- Avoid contact wit animals wey fit carry di virus. Dis include sick or dead animals and particularly those wit history of di infection, like monkey, rodents and prairie dogs.
- Practice good hand hygiene, especially afta you come in contact wit infected — or suspected infected — animals or humans.
- For example, wash your hands wit soap and water or use an alcohol-based hand sanitizer.
- Use personal protective equipment wen you dey care for patients wit confirmed or suspected monkeypox infection.
- Only eat meat wey dem cook well-well.
By Fiona Equere, Daniel Semeniworima











