Firefighters quench ogbonge fire for Ilupeju afta 10 hours of aggressive operation

Fire for plastic industry Ilupeju

E take about 10 hours of serious firefighting to quench di ogbonge fire wey catch for Ilupeju area of Lagos, Southwest Nigeria.

Di fire start for one plastic factory as early as 06:00am (local time), dat na early mor-mor on Saturday, according to eye witnesses.

Di Lagos state fire rescue service say na around 07:26hours local time dem receive emergency alert.

For post wey dem make on X @LagosRescue say dem deploy dia Ilupeju, Bolade, and Alausa Fire Stations go di scene for di firefighting operations.

Di fire burn down di factory and badly affect oda surrounding buildings as thick smoke cover di area.

Di Lagos fire rescue service say apart from di plastic factory, di storage and factory sections of one oda petrochemical company also dey affected as dem dey battle di fire.

“5:12 pm, FIRE OFF, as operational strategy shift to dampening down, to commence mopping exercise,” na so di service tok.

Di estimation show say na about 10hours dem use battle wit di fire.

Dis incident dey happun few days afta fire bin burn IBIS hotel for airport road for inside di state.

Ilupeju fire

Wia dis foto come from, Lagos Fire Service/X

Ilepeju fire incident
Ilupeju fire incident
Skip Facebook post
Allow Facebook content?

Dis article contain content wey Facebook provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Facebook cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of Facebook post

Ilupeju fire incident
Fire for Ilupeju

We dey update dis tori