Macron name Sébastien Lecornu as new French PM

Sébastien Lecornu, who has dark hair and is wearing a dark suit, smiles as he looks off to the side while standing next to French President Emmanuel Macron, who is also smiling and wearing a dark suit.

Wia dis foto come from, EPA/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Sébastien Lecornu (L) has served as armed forces minister for the past three years
Read am in 3 mins

President Emmanuel Macron don name im close ally Sébastien Lecornu as di new French prime minister, 24 hours afta one vote of confidence overthrow François Bayrou as di head of im govment.

39-year-old Lecornu, dey among di favourites to take ova di job. E spend di past three years as armed forces minister, wit focus on France response to Russia war in Ukraine.

For inside one statement, di Elysée Palace tok say di work wey dem give an na to consult wit political parties wit di aim of adopting France's next budget.

Earlier, Bayrou bin visit di president to hand ova im resignation, e pave way for Lecornu to become di fifth prime minister of Macron second term as president.

Lecornu go face di same challenges as im predecessor, wey include make e get cost-cutting budget pass parliament without a majority.

France get rising public debt, wey hit €3.3tn (£2.8tn) earlier dis year and dat represent 114% of di kontri economic output or GDP.

Bayrou bin propose €44bn in budget cuts, and im decision to put im plans to a vote of confidence no for ever work.. In di end, France National Assembly decide to remove im govment by 364 votes to 194.

Parties for both di left and right don condemn Lecornu appointment, wey be indication of di difficulties e go face.

Jean-Luc Mélenchon of di radical left France Unbowed tok say, im appointment mean say nothing don change and time don reach for Macron departure from presidency.

On di far right, Marine Le Pen tok say di president dey fire "di final cartridge of Macronism, from im bunker along wit im little circle of loyalists".

However, centrist former Prime Minister Édouard Philippe tink say Lecornu na good choice, as e don learn a lot as defence minister.

"I don know am for a long time bicos e dey elected like me for Normandy," di Horizons party leader tell TF1 TV. " E know how to debate and e go need dis talent for debate and listening to find a deal in circumstances e know say dey very complicated."

Anoda centrist, Marc Fesneau from di MoDem party of ousted Prime Minister François Bayrou, don call on every political force to reach compromise - "for di stability of di kontri and for dia recovery, especially dia budget".

On Friday, di credit agency Fitch go reassess France debts and dem fit make dia borrowing costs higher if dem lower dia rating from AA-.

More immediately, one grassroots movement wey di name na Bloquons Tout - "Let's Block Everything" – dey plan widespread anti-government protests on Wednesday, 10 September and authorities dey plan to deploy 80,000 police.