Kamala Harris pick Tim Walz as her running mate

Wia dis foto come from, Getty Images/Reuters
Vice President Kamala Harris wey be di nominee for di Democratic Party don announce Tim Walz as her running mate.
Tim Walz na di govnor of Minnesota and im go be her running mate for di US presidential election.
Mr Walz na battle-tested leader wey serve 12 years for Congress bifor becoming govnor for 2018.
E gain national attention for im strategy calling Donald Trump and JD Vance "weird".
Di 60-year-old lead Minnesota through di 2020 protests ova George Floyd death for Minneapolis
E help deploy di National Guard to help stop riots wey break out during di demonstrations.
Mr Walz serve 20 years for di National Guard, e teach high school and also work as assistant football coach.
Kamala Harris bin don already do interview wit some of di candidates wey she dey consider to be her vice for di US election.
On Sunday, di presidential nominee bin interview at least three from her shortlist wey include Govnor Josh Shapiro, Senator Mark Kelly and Govnor Tim Walz wia dem also do meetings for inside Kamala Harris Washington home.
As Mr Walz don be Harris running mate, e go begin follow her go di five-day tour to seven cities dis week wia she go begin her campaign.
Harris officially sign di form wey she use declare her candidacy for di position of di President of US. She sign di form on 27 July 2024.
Now she don pick a running mate.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Republican Donald Trump don already pick JD Vance as im running mate.
Who bin dey Kamala Harris running mate list bifor she pick Mr Walz?
Pennsylvania Governor Josh Shapiro

Wia dis foto come from, Getty Images
Pennsylvania Governor Josh Shapiro bin get high approval ratings since dem elect am for 2022.
Di govnor, wey serve as di state attorney general bifor, don work across party lines during im tenure.
Im make national headlines last year afta e quickly rebuild one collapsed bridge for Philadelphia highway. Na major political victory for any first-term govnor.
Di speedy repair bin receive plenti hailing from pipo wey see am as di perfect infrastructure mata for any potential candidate wey wan contest for 2028 presidential election.
Mark Kelly, Arizona Senator

Wia dis foto come from, Getty Images
Di former astronaut and Navy combat pilot dey strong for im stand for border issues and how e dey criticise di Biden administration. Dat fit catch di eye of voters.
Dem shoot di Democratic superstar wife Gabby Giffords for one mass shooting and dat one fit give am personal story a strong wing.
Di former House congresswoman bin dey seriously wounded and she become one of di leading voices on gun safety laws.
Wit gun violence as one major campaign issue for Democrats, Mr Kelly personal story fit go well wit voters.
Michigan Governor Gretchen Whitmer

Wia dis foto come from, Getty Images
Gretchen Whitmer na two-term govnor of Michigan, and she dey popular for di Midwest Democrat wey many pipo believe say go run for president for 2028.
She don campaign for Mr Biden in di past and she no dey shy about her political aspirations.
She tell di New York Times say she wan see Generation X president for 2028, but she stop to suggest say she fit fill dat role.
For 2022, she bin lead one campaign wey leave Michigan Democrats for control of di state lawmaker and di govnor seat.
Dat kain political control bin allow her to make some policies wey include to protect Michigan abortion access and di passage of gun safety measures.
Transportation Secretary Pete Buttigieg

Wia dis foto come from, Getty Images
E no be secret say Transportation Secretary Pete Buttigieg get presidential aspirations.
E contest for president for 2020 and im dey as one of di Biden administration best communicators.
Mr Buttigieg don manage some public crises during im time as transportation secretary.
E help to oversee di goment response to di East Palestine train derailment for Ohio, di Baltimore Bridge collapse and Southwest Airlines scheduling crisis for 2022.
Illinois Govnor JB Pritzker

Wia dis foto come from, Getty Images
JB Pritzker wey be di govnor of Illinois don raise im profile in recent years by going afta Trump and to defend Mr Biden.
Di billionaire businessman dey quick to post criticism of Trump for social media.
Afta di debate, e call Trump "liar" and say e be "34-count convicted pesin wey only care about imsef".
Like Ms Whitmer, Mr Pritzker get track record of completing agenda items for Democrats to-do lists ontop issues like abortion rights and gun control.
Oda possible candidates bin dey?
Di list of potential nominees bin dey long beyond dis Democrats, as di party don develop list of possible future presidential candidates.
Kentucky Govnor Andy Beshear, two-term Democratic govnor for a very conservative state, don earn growing national attention since im re-election last year.
Maryland Govnor Wes Moore find imsef for di spotlight in recent months afta di collapse of di Francis Scott Key Bridge for Baltimore.
Senators Amy Klobuchar and Cory Booker don contest for president for di past and get some name recognition among Democrats.
Georgia Senator Raphael Warnock, wey win one closely contested Senate race for swing state, bin also dey among dose wey dem mention as potential running mate for Kamala Harris.










