Why Police arrest and put Chris Brown for custody

Chris Brown pose on di red carpet for di IHeartRadio Music Awards. E wear one black jacket wit pink sleeves and e dey do di peace sign wit im left hand.E wear one grey hat and sunglasses.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Police arrest di American singer for one Manchester hotel afta one incident for 2023
    • Author, Catherine Murphy
    • Role, BBC News, Manchester
  • Read am in 4 mins

Dem don put R&B singer Chris Brown for custody afta e appear for court on top accuse say e use bottle attack one pesin for one London nightclub.

UK Metropolitan Police gbab di American singer for Manchester Lowry Hotel on Thursday, 15 May and dem later charge am ova alleged assault dem say happun for di Tape club for London Mayfair for 2023.

Di police allege say Chris Bron wey be 36-year-old use bottle cause serious bodily harm to music producer Abe Diaw.

"We don authorise di Metropolitan Police to charge Chris Brown wit one count of seriously bodily harm, contrary to section 18 of di Offences Against di Person Act 1861", Adele Kelly, di deputy chief crown prosecutor for CPS London North tok.

She add say "criminal proceedings against dis defendant dey active" and "e get di right to a fair trial".

Di singer bin dey Manchester ahead of one tour wey e plan to do for UK for June and July, for di city Co-Op Live Arena for Manchester and di Principality Stadium for Cardiff.

During di hearing, Brown wey wear black tracksuit bottoms and one plain t-shirt, bin confam say im full name na Christopher Maurice Brown and im also confam im date of birth.

For 2023, Oga Diaw wey follow di Sun tok bin claim say Oga Brown hit am for head wit bottle, bifor e begin punch and kick am as e lie down for ground.

E say im knee bin bend and dem gatz rush am go hospital. E add say im bin need to use crutches waka wen dem discharge am from hospital.

Fans outside court

Wen court ask am to confam im address, e say na The Lowry Hotel.

District Judge Joanne Hirst tell Brown say dem go move di case go Southwark Crown Court for London, and di next hearing go be 13 June.

She say di nature of di offence of grievous bodily harm dey too serious and e pass wetin magistrates court fit deal wit.

Fans bin gada outside Manchester Magistrates Court ahead of di hearing.

One fan, wey dey live for Manchester, tell BBC say she bin cancel her plans so she go fit spend di day outside court.

Candy, 35, say she don dey follow di star since she be 14 and wen she hear di news of im arrest she bin no fit sleep.

"I just dey here to support am," she tok.

"I love im music, im voice. Even my children don become im fans now."

Di R&B singer Brown bin rise to fame twenty years ago and e dey known for hits like Beautiful People, No Air, Under The Influence, Run It and Turn Up The Music.

E currently dey on tour and dey scheduled to play several UK shows for June and July.