Nottingham Forest announce Postecoglou as new coach afta sack of Nuno Espirito Santo

Read am in 3 mins

Dem don appoint Ange Postecoglou as head coach of Nottingham Forest to replace Nuno Espirito Santo wey dem sack.

Nuno leave im position for di City Ground late on Monday night afta 21 months in charge - and only three games into di season.

Postecoglou return to management three months afta Tottenham sack am following a poor Premier League season wen them finish 17th.

However, di 60-year-old Australian lead Spurs to a historic Europa League victory at di end of di season to end di club lack of trophy for a long.

Forest owner Evangelos Marinakis say: "We dey bring coach to di club wey don prove and consistent record of winning trophies.

"Im experience of coaching teams at di highest level, along wit im desire to build some tin special wit us for Forest, make am a fantastic pedin to help us on our journey and achieve consistently all our ambitions."

Forest dey 10th for Premier League table afta dia first three games dis season.

Afta 21 months in charge, Nuno last match na 3-0 loss against West Ham bifor September international break.

Di 51-year-old Portuguese coach take over Forest December 2023 afta Steve Cooper sack and e help keep dem for Premier League.

Last season, e carry dem finish 7th dia highest since 1994-95 and dem qualify for Europe for di first time in 30 years.

E dey possible say Postecoglou go get appointment before Forest play Arsenal on Saturday.

If e happun, e go be di 8th permanent manager since Evangelos Marinakis buy di club May 2017.

Postecoglou time for Spurs

Spurs lose 22 out of 38 league games last season, gada only 38 points and finish 17th dia worst Premier League record.

Dem concede 65 goals only Wolves and Leicester, Ipswich and Southampton (wey relegate) concede more.

But Postecoglou still give di club dia first major trophy in 17 years wit 1-0 win against Manchester United for Europa League final.

Di win secure Champions League football, but e no still save Postecoglou job dem sack am 16 days later.

Spurs appoint Thomas Frank as him replacement but still tok say Postecoglou go dey remembered for giving dem "one of di club's greatest moments" as only di third manager to win European trophy for Spurs.

For im first season, Tottenham finish 5th bifor e fulfil him promise bring trophy for second year.

Dem first hail am for di attacking style wey e bring, but later e face criticism say e no wan change style, plus e battle plenty injuries to key players.