Inec declare Charles Soludo winner of Anambra govnorship election 2025

Wia dis foto come from, Charles Soludo/Facebook
Di Independent National Electoral Commission, Inec, don declare incumbent Govnor, Charles Soludo di winner of di Saturday 8 November govnorship election.
Soludo, di candidate of di All Progressives Grand Alliance (APGA), secure 422,664 votes to beat im closest rival, di All Progressives Congress (APC) Nicholas Ukachukwu, wey poll 99,445 votes.
Paul Chukwuma of di Young Progressives Party (YPP) come third wit 37,753 votes, while John Nwosu of di African Democratic Congress (ADC) score 8,208 votes.
George Moghalu of di Labour Party (LP) and Jude Ezenwafor of di Peoples Democratic Party (PDP) score 10,576 votes and 1,401 votes, respectively.
'We dey turn on gear four beginning from March'
Im say dis na moment to say congratulations to idi Anambra sake of say four years ago dem bin tok, now dem don tok again.
Im add say di state bin experiment di use of Bvas for di last election and now dia voice loud well -well sake of say dem don make history for di state.
"Dis na di third term Anambra pipo dey re-elect a sitting govnor since di beginning of dis republic since 1999. E happun for 2010 wit about 31 percent of votes cast , 2017 wit 56 percent votes cast, and for 2025una re-elect me and my deputy wit 73 precent of di votes cast. I dey happy wit di emphatic statement say una dey stand wit us. "
Im promise di pipo of Anambra state say wit dis trust wey dem give am for dis partnership say dem neva see anytin yet.
"We dey turn onto gear four beginning from March" E thank President Bola Tinubu and di security pipo sake of say dem 'guarantee free and fair election".
E tell im supporters say dem go still meet to celebrate as dem dey bound by di Anambra spirit, im say im dy really for work wit all of dei 16 contestants for di good of Anambra state.
Soludo say im dey resume work sharp-sharp sake of say dis na assignment wey get deadline.
Govnor Soludo confam death of Apga Councillor
For im first speech afta Inec declare Govnor Charles Soludo as winner of di 2025 Govnorship election for Anambra state, im confam di death of one Councillor wey jaguda pipo kill during di election on Saturday.
Soludo tell tori pipo say di incident dey unfortunate sake of say jaguda pipo attack one of dia party member.
"Dis sad tori of some jaguda pipo wey go one community for di outskirt near di border wit Imo state.
Di former Central Bank of Nigeria Govnor allege say di jaguda pipo no come from Anambra state but from across di border wit neigbours Imo State.
"We understand say dem come from across di border and kill one of our supporters wey be Councillor wey bin just vote finish dey go im house, di jaguda pipo shoot am die, na Apga Councillor, e dey veri unfortunate, make im soul rest in peace" Soludo tok wit sad tone.
According to am, di election generally dey peaceful apart from di incident wey take pesin life.

Chukwuma Charles Soludo: Rise from CBN govnor to two-term govnor
Chukwuma Charles Soludo na di sixth democratically elected govnor of Anambra state. E just run and win a second term in office.
Govnor Soludo, stand as di sole candidate of APGA during di party primary as nobody challenge am.
Chukwuma Soludo na former economist and banker wey rise to become govnor of Nigeria Central Bank before e join politics. E bin also serve as di chairman board of directors of CBN.
Soludo serve as chief economic adviser to former President Olusegun Obasanjo for 2003 and also serve as member of di presidential economic advisory committee under former President Muhammadu Buhari. E serve as chief executive of di National Planning Commission of Nigeria.
Di govnor na professor of economics and school for top schools like University of Nigeria Nsukka, University of Cambridge, Brookings Institution, University of Warwick, and University of Oxford and serve as visiting professor Swarthmore College (USA).
Dem born di govnor for 1960. Im from Isuofia for Aguata Local Govment Area of di state. E dey married to Nonye Soludo and dem get six children.
For 2009, Soludo announce say e wan become govnor of Anambra State under di PDP. E take am about 12 years to see dat dream come true. E bin lose against former Govnor Peter Obi for di 2010 govnorship election. E resign from di PDP for 2013 and join APGA, but di APGA Screening Committee disqualify am from contesting dat year govnorship election.
E win di 2021 govnorship election for Anambra State under APGA and remain for di party since den. Im first tenure as govnor start for March 2022 as e replace former Govnor Willie Obiano.
Presently, im be di only govnor for Nigeria wey day elected under di APGA party.










