Tinubu land Anambra to commission di state first government house and oda projects

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria President Bola Tinubu don inaugurate di first Anambra State Government House, for di state capital, Awka.
Im also commission di Solution and Fun City and oda projects.
Bola Tinubu bin land for di Chinua Achebe Airport for Anambra state around afternoon on Thursday, wia Govnor Chukwuma Soludo welcome am.
For dis visit, Tinubu commission di first ever Government House for di state. For more dan 30 years, Anambra State no get official goment house.
Di Nigeria presido also commission oda projects for di state wey Govnor Soludo do.
For im speech, President Bola Tinubu say Anambra na di pride of Nigeria no be only di south - east.
"I don commission plenti landmark projects, di Solution Centre, di Anambra Tower of Light, di Heroes Salute Statues and unveiling of di 8-lane Emeka Anyaoku Boulevard.
President Bola Tinubu say of all, im government dey focus on di future generation wey be di children.
"Building critical infrastructure na di determination of dis government, we need to invest in our future, di future of our children and education na di greatest weapon against poverty.
"We must conquer out-of-school children, di children na our own, we must work for dia future" im conclude.

Wia dis foto come from, Presidency
For im speech, Govnor Charles Chukwuma Soludo address President Bola Tinubu wit im Igbo Chieftaincy title 'Omenife Awka' wey mean pesin wey dey work and e dey show!.
Im also acknowledge say na for 2005 wey be twenty years ago dem bin give President Bola Tinubu di title.
And na di traditional ruler of Awka bin honour am wit di title, but now, dem give am new title wey be 'Dike si mba' 1 of Anambra e mean ' wey mean strong man wey come from far place.
Afta Govnor Soludo hail President Bola Tinubu finish, im describe Anambra as di safest state for Nigeria in di last three months.
Di last time any president bin visit Anambra state na for 2012 and na to commission a Brewery and anoda enterprise.
Im say dem get plenti tins to commission like roads smarts schools and oda infrastructure but dis project wey President Bola Tinubu come to commission dey veri significant to dem.
"Di 8 lanes boulevard, di Tower of Light, and Monument of our Heroes na symbols of di audacity of our dreams for a new Anambra State."
Im add say Anambra State neva see anytin yet and im administration get agenda wit a deadline as division of Anambra State na to be di Silicone Valley and Dubai of Africa.
According to Govnor Soludo dem get a master plan of 50 years wey im and im team draft and dem dey ready to lay ogonge foundation for dia master plan sharp sharp.
"Anambra dey on di rise and we also dey hia to celebrate you, na why all di communities for Anambra give you Chieftaincy title"
Im add say beyond Anambra state, Nigeria go survive "For di sake of Nigeria and future generations, President Bola Ahmed Tinubu must survive and succeed and we dey prepared to support am in evri possible way to excel."
Im say di state dey support Tinubu and e dey rooted in dia history, on principle and idealogy
Anambra State na one of di south easten states for Nigeria and dem be one oif di opposition states under di All Progressives Grand Alliance.









