Bernardo Silva lone goal secure FA Cup final spot for Man City

Silva score for Man City

Wia dis foto come from, Getty Images

Chelsea don miss out of di FA Cup final afta losing to Man City wit an only goal from Bernardo Silva.

Despite say man City play game for Wednesday wey be say dem don taya wit injury knocking Erling Haaland out, dem still try to win against di Blues wey get about five days to travel and prepare ahead.

Nicholas Jackson be like di weapon wey no allow make Chelsea shine as im just dey lose plenti chances.

For di 68mins, Doku bin try some dramatic strike for Man City but Chelsea goalkeeper no gree.

Pressure dey Pep Guardiola head throughout di game as im begin dey waka up and down for di pitch.

Guardiola don earlier tok say im team still dey recover from di Champions League defeat against Real Madrid and di game against Chelsea go be a tough one.

Cole Palmer wey be regular goal scorer for Chelsea no too show for game today as goal no come from am.

Palmer bin try some chances too but e no dey enough to put im team ahead of Man City.

Man City no allow dia weak state draw dem back even as Haaland no dey game. From left and right, Phil Foden and Kelvin De Bruyne dey try penetrate into Chelsea box.

Na 84mins wey Silva bin receive ball, im fire shot wey hit Chelsea player enta di net.

Di keeper don follow di ball but as e touch Chelsea player, di ball change direction enta net.

As e be, Chelsea no fit prove demsef well even as dem no too dey beta position for di Premier league table.

Man City na di winner of last year FA Cup and dem don beat Chelsea to advance go di final stage.

Di final of di FA Cup go take place for Wembley on 25 May.

Di match as w happun

Man City 1-0 Chelsea

FULL-TIME

What a match!!!!!

97mins: Chelsea get chance to still level di score. Free kick for Chelsea.

93mins: Chelsea dey find equalizer wey go make dem enta extra time

92mins: Chelase dey try but e no reach oooooooooooooo

Man City 1-0 Chelsea

Silva play confam shot wey deflect meet Chelsea defender bifor e enta net

GOAAAAAAAAAAAAAAAAALLLLLLLL

81mins: See Alvarez bin play ball go up afta Akanji give am better pass. Ball wey e suppose prepare for confam shot on target.

80mins: Man City striker dey put pressure for Chelsea neck ooo. Dem dey press dem wella

78mins: oh, Palmer dey off. E for get chance control di ball enta net.

77mins: Guardiola dey fear ooooooooo. E no wan lose di match.

76mins: Man city goalkeeper dey weak oooooo. Im don dey ground dey expect medical team as Chelsea dem ready for corner.

Silva score

Wia dis foto come from, Getty Images

75mins: Corner for Chelsea. Pressure dey Guardiola head.

74mins: Free kick for Man City. Chelsea goalkeeper catch di ball from up...

72mins: Gusto dey out as di match kontinu

71mins: Gusto is down. Di medical team dey attend to am at di moment.

69mins: De Bruyne bin try wide shot but e no enta. man City player dey play for Chelsea post well well oooo

68mins: What a shot from Doku but di goalkeeper block am.

67mins: Caicedo miss a very great opportunity as im play di ball go wide for front of goalpost.

66mins: Akanji no fit control di long pass wey dem give am

Man City 0-0 Chelsea

62mins: Rodrigo dey try very good pass but nothing don show. Jackson don touch more ball for im opponent side pass any oda player.

60mins: Oooooooooooooooooooo. Jackson run enta box 18 ooooo and e fall. Referee say no penalty.

59mins: What a shot!!!! But Chelsea defender Chalobah block am go corner.

57mins: See as Man City almost make mistake for dia post.

55mins: Referee say no penalty and no corner afta di ball touch Man City defender hand.

Palmer take correct free kick. Dem dey complain of di handball foul oooo

54mins: Free Kick for Chelsea. Beautiful skills by Madueke make Man City player foul am.

52mins: oh noooooo. That was almost a goal for Man City.

48mins: How dis Jackson dey keep on missing goal. How? Im miss anoda beautiful header again.

46mins: Man City goalkeeper dey make some kain mistake but Chelsea player neva fit convert am to goal.

SECOND HALF START

Jackson miss goal

Wia dis foto come from, Getty Images

Man City 0-0 Chelsea

HALF TIME.

45+2mins: Chelsea pressure no reach oooo

2mins ADDED TIME

45mins: Yellow card for Caicedo

FREE Kick: Foden still waste am oooo

42mins: Haaaaa!!! Dem don almost break Phil Foden leg ooooo. Na free kick for Man City

40mins: Madueke try put ball for di head of im fellow players but Man City defenders clear am out.

38mins: Rodri dey try put ball in between di players but Chelsea goalkeper dey save some ball too.

36mins: Palmerrrrrrrrrrrrrrrrrrrr. Oh Di goalkeeper block Cole Palmer shot as e no strong reach. E for put Chelsea for early lead.

36mins: Pep Guardiola dey look im team as dem dey play like tayad pipo....

34mins: See ball wey Chelsea lose again ooooooooooo. Habaaaaa

32mins: Thaigo Silva try cross di ball forward but na ova di bar go goalkick im put am.

Man City 0-0 Chelsea

30mins: Afta Jackson lose di ball, di pressure dey hot oooooo. Jackson lost one on one

28mins: Haaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaa Jackson lose di goal ooooooooooooooooooooooo

26mins: Almost a Goalll for Man City but Chelsea defenders clear di ball from di net.

25mins: Free kick for Man City. Jackson clear am go corner to save Chelsea from early goal.

24mins: Man City on the run.... But Chelsea no gree. Man City team dey play like pipo wey don taya

22mins: Man City neva get any shot yet but dem dey try put pressure.

20mins: Chelsea dey play for dia own goalpost but be like say dia confidence dey high.

19mins: OFFSIDE oooooo. De Bruyne and Alvarez go stay for off position.

18mins: Kevin de Bruyne dey dive into different tackles but no goals don show yet.

15mins: Chelsea striker Nicolas Jackson fall down from foul wey Kevin de Bruyne do and referee blow

13mins: oh noooooooooooooooooooooo. See pass wey Man City go miss. Foden no fit convert into goal. Na Cucurella save di ball comot for Chelsea post

12mins: Chelsea get chance ooooooo as Gusto give correct ball control. na corner e go.

10mins: Palmer fire shot go post ooooo but Man city goalkeeper stop am

9mins: Corner for Man City but dem waste am.

7mins: Di corner go ova di players. Corner for Chelsea. Man City dey set dia box well.

6mins: Chelsea neva fit convert di counter attack wey dem get.

4mins: Be like say Chelsea dey put pressure too ooooooooooooo

3mins- Silva dey put pressure for Chelsea box oooo. So far game still dey go well wit no plenti pressure.

1mins: Man City dey make dia way into Chelsea box.

0mins- Match don start

Manchester City vs Chelsea

Chelsea go face Man City

Wia dis foto come from, Getty Images

Lineup

Chelsea: Petrovic; Gusto, Chalobah, Thiago Silva, Cucurella; Caicedo, Enzo; Madueke, Gallagher (c), Jackson; Palmer

Chelsea substitutes: Bettinelli, Disasi, Badiashile, Gilchrist, Chilwell, Chukwuemeka, Sterling, Mudryk, Deivid Washington

Man City: Ortega; Walker (c), Stones, Akanji, Ake; Rodri; Foden, De Bruyne, Silva, Grealish; Alvarez

Man City substitutes: Ederson, Dias, Gvardiol, Gomez, Lewis, Bobb, Kovacic, Nunes, Doku

Man City vs Chelsea team news

Chelsea don win FA Cup eight times

Wia dis foto come from, Getty Images

Chelsea

Na since 1915 Chelsea bin become di first Football League from London to reach di FA Cup final. E don reach plenti years later, and na still Chelsea be di last hope to bring di cup back to London again.

Chelsea coach Mauricio Pochettino go want make im side beat di current title holders.

Chelsea even get five days to prepare for dis fixture but Man City bin play 120 minutes against Real madrid for di Champions League quarter-finals on Wednesday evening.

Na through penalties Man City bin take lose comot for di game afta Antonio Rudiger bin score di decisive spot kick for Etihad Stadium.

Pep Guardiola and im side neva progress from four of dia previous six FA Cup semi-finals.

For 2021, Man city bin lose to Chelsea for di FA Cup semi-finals including losing to oda London clubs.

Chelsea wey be say na 2018 dem lift dia 8th FA Cup go wan try to reach anoda final.

Cole Palmer na one Chelsea player wey dey use goals do wonder for di club. Im don score eleven goals for im previous six matches, including one against Leicester for di FA Cup quarter-finals.

Man City

Afta Man City bin face Real Madrid for Etihad stadium on Wednesday night, eight of dia players don play pass 3,000 minutes for all competitons dis season but na only four Chelsea players don reach dat number.

Guardiola tok say Erling Haaland, Kevin De Bruyne and Manuel Akanji bin ask make dem comot for dia last game but di coach no comot dem.

Wetin Guardiola dey do pass na to use attacking style by switching im key players wey go fit create some chances. Phil Foden na one correct player wey dey create chances and dey score well well.

Most FA Cup wins

14 - Arsenal

12 - Manchester Utd

8 - Chelsea, Liverpool, Tottenham

7 - Aston Villa, Manchester City