'Fish di criminals out' - Tinubu order service chiefs, IGP as e visit victims of Benue killings

Wia dis foto come from, Presidency
Nigeria President Bola Tinubu don land Makurdi di Benue state capital, north-central Nigeria.
Di Nigeria leader showface to condole wit pipo of di state afta one deadly attack wey lead to di death of ova 100 pipo for Yelwata community for Guma Local Goment Area of di state.
As oga Bola Tinubu land, e waka go hospital wia e visit some of di victims wey dey hospital.
Di visit dey come for di middle of growing concerns as Nigerians dey worry say security for di region dey worse everyday.
Oga Tinubu for statement on Monday, 16 June confam say im go "clear im schedule and visit Benue state as part of renewed efforts to foster peace and address di persistent conflict affecting communities for di state."
Di Benue State govment say di "visit no only represent a moment of national empathy, but na rare opportunity to directly follow di presidency tok on urgent security interventions dem need to end di persistent killings and displacement of our pipo".
Di Benue State goment bin also declare public holiday for di state to welcome oga Tinubu.
'Fish di criminals out' - Tinubu
For im visit to Benue state, oga Bola Tinubu afta e call for a moment of silence for di victims wey no survive, thank all di security pipo.
President Tinubu add say, "No be evribody go like you for politics, dem hate me like hell too. But I dey hia, I be di president"
For di stakeholders meeting for Govment House, Makurdi, Oga Tinubu cut warning for di Service Chiefs and di Inspector General of Police to fish di criminals out.
"Police I hope say your men dey at alert to listen to information."
E tell di chief of Defence staff say, "you don put in much. I watch your comments, you no go tire to stay inside bush.
Oloyede and di Air Marshall, we thank all of una, but we need to keep our ears for ground make we catch dis criminals, make we get dem out. DG NIA, DG SSS, retool your information channels make we get beta intelligence so dat dis tin no go happun again."
Benue State Govnor, Hyacinth Alia come beg federal goment to establish state police and intervention fund.
Govnor Alia say if dem create state police, even though e get e own challenges e go help to reduce dis violence.
Fotos from di visit

Wia dis foto come from, Presidency

Wia dis foto come from, Presidency

Wia dis foto come from, Presidency

Wia dis foto come from, Senator George Akume/X
Afta di midnight and early morning attacks on Saturday, 14 June, wia suspected criminal herdsmen according to di state Govnor Hyacinth Alia bin attack di community, wey lead to di death of more dan 100 pipo die, Nigerians from across di world begin raise alarm.
Di National Emergency Management Agency (Nema) bin tok say dia early investigation show say more dan 100 pipo kpai for di attack including two sojas and one officer of di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC).
Di number of pipo wey die fit still go up as di agency say di current figures still dey inconsistent sake of di volatile security situation and limited access to di affected areas.
To prepare for dis visit, President Tinubu bin don already send di Secretary to di Government of di Federation, di Inspector General of Police, heads of intelligence agencies, di National Security Adviser, plus di Chairmen of di Senate and House Defence Committees go Benue State.
SGF, Security Chiefs dey Benue to end killings

Wia dis foto come from, Fr. Hyacinth Iormem Alia/X
Ahead of di president visit, di Secretary to di Government of di Federation George Akume wey come from Benue land di state on Tuesday, 17 June.
E say im visit di sites of di attacks, meet wit survivors who express dia pains." Di pain dey raw, di sorrow dey deep," Di SGF tok.
"For di Market IDP camp, I meet families wey still dey suffer from di loss — displaced, grieving, and living in difficult conditions. Dia resilience moveme deeply. Dis crisis done go on for too long. No one deserve to live in fear or uncertainty for dia own homeland. Dis really hurt". Oga Akume add.
Di SGF assure say im no go abandon im own. "I go stand wit you- and we no go rest till our communities dey secure & peace return to our lands," e add.
Also, di Inspector General of Police Kayode Egbetokun and di Chief of Defence Staff Christopher Musa bin rush go Yelewata community on Monday to see tins for diasef.
Di IGP describe di attack as "senseless and an act of terrorism", and e promise say di Nigeria Police Force do dia best to bring di attackers to justice.
Also, di CDS assure di pipo say dis go be di last attack wey go happen for dia community.
"We want make dis one be di last one wey go happen. We go go all out to ensure say we address am. We don put measures for oda places and e bin work, so here no go dey different," e tok.
"I wan assure Nigerians say no be only Benue State, all ova di kontri, we dey determined, based on di mandate of Mr President, to make sure say we restore peace and tranquillity inside our country, but we need Nigerians to support us."
We no get hand for Yelwata killings - Nigerian Army
Nigerian Defence Headquarters don come out deny tori wey dey fly say na dem or some pipo inside army cause di wahala wey happun for Yelwata, Benue State.
For one press statement wey Brigadier General Tukur Gusau sign, wey be Director of Defence Information, di army tok say di accusation no get head or tail and no get any correct evidence to back am.
Dem tok say di Nigerian military dey always stand to protect civilians and follow law.
Chief of Defence Staff, General Christopher Gwabin Musa, still tok say army no get hand for di killings and e call for better way to solve di real wahala wey dey cause fight for dat area.
"Notin dey show say na sabotage from inside army cause wetin happun for Yelwata" di statement tok.
Dem still add say even human rights pipo wey do dia own investigation no see any link between army and di pipo wey do di killings.
Di army tok say wetin happun for Yelwata na part of di big wahala wey dey happen, wia farmers and herders dey always fight sake of land, grazing space, and oda wahala.
"To tok say na army cause di Yelwata massacre go just shift attention from di real matter" dem tok.
Dem beg communities make dem join hand wit security pipo to find peace and stop to hide criminals.
Di army still assure say dem go kontinu to protect pipo wey dey obey law and dem ready to work wit evribodi to bring peace.










