Afcon 2025: Nigeria vs Tanzania match end wit Super Eagles 2-1 win

Wia dis foto come from, Visionhaus/Getty Images)MB Media/Getty Images)
Nigeria record dia first win of di 2025 Africa Cup of Nations wit a 2-1 win ova Tanzania.
Goals from Semiu Ajayi and Ademola Lookman help Nigeria begin di tournament wit a win. Mombwa bin equalise for Tanzania but di Super Eagles soar past di Taifa Stars.
Nigeria Super Eagles and Tanzania clash for di 2025 Africa Cup of Nations Group C match on Tuesday 23 December 2025 for Complexe Sportif de Fès for Morocco.
For di 35th minutes, Victor Osimhen dribble di goalkeeper but im shot dey cleared off di line.
Shortly afta, Ajayi open di scoring for Nigeria afta e rise high to head Alex Iwobi cross into di net.
For di 50th minutes, Tanzania bin equalise afta M'Mombwa capitalise on Nigeria defence wey dey sleep and slide in di ball past Stanley Nwabali.
M'Mombwa break Nigeria offside trap to tap home di equaliser to di shock of di Super Eagles and dem level di goals.
Two minutes later, Ademola Lookman wonderful strike from outside di box see Nigeria retake di lead which dem hold onto to win dia opening match of Afcon 2025.
Same Lookman chop yellow card for di 57th minutes and dat na di first one for di game, afta di strike mistakenly stand on di leg of Tanzania midfielder.
Dis na Nigeria 21st Afcon and di Super Eagles dey hope to win am for di fourth time afta dem finish second last edition for Ivory Coast.
For Tanzania, na dia fourth time to come Afcon and dem bin lose all dia opening matches.
Nigeria neva lose any of dia opening matches for di last three tournaments.
Head to Head
Nigeria and Tanzania don meet seven times for all competitions. Di Super Eagles neva lose any match against Tanzania.
Out of di seven matches, Nigeria win four matches and dem draw three.
Dem meet for di 2017 Africa Cup of Nations and dem bin play goalless draw for Dar es Salaam, Ethiopia.
Nigeria and Tanzania dey meet for di second time afta 45 years wey dem first meet for di Africa Cup of Nations tournament.
Na for di 1980 finals, wey Nigeria bin host, na im dem face Tanzania for dia opening game.
Di Super Eagles bin beat di Taifa Stars 3–1 for Lagos on 8 March 1980, na for dis tournament Nigeria also win dia first continental title.
Wetin di coaches tok
Nigeria Head Coach, Eric Chelle tok say dis match against Tanzania dey important well-well and na big game for di team.
"Di first game dey always dey important evritime, we wan win dis game and I dey focused on dis game, my players and officials now."
Head Coach of Tanzania, Miguel Gamondi tell tori pipo say wetin hapun in di past no go fit determine wetin go hapun in future.
"Na our dream, and nobodi go fit stop us from believing and dreaming, If you no get dream, e no make sense to sleep too much."
Mr Gamondi say e respect Nigeria well-well, "but for football anytin dey possible and we dey here to make good performance".









