Mali vs Zambia Afcon 2025 match end for draw afta Patson Daka late equaliser

Nene Dorgeles of Mali wear dia national jersey wey be green, yellow and red designs wit number 27 for im shorts wey be yellow. Patson Daka wia Zambia national jersey wey be orange colour and black short wit di number 20

Wia dis foto come from, Ulrik Pedersen/DeFodi Images via Getty Images/MB Media/Getty Images

Wetin we call dis foto, Nene Dorgeles of Mali/Patson Daka of Zambia
Read am in 7 mins

Patson Daka of Zambia score goal for added time to draw 1-1 wit Mali.

Mali score first for di 61st minute wen Sinayoko first shoot inside di Zambian net.

Zambia bin dey struggle most of di time but dem later wake up to worry di Malian defence.

So far, Morocco dey lead Group A wit three points while Mali and Zambia share points.

Comoros get zero points afta dem lose to hosts Morocco.

Second Half

Full -Time Mali 1-1 Zambia

90+5 Referee blow whistle, match don end

90+5 Sinayoko of Mali get chance to scor , e beat oda Zambia defenders but anoda defender clear di ball.

90+2 Mali 1-1 Zambia

90+2 Mattheus Banda give Patson Dakar di cross, Patson hed di ball straight inside di net.

90+2 GOALLLLLL! for Zambia

90' Referee add 4 minutes

90' Na few minutes remain as Mali dey put pressure, Zambian defence dey block am.

88' Sinayoko of Mali get clear chance wit no Zambia defender for di back but one Zambia player rush fast to meet an to clear di threat.

86' Doumbia comot and Haidara replace am

Substitution for Mali

85' Miss! Sinayoko of Mali fire shot wey just cross over di face of di net small wen Zamian defence bin ey sleep.

84'Zambia player challenge Malian playere Dante, referee blow foul.

81'Zambia dey try to hold possession of di ball but Mali dey hustle ball like say dem neva score.

78' Substitution for Zambia, Mousounda don enta, Sakala don comot.

76' Mouhammadou Dumbia don enta as D.Nene comot.

76' Diarra enta, e replace Toure

76' Double substitution for Mali

73' Zambia get chance to score, Chand fire di shot but Mali goalkeeper catch di ball wey almost enta net.

71' Mali play di corner kick but Nwanza catch di ball withoput stress.

70' Mali fire shoot but Zambia goalkeeper Nwanza punch am go corner, corner-kick for Mali.

69' Yellow card for Simukonda of Zambia.

67' Lamine Banda don comot, Joseph Sabobo Banda don enta.

Substituition for Zambia

64' Mali go again almost immediately to score but Zambia defenders bring di player down, Referee say no foul and no penalty.

Mali 1-0 Zambia

62' Sinayoko of Mali fire di ball straight inside net afta di ball bounce back from di shot wey anoda player bin shoot.

61' GOOALLLL!

60' Mali dey try to hold onto di ball, Zambia player follow di ball but Coulibaly of Mali dey complain say referee suppose blow foul against Zambia but linesman already raise off-side flag.

58' Zambia corner kick cross over di goal post and dem miss di chance. Zambia get freekick afta Mali player Diarra cause kasala for goal area.

55' No goal from di two teams for dis second half yet,. to two side dey face each poda and no one wan gree for di oda to score.

53' Zambia tiff di ball from Mali as de run around di flanks but di pass to long , di ball gomout of play.

50' Mali dey play short-short passes now as dem manage break into Zambia goal area but Zambia defenders tackle di player to stop di goal. move.

48' Mali dey try use di flanks and sidelines but Zambia dey follow dem anywia dem face.

47' Zambia player Chiawa tackle im Malian opponrnt Coulibaly wey bin dey for ground but im don stand up now.

46' Zambia start wit hot strike but Mali goalkeeper catch di ball witout stress.

45' Second half don start

First Half

Mali 0-0 Zambia

45+6' Referee don blow whistle First Half don end.

45+ 6' Mali plai dia freekick but Zambia defence clear am.

45+4' Zambia and Mali players just dey pass ball upandan, freekick for Mali afta small foul.

45+2 Zambian player dey for ground dey receive treatment afta head-on collision for goal area.

45' Referee add 3 minutes.

45' Zambia defence clear di freekick notin come out.

45' Freekick for Mali afta Zambia player tackle am fall for ground.

43' Dis na di second penalty of di tournament and di goalkeepers save di two.

42' SAVE!!!!! Zambia goalkeeper Nwanza save di penalty wey Mali player El Bilal play.

40' PENALTY FOR MALI afta VAR review

38' VAR dey check for possible penalty against Zambia

37' CHANCE !!! Mali get chance to score , Mattheus Banda clear di ball but e go meet and Mali player wey fire shot but Zambia goalkeeper catch am.

36' Zambia get freekick but dem play am as ordinary pass.

34' Zambia dey disturb Mali wit dia strength and long pace, Mali attempt to score but di shot too weak.

32' E be like say di two teams dey avoid any midfield battle as dem di play long long cross but di defenders na im dey work pass.

30 Malian player enta Zambia goal area, two Zambia defenders block di ball as anoda Zambia player tiff di ball from Mali leg.

29' Di match don dey pick momentum since Zambia wake up and start to disturb di Malian defence.

27' Zambia get chance to score but Mali player head di ball to corner kick area but notin come out.

26' Zambia don up dia game in dimlast few minutes but Mali still get di most of ball possession. Mali get 109 while Zambia 89.

25' Zambia player carry di ball run enta Mali goal area, e fire shot but Mali goalkeeper catch di ball.

23' Lamick Banda of Zambia and Dante of Mali bin jam each oda but no serious mata, game dey go on.

22' Mali dey play long- long passes to boycott di midfield sake of Zambia but Zambia no dey gree too.

20' Mali get freekick but Zambian player Chaiwa raise hand say e no do anytin.

18' Zambia dey try hold di ball for long but Mali no dey allow dem.

15' Corner kick for Mali but notin come out.

13' Mali don get more chances for set pieces pass Zambia

10' Mali and Zambia dey drag ball for di midfield.

4' Mali and Zambia hustle for di ball

1'Referee don low and match son start

Line -up

Mali starting 11: Diarra, Dante, Diaby, Nene, El Bilal, Fofana, Sinayoko, Doumbia, Sangare, Dieng, Coulibaly.

Zambia starting 11: Mwanza, M. Banda, Chaiwa, Sakala, Musonda, L. Banda, Fashion Jr, Kangwa, Daka, Chanda, Tembo

Di Eagles of Mali and di Chipolopolo of Zambia na two kontris wey sabi play football for di continent well-well rich.

Dis match go dey entertaining and tough sake of say di two kontris no go wan lose dia opening games.

Mali wey get plenti ogbonge players dey hope break di barrier break for Afcon.

Dem bin finish as runners-up for 1972 and dem bin don reach semi-finals plenti times.

Mali dey tactically disciplined, dem get beta midfield and dem sabi play as a team.

For di Chipolopolo of Zambia, dem bi household name too and dem ready to shake Mali.

Zambia get speed, physical strength, dem sabi move sharp -sharp from defence to attack.

Wetin di coaches tok

Mali coach Tom Saintfiet for di pre-match press conference tok say "Our first task na against Zambia, wey dey considered as one of di best teams for Africa. Wetin mata to us na di three points. We must respect all our opponents and stay focused throughout di match.".

Im add say "We get good team, and I no get any problem wit di pressure. Since I land for here, we don achieve our best statistical performance wit Mali."

Zambia coach Musa Sichone get hope "We dey aim good start for di tournament. All players dey well-prepared, fit, and ready to play. We go take am step by step. I get di honor to participate for di Africa Cup of Nations as both player and coach, and for me, participate for dis tournament na about achieving results, no be just to play."