Olympic champion Faith Kipyegon fail to make history as first woman to run one mile under four minutes

Faith Kipyegon wave after her attempt

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Faith Kipyegon don win seven gold medals for global championships
Read am in 5 mins

Faith Kipyegon no make am for her goal to become di first woman in history to run sub-four-minute mile.

Di Kenyan, 31, clock four minutes 06.42 seconds in perfect conditions for Stade Charlety in Paris - time wey dey 1.22 seconds faster dan her world record.

Di time no go dey recognised as official record because Kipyegon get help from a team of male and female pacemakers and wear technologically advanced kit and shoes for di Nike-sponsored 'Breaking4' event.

Kipyegon official women mile record of 4:07.64, wey she set for July 2023, remain almost five seconds faster dan any wey oda female athlete in history don run for dat distance.

Na dat record performance for Monaco wey make Kipyegon believe say di sub-four - wey bin once dey considered say e dey physiologically impossible for woman - say na sometin she fit reach.

But di three-time Olympic 1500m champion still get big gap to bridge, as she bin dey required to run two seconds per lap faster dan she don ever do before.

Kipyegon bin kit up in one aerodynamic skinsuit and specially designed spikes as she target di sub-60 second laps - wey be average speed of about 15 miles or 24 kilometres, per hour.

She get help from 13 pacemakers, including Britain Olympic 1500m bronze medallist Georgia Hunter Bell and Jemma Reekie.

Kipyegon complete di third lap in 3:01.84, but her hopes of achieving di target gradually fade for di final 400m.

She still run through di finish tape in di fastest time in history by a woman before she collapse to di ground.

Na her friend and training partner Eliud Kipchoge wey for 2019 become di first pesin to run marathon under two hours, bin hold di tape.

Faith Kipyegon, wear black skinsuit dey run

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Faith Kipyegon run pass her own world record time but she no fit make di under four minutes

"I don prove say e dey possible, na only a matter of time. If e no be me, e go be somebody else," Kipyegon tok.

"I no go lose hope, I go still go for am. I hope say I go get am one day."

Sending a message to her daughter and young girls watching di record attempt, she say: "I go tell dem say we no dey limited. We fit limit ourselves with thoughts, but e dey possible to try everything and prove to di world say we dey strong. Keep pushing."

Wetin be sub-four minute mile?

Di sub-four minute mile na to run a mile under four minutes. A mile na 1609 meters, wey dey more dan four full laps around a 400-meter track. Faith go need to run approximately 2 seconds faster per lap to break di 4-minute record.

Roger Bannister na di first pesin to break di four minute barrier for May 1954.

Since dat time, na ova 2,000 pipo don attempt am - but all of dem na men.

To fit able to run a sub-four mile, di athlete go need to dey capable of running di 800m.

Wen Kipyegon run for dis attempt, she get a team of pacers wey surround her to block out di wind and make her run faster.

Meanwhile, previously one woman Diane Leather become di first woman to run sub-five minutes for 1954.

Also, for October 2019, Kipyegon fellow Kenyan Eliud Kipchoge become di first person to run a marathon in under two hours, but e no dey recognised as di official marathon world record becos e no be open competition.

Faith Kipyegon afta running, she hold Kenya flag

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Faith Kipyegon set Olympic record for Tokyo as she defend 1500m title

Kipyegon na middle-distance runner and she become di first woman to win 1500m gold for three successive Olympics wit her success for Paris last year.

She also get three World 1500m titles and win 5,000m gold for di 2023 World Championships.

Five of di gold medals wey she don win na afta she bin give birth to her daughter Alyn for 2018.

Faith Kipyegon set 1500m title Olympic record for Tokyo afta she first win am for Rio de Janeiro for 2016.

Di Kenyan dedicate some of her win to her three-year-old daughter, wey she credit wit giving her extra motivation afta she take 21-month break from sport.

Her dedication dey more significant to her as she bin di only di third athlete to retain her Olympic title afta she born between Games (along wit Australia Shirley Strickland, for 1956, and Cameroon Francoise Mbango, for 2008).

Kipyegon bin don set world-leading time of 3:51.07 bifor, wey be di fourth fastest time in history.

She get Olympic record, and also di world record.

Faith Kipyegon showing her emotion wit her mouth open and hand wide apart

Wia dis foto come from, Getty Images

Long before she chase dis history wit Nike latest high-technology shoes, Kipyegon bin run barefoot to and from school for her village for Kenya.

On Thursday evening, Kipyegon wear a black aerodynamic skinsuit wey get 'aeronodes' - strategically placed 3D-printed bumps - along wit arm and leg sleeves and a headband, each wey dey designed to reduce wind resistance and drag.

Her shoes, based on di Nike Victory 2 spikes wey she take win Olympic gold last summer, weigh just 85 grams, with carbon fibre plate on di sole and air pockets for di forefoot wey give am more propulsion.

Kipyegon now after years of small-small progress by women don smash Sifan Hassan 2019 world record of 4:12.33 to bring di goal wey be one pipo bin no reason before closer to reality.